MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Friday 19 February 2016

MAJEK POSE WITH HIM FAMILY MEMBAS AFTA DI RAIN MAKER BOUNCE BACK TO LIFE


Na wa for dis life sef!
Majek Fashek relations don rememba to findam and snap pishor witam afta dem cure ram from di skor skor wey him battle wit and win.
Majek bin dey go from place to place dey shack goskorin,dey do funny tins wey dey close to madman bifor bizness man,Ayiri,pickam go Abuja go treat.
Since then Majek don dey full of life.
He don dey even go shows go paform again.
Now some of di family membas wey nor fit findam see wen he dey roam for street dey shack ogogoro,don findam see now wey he don well.
Na so life be o.
Dis na lesson for evribodi.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...