MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Friday 12 February 2016

DAVIDO DON YARN SAY,NA TO STUBBORN NAIM SURE PASS IF U WON SUCEED FOR LIFE AS NA STOBORNESS CARRY AM REACH WIA HIM DEY SO


I dey always tell pipo say,e easy for stubborn pipo to make am quick pass legbere.
Bicos if u stoborn for di hussling wey dey giv u toff time,e beta pass who dey form suegbe for di toff times.
Akordin to David Adeleke wey u know as Davido,di bobo say na stuborness naim make am succeed for di hussling.
He yarn dis one on top twita.
Some pipo go say maybe na hardwork he sopose say naim carry am rish were him dey so nor be stobborness.
I agree wit Davido bicos he get some hardwork wey dey com wit stoborness.
If u stoborn for di hardwork base on say u don tire for stori,e go pay u quick pass sidon look.
For example,if u say today na today,u won enta street go find work,small level of stuborness dey dat kain yarns.
Anyhow u lookam,sometimes e gud say if dem say yes! u go say no and if dem say no! u go say yes.
Sofa u dey sure say wetin u biliv naim be di trut wey u go take get di beta result wey u need to take progress.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...