MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Monday 10 August 2015

I RICH PASS BILL GATES - PASTOR ADEBOYE

During Di nomba 63 Annual Convention for Redemption Camp bifor di holy communion Service, Pastor Enoch Adeboye Di Genera Ovaseer of di Redeemed Christian Church of God (RCCG),Yarn during di message, "Ovaflowing Cup", say spiritual richness beta pass worldly richness.
Adeboye say,if di richest man for di world,Bill Gates need shoe,he go enta market go arrange am but if him  announce say he want shoes for redemption camp,di shoes wey pipo go carry come no go contain di auditorium.
He say Him rich pass Bill Gates welwell bicos him get houses for at list,188 kontris were Redeem churches dey and anytime wen he visit dis kontris na so him shidren go dey strogle say,"dadi!dadi! Come and stay wit me!".
ADEBOYE WITH VICE PRESIDO YEMI OSINBAJO FOR Di CONVENTIONS
Pastor Adeboye say if him announce for di ground say him need car to take travel go di new auditorium,how many cars u feel say di members of di church wey him dey call him shidren go buy foram?
He kon pray say,Pipo wey nor get cars,veri veri soon God go giv dem dia own cars.
Baba kon beg evribodi say bicos of dis spiritual profit,make dem try be Ogbonge soul winna bifor dem go live di convention ground and dia cup go dey ovaflow troway.
Halleluyah somebodi!

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...