MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Thursday 4 February 2016

BREAD SCARCITY DON HIT KANO BICOS BAKERS DON STRIKE AS TEA AND BREAD SELLERS DEY PARA


About 8,000 bakers don klose dia shops for Kano state as dem don start strike bikos of high cost of flour for di state.
Akordin to di P.r.o of mastas bakers association for di state,Mallam Kabiru Hassan,he say dem nor fit bieram again as dem don put money on top flour and oda tins wey dem take dey produce bread.
Dis scarcity don turn Kano upside down as na one kain wack 'Gurasa', pipo for area dey blast now.
Even malams wey dey sell tea,di tin dey touch dem as dem dey konplain badli.
Mallam Sanusi Hamisu wey dey sell bread and tea for di popular Ahmadu Bello way,say na die dem dey and he biliv say na plan work to take sofa di comon man.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...