MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Friday 14 August 2015

MAKE UNA LEAVE SEPTEMBA ALONE - OREZI DEY WARN WIZKID,DAVIDO AND IYANYA

Orezi don warn Wizkid,Iyanya,Davido and any oda miuzishan wey fix di launching of dia album for Septemba,make dem use dia church mind and postpone dia date bicos e go red.
Orezi go launch him album wey him call "Ghen Ghen " for Septemba 1 and he don dey draw di rest pipo dem ear say him own album too sweet so make dem relax bicos all di club go hia him mata,all di street go filam,all radio and Tv stations go carry him miuzik for head like lakpalakpa.
So if dia album no reign,make dem no blame am since na di same piroid all of dem dey plan to reliz dia album.
Di bobo say him fans don enta sweet wahala as far as dem like good jammingjamming.
Alhaji Orezi say him marketa sure die so diafor,no shakement bicos di album go enta all di ikoro for naija.
Di Isoko,Delta state born miuzishan also use opotuniti tank all him fans as dem stand gidigba for him back and he kon also tank Baba God wey make tins dey appun for him life.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...