MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Tuesday 2 February 2016

PAUL OKOYE OF PSQUARE DON REPLY BLACKFACE SAY NOR BE HIM BE DI FIRST PESIN TO INSULT DEM SAY DEM BE COPY COPY MIUZISHANS

Afta all di beef wey don dey appun bitwin our celibritis dis year, I hope say di tin go calm down small.
Rememba say Blackface don accuse 2face and Wizkid of tiffing een songs and Dammy Krane sef accuse Wizkid of tiffing een song too.
One pesin wey nor hapi for all dis tins na Paul of Psquare as he say na chip populariti pipo like Blackface and Dammy Krane dey look for.

Blackface nor waste time to yab Paul as he yarnam say na dem be king of copy copy for naija.
Inshot he say na dem be di Milli Vanilli of Naija.
Paul don reply di forma plantation bois memba say nor be today pipo don dey call dem copy copy and he say in di first place,he nor menshon anybodi name bifor Blackface kon dey call he name.
So if Blackface call dem copy copy nor be new tin.
Paul yarn all dis one wen he follow Hip tv do small amebor.
He say nor be beta tin for anybodi to dey giv dem bad name bikos dem dey work hard for demsef and e nor see any rizin why anybodi go dey yarn labalaba.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...