MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Monday 31 August 2015

UKWU TO LARGE! 50 CENT BABE IKEBE,NOR BE HERE (Fotos)

50 Cent di America rappa,no be pesin wey like to dey show imsef wen e come to him babe dem mata but dis time around he allow him girlfriend Tiffany Maiyon to sample dia pishor for Instagram.
Di babe ukwu nearly large pass life!
See di ovaload by yorsef for bottom hia:


 

BURNA BOY AND CYNTHIA MORGAN DON ENTA MAGNET, AS DEM DEY KISS DIASEF

E be like say Cynthia Morgan don dey give fellow reggae and dancehall star,Burna Boy dat German juice wey she dey tell me about.
You no need any oracle or ifa priest to tell you say somtin dey pipeline xcept say pishor dey lie.
Cynthia Morgan post pichor of wen two of dem join dia mouth like magnet,kon dey kiss,dey kiss,dey kiss,like say dia life depend on am.
She kon even fan di fire wen she write on top di foto say,"make we talk truth,make we dey real."
E be like say na Burna Boy she dey tell say make dem stop to lie,make dem yarn di world di truth say dem dey pin demsef down.
Some weeks ago,wen tori pipo from Mtv Base Real talk show,ask Burna Boy who him go like to tap bitwin gentle Chidinma and fire ting Cynthia Morgan,di bobo choose di German juice owner.
He also give dem quik ansa say two of dem (gentle and fire), go good for beta meal too.
Also some weeks ago too,Cynthia Morgan say she nor fit frend any Naija celebriti bicos dem poor pass church rat.
I go siddon for fence dey watch di new tori wey go come out bitwin dis two pipo and  I go dey watch too weda na me or na una dem dey fool wit dis foto.

NATURAL GINGER! I GET OVER 100 SONGS WEY I DON WRITE,YET I NOR DEY SMOKE IGBO - DON JAZZY

Dem no dey buy common sense for market,yet nor be evribodi getam.
Di king of dorobucci and Mavin Kingdom,Don Jazzy don show say him getam and he nor buyam from gutter.
For ova 15 years wey I don dey follow di lifestyle and read about di advice wey supastars don give up and comin miuzishan all ova di world,I neva see who don brake kam down di way wey Don Jazzy pissis am on top twita.
He give 13 koret advice to up and coming artiste on top di topic wey him call, #WhenYouFinallyBlow.
Di advice wey trip me pass na di one wia he for say,him get ova 100 songs but he no dey smoke Igbo to get inspirashon bifor him write.

Oya,check all di advice for bottom hia and forwardam to any miuzishan wey dey plan to blow wey u know...

Sunday 30 August 2015

MOCHEDDAH WANT TO KILL PESIN WITH HER SEXY BODY INSIDE SWIMMING DRESS (FOTOS)

Na wa for wire road o.
Di only way to let di world know say u dey very sexy akordin to all dis stars nowadays na to wear G-string snap foto,or wear swimming pant snap, or kukuma wear notin.
Mocheddah di Mtv Africa Award winna,don show her own sexy bodi wit her frends as she wear swimming dress.
I no fit shout,see more foto for yorsef!




CHECK OUT TONTO DIKEH WEDDING RING WEY COST N11.9M AND HER WEDDING PICTURES


Wondas shall neva end.
Wedding ring for N11million naira wey go do many many tins for pesin life?
U can bicom landlord wit dat money for dis town and change go remain but Tonto Dikeh and her new hosband,Churchill Oladunni, get differen plan as dem spendam for wedding ring.
Di ring get name sef (Canary Yellow diamond ring).

See Di ring for bottom hia and dia wedding pichors wey appun yestaday:




Saturday 29 August 2015

REGGAE STAR PATO RANKING,DON JOIN ASSOCIATION OF DADA OWNERS

Bifor, wen you see Naija reggae and dancehall star,Pato Ranking,u fit just call am rastaman witout dada bicos of di kain miuzik wey he dey play.
But now,no need to tink like dat bicos di bobo don finally join di dada owners association.
Di kain dada wey i see for dis boy head for instagram,make my liva shiva and i neva still recova.
Weda na artifisha or natural,i no kon know.
Na Pato Ranking go ansa dat Jamb nor be me.
Di dada klin sha o, but i no know weda
lice go dey inside.
If u see Pato Ranking dey scratch him head,weda for stage or anywia,make u know say na lice dey givam wahala.

Friday 28 August 2015

CRISTIANO RONALDO DON TOP Di LIST OF SPORTS PIPU WITH GOOD HEART AKORDIN TO NEW REPORT

Do good make good dey follow u and di good wey u do, God no go allowram kill u.
Cristiano Ronaldo don top di list of sports pipo wey don good pass for di world.
Akordin to DoSomething.org’s Athletes Gone Good 2015 list,CR7 beat pipo like John Cena, Serena Williams and Barcelona star Neymar.
Ronaldo don use him big name and voice wey him get for di world, take raise money for differen differen pipo.
Ronaldo, di forma Manchester United playa,don support Aid Still Required, Cahonas Scotland, Save the Children, UNICEF and World Vision.
He don also raise money for many rizin including di donation of more than 83,000 tausand dollars wey him provide for one 10-year-old fan wey need brain surgery.
He also give more than 165,000 tausand dollars to hep di cancer center for Portugal wey cure him mama of cancer.
He don also use im populariti to hep stop small shidren hunger and pipo wit obesity.

See di list of 20 sports pipo wit good heart for di world for bottom hia:


1)  Cristiano Ronaldo – Football
2)  John Cena – WWE wrestling
3)  Serena Williams – Tennis
4)  Yuna Tim – Figure skater
5)  Neymar – Football
6)  LeBron James – Basketball
7)  Heather O’Reilley – Football
8)  Maria Sharapova – Tennis
9)  Mo’ne Davis – Baseball
10)  Richard Sherman – American football
11)  Charlie White/Meryl Davis – Figure skater
12)  Dan Carter – Rugby
13)  Roman Reigns – WWE wrestling
14)  Ronda Rousey – Judo
15)  Lindsey Vonn – Skier
16)  Tom Daley – Diver
17)  Bethany Hanmilton – Surfer
18)  Saina Nehwal – Badminton
19)  Paul Rabil – Lacrosse player

20) shahid afridi - Cricket 

Thursday 27 August 2015

CRISTIANO RONALDO DON TOP Di LIST OF SPORTS PIPU WITH GOOD HEART AKORDIN TO NEW REPORT

Do good make good dey follow u and di good wey u do, God no go allowram kill u.
Cristiano Ronaldo don top di list of sports pipo wey don good pass for di world.
Akordin to DoSomething.org’s Athletes Gone Good 2015 list,CR7 beat pipo like John Cena, Serena Williams and Barcelona star Neymar.
Ronaldo don use him big name and voice wey him get for di world, take raise money for differen differen pipo.
Ronaldo, di forma Manchester United playa,don support Aid Still Required, Cahonas Scotland, Save the Children, UNICEF and World Vision.
He don also raise money for many rizin including di donation of more than 83,000 tausand dollars wey him provide for one 10-year-old fan wey need brain surgery.
He also give more than 165,000 tausand dollars to hep di cancer center for Portugal wey cure him mama of cancer.
He don also use im populariti to hep stop small shidren hunger and pipo wit obesity.

See di list of 20 sports pipo wit good heart for di world for bottom hia:


1)  Cristiano Ronaldo – Football
2)  John Cena – WWE wrestling
3)  Serena Williams – Tennis
4)  Yuna Tim – Figure skater
5)  Neymar – Football
6)  LeBron James – Basketball
7)  Heather O’Reilley – Football
8)  Maria Sharapova – Tennis
9)  Mo’ne Davis – Baseball
10)  Richard Sherman – American football
11)  Charlie White/Meryl Davis – Figure skater
12)  Dan Carter – Rugby
13)  Roman Reigns – WWE wrestling
14)  Ronda Rousey – Judo
15)  Lindsey Vonn – Skier
16)  Tom Daley – Diver
17)  Bethany Hanmilton – Surfer
18)  Saina Nehwal – Badminton
19)  Paul Rabil – Lacrosse player

20)shahid afridi - Cricket 

Tuesday 25 August 2015

CELINE DION HUSBAND DON YARN SAY,HIM LIKE TO DIE FOR INSIDE HIM WIFE HANDS

No mata how your reggae strong reash,it cannot skata di kain sweet blues wey dis woman dey play.
Celine Dion,dat ogbonge miuzishan wey her miuzik be like merisin to many pipu,don yarn say,her 73 years old husband say he like to die inside her hands.
Her hosband Rene Angelil,wey dey siriosly sick wit throat cancer akordin to Celine Dion,don alreadi plan him burial.
For two years now,na thru vein dem dey fidam and na Celine Dion dey carry all di wahala for head.
She don tell her hosband say make he no worry say,if na to die for inside her hands,wen di time reash,he go die for her hand.
Even tho say Rene Angelil nor well,Celine Dion still dey plan to go back to stage and kontiniu to play miuzik.
She say na wetin her hosband want be dat and naim dey giam mind to go kontiniu her karia.
She go return back to stage and paform tomorrow wey be 27 of August for Las Vegas.
Celine Dion and Rene Angelil don alreadi get three shidrens and twins dey among dem.

ENJOYMENT YANFUYANFU AS GOVERNMENT DEY PLAN TO IMPORT KEKE NAPEP WITH AIR CONDITION(foto)

Enjoyment yanfuyanfu go soon come di way of passengas wey dey enta Keke Napep bicos federa govment dey plan to import keke wey dey use AC(air condition) enta Naija veri soon.
At list dust no go dey enta yor eyes and give u katarr too mosh again.
My only fear be say,di AC go dey blow many pipo sotay dem fit sleep go and di Keke Napep pilot fit carry dem blow pass dia bustop bifor dem wake up.
Igbese!

Monday 24 August 2015

LOCAL THINGS: SEE AS EMPRESS NJAMAH DEY BLAST ROASTED YAM AND RED OIL FOR ONE CORNER

Choi!
E be like say dis wack go sweet o!
See as nollywood actress and Timaya forma babe enta one kona go grub roasted yam and red oil.
I for like borrow her some pònmo make di mata for complit.
Choi!

WONDAMENT! SINCE WHEN JUJU START TO EAT CREAM CRACKERS BISKIT?

Wonders shall neva end!
So dem don dey use cream crackers biskit dey serve juju now?
So,juju don dey request for lollipop too?
Chai!





Sunday 23 August 2015

U SURE SAY KCEE LIMPOPO FIT WAKA FOR STREET LIKE DIS WITH DIS KAIN DRESSING? (foto)

Boys are not smiling and no be many girls dey show dia 32 nowadays too.
Many pipo eye dey shook for money and if dem gidem chance dem fit turn sand to money.
Wit dis kain tiatia jeans wey dey show one one tausand naira notes wey di limpopo king wear,di only advice wey i get foram na, "Kcee bewia", bicos no be evritime di street dey love pesin espeshally wen di system no favor dem.
For street,dem fit use razor blade tia yor pocket togeda wit di money and dem fit slice yor yansh join.

Make we try dey live right.

SEE Di PIKIN OF OGAKPATAKPATA OF OKADA RIDERS,CHARLY BOY WEY BE COMPLETE OPPOSITE OF HIM PAPA(fotos)

One of di most crazy Naija celebriti,both for dressing ,bihavior,karata and yarnings,Charly Boy,AKA ogakpatakpata of okada riders,AKA his Royal Punkness,AKA Gbagada bad boy,get plenti shidren and u go expect say some go carry him karata.
Him sinior son na complit oposite of him papa and we go tell u tori about di rest shidren if day no quick break.
Di boy no dey put earring for ear or for nose,he no Draw tattoo for him bodi,nodog chain for neck,he no pack ring full hand like him papa.
Di bobo,Charles Alexendra Oputa Jr,be like normal guy man for street.
In short,who know no go bolivars say him papa and mama na complit oposite of am.

See more foto of di bobo:



Saturday 22 August 2015

UKWU - SEE Di MOST SEXIEST AMERICA SOLDIER WOMAN

Lexx jones,di America soja woman,naim pipo say be di most biutiful for dia millitree for yonda.
She come from,Atlanta, Georgia.
Wey dem say pesin sexy,na Lexx Jones,bicos sexy finish.
Her ukwu be like wetin heaven take time krate.
Some pipo readi to commit crime if dem say na dis babe go arrest dem.
Check di pishors by yorsef and tank me later.


Friday 21 August 2015

NA ME DISCOVER WIZKID(AYO BALOGUN), NO BE BANKY W-OJB JEZREEL

Di man wey produce Africa Queen di song wey blow 2face,don yarn say naim diskova Wizkid,no be Banky W as many pipo dey tink.
OJB Jezreel say naim be di fest pesin wey visit dia haus go tell Wizzy pipo say make dem allow di bobo face miuzik bicos he dey see raw talent for Wizkid bodi.
OJB say nor be evritin pesin dey yarn espeshally  now wey he don reash fifti years.
He say at im age,he no need to dey blow im trumpet but  he just say make he yarnam make pipo know wetin dey pipeline.
He say dat time wey dem dey carry Wizkid from show to show,nobodi readi to allowram to dey paform bicos dem no dey filam dat time.
OJB yarn say for somebodi to dey una click,u must don diskova wetin di pesin sabi and dat na wet in dem see for Wizkid bodi dat time.

OH MY GOD! TONI BRAXTON DON DEY MAD? WHICH KAIN DRESSING BE DIS? (Foto)

Di BREATHE AGAIN SINGA,TONI BRAXTON 
Dem say na so e take dey start.
Toni Braxton,di motha of two,don dey koloment?
abi na wich kain pishor be dis one again?
Dis her pishor fit make some pipo nor Breathe again.
Abeg, shay na vidio she dey shoot,abi na rag day she dey do or na madness won start wit dis kain tiatia jeans wey she wear?
If u get di ansa,lemme know,abeg.
Di TONI BRAXTON WEY WE KNOW

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...