MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Monday 3 August 2015

OSHIOMOLE AND HIM WIFE VISIT WOLE SOYINKA

Edo State govnor Adams Oshiomole and him oyoyo wife from Cape Verde,Lara Fortes, don carry waka go meet bookuru oga, Professor Wole Soyinka for him house for Abeokuta,Ogun State.
Dem say di only pamanet tin for life na change.
Dis change wey APC carry enta naija,rili rili dey work for Oshiomole life as dis him biutifu wife don make am change from wearing khaki uniform to nacking beta shinos and longsliv shirt. 
Even kpakpa sef he dey nod some wicked wicked suit nowadays.
No be only Oshiomole and him fine malawi don visit Soyinka as he don also dey resiv top APC visitors since for some weeks now.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...