MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Friday 7 August 2015

KEREWA WAHALA! BRAZIL GIRLS DON MAKE MICHAEL JACKSON PAPA GET STROKE



87 years old Joe Jackson,Michael Jackson papa get stroke and also sofa three heart attack hours afta dem siam dey catch groove wit yong Brazil gehs.
Dem even say im heart stop for 10 seconds but di dokita come tritam fast.
Akordin to tori wey also rish our table for dis him Brazil visit,dem say Joe Jackson take 3 kerewa merisin make he fit jollificate wit Brazil gehs and he also plan to arrange N45million birthday groove for dia and na one day to di birthday naim dem rosham go hospita.
Tho sha,as dem dey trit di sickness,Jackson papa say,no shaking make di birthday parti carry go witoutam.
Dem don relizam from hospita now.

Altho sha, Joe Jackson assistant PR,Liza Crazy deny all di kerewa merisin tori wey dey fly for evriwia.
She say Jackson dey sleep early and he no dey carry take merisin except say dokita apruvam.
She say all dis tori na lie.
Anyhow u lookam,di truth be say, di fear of Brazilian malawis,na di biginnin of wisdom as govment laws,soport ashawo bizness for Brazil.
So be kiafu wen you visit dia make u no go get heart attack.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...