MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Thursday 6 August 2015

OKOCHA MAKE US DISOBEY OUR COACH - DiOUF

Two times African footballer of di year and Jay Jay Okocha forma team mate for English primiaship, El Hadji Diouf,don yarn say, Okocha make dem disobey dia coach Sam Allardyce for Bolton wen dem play togeda. Akordin to wetin africanFootball.com report,Diouf say Okocha dey always tell dem for Bolton Wanderers say make dem play wetin dem like and make dem no listen to only di coach yarns.
Diouf say wen Big Sam giv dem orders,Okocha go giv dem anoda order to play wetin dem want.
Di Senagal forma winga El Hadji Diouf say,for two good years dem finish for numba six position bicos of dia biutiful football.
He say na dem play di most entataining football for England dat time and he enjoy to dey play wit Jay-Jay Okocha, Fernando Hierro, Vincent Candela and Nicholas Anelka for dose years.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...