MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Saturday 8 August 2015

WITHOUT EDDIE LAWANI MY LIFE FOR GET AS E BE - 2FACE

Dem say anything wey belong to Caesar make u nor waste time to givam to ram.
2face don carry di respect wey Eddie Lawani dizav givam.
Akordin to 2face,di day wey he meet show promota,Eddie Lawani, na dat day naim levels change for him life.
2baba yarn all dis one wen he dey follow tori pipo yarn.
He say during dat time,Eddie introduce dem to plenti pipo.
He say wen he see dem naim he alla say,"shuo!na dis kain bizness una dey do"?
Like play,like play 2face say,na since dat time naim tins take be for him life come rish now.


No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...