MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Monday 10 August 2015

OJUELEGBA NAIM BE Di BIGGEST SONG FOR AFRICA!!PERIOD!! - WIZKID

Bobo of di moment,Wizkid don yarn say,Ojuelegba,di song wey don katapot him career enta anoda level,na di nomba one song for Afica.
Koret koret miuzishans for obodo oyibo don dey line up dey praise Wizkid and him Ojuelegba song.
From Drake to Skepta,From Alicia Keys and her husband Swizzbeat to even South Africa rapper Cassper Nyovest,di praise still kontiniu.
Wizkid post one vidio of him Cort D'voire fans wey dey sing Ojuelegba and he kon write follow am say, "Ojuelegba na di bigest song for Africa!!Period!!
Na dis one dem dey call "Bragging right" for oyibo aftaraw plenti pipo don dey put stamp on top him song,Ojuelegba.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...