MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Thursday 18 February 2016

ONYEKA ONWENU DON CRY OUT SAY,DEM SACKAM AS DI OGAKPATAKPATA OF CENTRE FOR WOMEN DEVELOPMENT,BICOS SHE BE IGBO


Expirience singa and supastar,Onyeka Onwenu,don dey cry like omormor about di way wey dem take sackam from office.
Na she be di ogakpatakpata of di national Centre for women development and na last week dem telam say di one wey she work don do.
Di gofment of forma presido,Goodluck Jonathan naim give Onyeka Onwenu di position for Septemba,2013.
Di elegant stallion,di nickname wey dem give her,say she serve for two years and five months as di DG of dat office.
She yarn many tins of how she take do beta work all dis years and why she fil say dem comot di job for her hand.
Of all wetin she yarn,di one wey draw my attention na wen she say na bicos she be Igbo woman naim make dem pinch di job take fromam.
But my own be say,wot of oda pipo wey dem dey sack from office bifor dem born us?
Na dis same exkiuz all of dem get?
Anyway I just say make I clear una wetin she yarn sha.
Onto di next tori.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...