MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Monday 17 August 2015

SHINA RAMBO DEY LAFF WIZKID BICOS AKON BRODA CALL AM,"KING OF NIGERIA"

Na dis one dem dey call yanga dey sleep trouble go wake am.
If u dey follow Wizkid tori,u go know say him get bad mouth pass even pepeye.
Ask Saeon,ask Skales.
Also ask dat boy wey Wizkid yab for instagram say; poor pipo always dey tink say dem get opinion sake of say he try koret Wizkid bad inglish.
Sina Rambo don dey laff just bicos Akon broda,Bu Thiam put di pishor of Wizkid for instagram and say,“The King of Nigeria, WizKid Album in stores Now!!”
Sina Rambo see di tori naim he rosh coment on topam wit dis laffin sign,"Lmao (laugh my ass out)".
Sina Rambo di HKN gang rappa,na cousin to Davido and Wizkid na Davido biggest rival for di industri.
Weda Wizkid go reply Sina Rambo,na dat one we neva know.
Make we dey watch.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...