MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Friday 19 February 2016

DAVIDO SAY HIM PAPA ARRESTAM FOR 2011 AFTA TOO MUCH GROOVE TURNAM TO OLODO


Davido don yarn Faders magazine for Yankee say een papa arrestam for 2011 bicos he dey live waywod life.
He say e get one time for skul him nor kon know book.een kon turn beta olodo.
Even to read book kon tire ram.
Him vex enta yankee and na so so groove him dey groove.
From club to club na so di bobo dey drink beer full face.
He dey carry women and do all di tins wey dey turn guy men head upside down wen dem don shack.
Even di book wey een papa sendam go len for yonda one time like dat,groove nor griam len.
So as he enta naija back witout no degree for di bizness management wey een papa say make e read for Yankee,na so police pickam up for airport.
Afta all dis kasala,Davido kon sign agriment wit een papa say him go go back to school.
Anyhow anyhow,di bobo still manage graduate from Babcock univasiti last year.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...