MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Tuesday 2 February 2016

KIM KARDASHIAN AND AND AMBER ROSE DON SETTLE KANYE WEST AND WIZ KHALIFA THRU SELFIE

Nor be dis two hot oyoyo babes cause Kanye West and Wiz Khalifa quarel for twita but di two of dem don finali setle di two crazemen fight.
Kanye West say di title of een new album na 'Waves' but Wiz Khalifa say dat na wrong move as waves na Max B name.
Nor be small quarel as Kanye vex insult Khalifa welwell and even insult een forma wife Amber Rose and dia two years old pikin.
Amber Rose kpakpa,na Kanye West forma babe bifor he kon marry Kim Kardashian.
Now di two babes don take one strong selfie and postam just to setle di gbege.
Even Kanye West yarn afta di selfie say he don setle wit Khalifa but Khalifa stil dey form bado as he neva yarn anytin about di setlement.
I nor blame dem.
If dem get moskito problem,Nepa problem like us for hia,dem nor go quarel ova nonsense.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...