MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Wednesday 10 February 2016

GOOD HEART: SEE DI DWARF WEY EMMANUEL ADEBAYOR PICK FROM STREET AND GIVE BETA LIFE


Forma Arsenal playa and Togo strika,Emmanuel Adebayor,don post di pichors of him dwarf frend wey dey stay witam for  Instagram and he say di bobo naim backbone.
Di bobo,Pako,dey very grateful to Adebayor as he pickam from strit,pickam from sofa and putam for haus.
Adebayor say true true he pick di bobo from strit,carry am go haus,buyam clothes and putam for school.
He say anytime wen he dey down,Pako dey always givam beta advice wey dey make hin mind kooleh.
Di Togo strika say een too like di guy.

Adebayor don dey witout club for ova six months since him forma club Tottenham Hotspurs nor gree renew him kontract.
Two weeks ago Crystal Palace signam and he dedicate hin first jersey wey dem givam for him new club to Pako.
Baba God locate our helpa (Amen).

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...