MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Thursday 20 August 2015

Di FINE ANSWER WEY I GO GIVE FLAVOUR NABANIA IF HE SAY HE WON BE MY BOBO NA....

Miss kedike,Chidinma,don yarn tori pipo plenti tins about her love life.
She say di rizin why she still dey single na maybe she neva see di man wey God krate foram or maybe na di man neva siam.
She yarn say notin for all her plenti man frends dem bicos na odinari frends dem be toram.
She say many stars dey die foram and she fill say by now dem go don finisham for ground wit dia plan but di truth be say she nor get anytin wit dem.
Pipo don dey link two stars name to chidinma as bobos wey she don date.
She say di kain frend wey she be wit soundcity presenta,Adams,na di kain one wey be say if dem see,dem dey even insult diasef.
Chidinma say she no soprise as dem say Adams na her boyfrend bicos dem dey veri close.
As for Flavour wey pipo dey suspect say dem dey do kelekele love,she say notin join dem apart from miuzik.
She say if Flavour open mouth say Chidinma be my sweetie porero,she go tellam capita "NO".
You no go blame pipo wey dey suspet two of dem bicos dem don see dem dey kiss for vidio,dem don see dem for wicked wicked ikoro.
Two women,Sandra and Anna Banner don alreadi born for Flavour.
Maybe Chidinma dey try to use her brain.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...