MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Sunday 7 February 2016

HOT RICE! BLACKFACE DON FINISH 2FACE AND EFE AGAIN DIS SUNDAY FOR TWITA


Ol boy,wen dis beef won finish bitwin dis two best frends turn enimis?
For sometime now Blackface don dey accuse 2face of kidnaping een songs.
Di latest one now na di song, 'Let somebody love you' wey 2face reliz last year.
Blackface say naim write di song and wetin pain am na bikos 2face nor givam beta shout out for writing di song.
Yes,2baba manager,Efe,confamam say Blackface write for di song but nor be him write evritin.
Nor be dia Efe end am o,as he also blast Blackface.
Trust Blackface,he don reply dem and kon folow am up wit anoda blasting today.
Di bobo write for twita say,dia Sunday rice don readi and anybodi wey neva lem,make he join dem.
He say he for put di rice pishor for twita but di kain industri wey we dey,dem fit tiff di rice just like dem dey tiff him miuzik.
Na wa.
Wahala na noun,kpalava na pronoun.
Make I sidon dey watch.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...