MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Tuesday 31 January 2017

PROFESOR AKINDELE DON CALL 2FACE 'BLOODY ILITERATE' AND BAD EXAMPLE BICOS HE GIVE PLENTi GIRLS BELLE AND NOW HE DEY PLAN TO PROTEST AGAINST BUHARI GOVMENT


2face don dey resiv insult from some few pipo sake of say he call pipo make dem join am to protest against dis Buhari gofment as he say pipo dey suffer.
One professor of bookuru mata Professor Akindele Adetoye,don blast 2face for Facebook say,he nor fit manage imsef as he giv many girls belle without using condom.
And now di same pesin wey nor fit manage imsef won protest against gofment say dem nor fit manage di kontri well.
Charity as dem talk am dey start from home and akordin to di professor,make 2face go start to manage imsef from home bifor he carry enta street.
2face neva talk anytin onto wetin dis professor yarn.
Yanga dey sleep,trouble dey wake am.

Monday 30 January 2017

Di WIFE OF ONE OF Di FIRST YORUBA RAPPER,LORD OF AJASA,DON BLAST OLAMIDE SAY HE DEY DO LIKE SAY HE NOR KNOW DEM AGAIN




I nor know weda Yoruba local rapper Lord of Ajasa don epp Olamide bifor o,
but di way wey Ajasa wife take blast Olamide on top twita,shock me.
She say Olamide dey do like say he nor know dem again but God dey.

Sunday 29 January 2017

CALIFORNIA PIPO DON DEY TIRE TO DEY INSIDE AMERICA AS DEM DON START PLANS TO COMOT AND STAND AS KONTRi OF DIA OWN


Veri soon if tins go akordin to plans,if u ask California man say wich kontri he come from,he go say na California nor be America again.
Carlifonia wey be di nomba 3 biggest state for America and also di state wey pipo plenti pass wit about 40 million pipo,don submit Di 'We won Comot' papers to di Seketri of states office akordin to tori wey we gada.
Bicos many of dem nor like di new President Donald Trump,so diafor,many of dem biliv say dem fit sorsid wit dia plans.
We dey watch.
If e appun,Ogakpatakpata go stil let una know,no shaking.

Saturday 28 January 2017

YOU GO LOVE DIS SHORT VIDEO AND PICTURES OF HOW NAIJA CELEBS LOOK LIKE BIFOR DEM BLOW..REEKADO BANKS PISHOR GO SHOCK YOU


Money good.
From Wizkid to Cynthia Morgan to Runtown to Timaya to 2face to Tonto Dikeh to,...Di list plenti.
Klik and See Di vidio of how some of dem bin wowo.
Some na strong atutupoyoyoyo bifor dem blow...


SEE LOVE NWANTiTi: 2FACE IDIBIA AND ANNIE IDIBIA KISSING,TWERKING,JOKING (VIDEO)



Well,e beta say di Africa Queen singa 2face don change as he always dey show off him wife Annie to di world.
Unlike bifor wey di bobo dey score for evriwia.
Check out dis video for bottom hia.u go see wetin I mean...


NEW AMERICA PRESIDENT DONALD TRUMP,DON BAN 7 MUSLIM KONTRiS FROM ENTERING AMERICA AND Di KONTRiS NA LIBYA,SUDAN,SOMALIA,YEMEN,SYRIA,IRAQ AND IRAN


During campaign we bin feel say Donald Trump dey carry yarn wen he talk say him go deal wit muslims but since he bikom presido last week,di man don dey do. as he talk.
One of di first tin wey Trump do yestaday na to ban seven Muslim kontris make dem no enta America.
Di seven kontris na,Libya,Iraq,Iran,Sudan,Somalia,Yemen and Syria.
He also yarn say dem go put more kontris for dis list and bodi don dey phone me say Naija name fit go appia for di new list. God forbid!
Why bodi nor go phone me wen Boko Haram from di north nor allow pipo Rest wit bombi bombi.
Meanwhy,i nor know wia dem for dey sell bomb.
Abeg Donald Trump,me,my frends,my famili nor dey among o.
You know say my pipo dey yonda and I nor won hia say I nor fit go for visit again.
Trump,Just in case,jejeje select di pipo wey dey giv Nigeria bad name and ban dem.

Friday 27 January 2017

PASTOR ADEBOYE DON YARN SAY,NA JOLLOF RICE WIT BETA BIG CHICKEN ON TOPAM,NAIM CARRY AM GO START SCHOOL FOR UNiVASiTi OF NIGERIA,(UNN) NSUKA FOR ENUGU FOR 1963


Di Genera Overseer of di Redeemed Christian Church of God RCCG,Pastor Enoch Adeboye,don tell tori pipo say,wetin make am find admission enta Univasiti of Naija,Nsuka,for Enugu state na,jollof rice.
He say wen him and oda students travel go UNN for 1962 for and wen he see student wey dey eat and enjoy Jollof rice wit half of full chicken,dis come make am dey swallow salaiva.
Adeboye say as he dey comot for di school dat day,naim him pray to God say make God givam admission enta di school di following year and rili,God ansa him prayer.
For 1963,Adeboye gain admission into UNN but he nor graduate for di school bifor he comot.
Pastor Adeboye yarn all dis one wen he carry waka go di school go kolet Honorary Doctorate Degree award for di school on Tuesday.

Thursday 26 January 2017

BURNA BOY AND DAVIDO DON AGREE TO JOIN 2FACE ON FEB 5TH TO PROTEST AGAINST FEDERA GOFMENT ON TO SAY,PIPO SUFFER DON TOO MUCH FOR DIS KONTRi


Africa and Naija supastar,2face Idibia,don dey gada soport on top di mega rally wey he dey plan for February 5th to take protest against federa gofment on to say Naija pipo suffer don too much.
Di first two miuzishans wey don agree to join tubaba for dis waka na,Burna Boy and Davido.
Burna Boy don even yarn say him readi to die for dis waka to take make gofment aware say pipo don tire for dia lidaship.
One tin wey I know be say,na beta crowd go come out dat day bicos ova 100 million pipo dey cry di same time bicos of hard life wey dem dey face for dis kontri.

Wednesday 25 January 2017

SINGA BRYMO,Di BOBO WEY JOINBODi SING OLEKU WIT ICE PRINCE DON TALK SAY,IF HIM DIE,NA HELL FIRE HIM DEY GO STRAIGHT



If u kpai today,wia u dey go?
Hell fire or heaven?
Nigeria singa Brymo,don yarn on top twita say,if him die na hell fire straight as he don alreadi buy land for dia.
Akordin to Brymo,he say,wen he die na hell fire him dey go bicos na dia all good pipo dey go.
Wetin he mean by dis one naim we neva undastand.
Weda na joke him dey or not we go know afta devil reliz press statement on dis mata.
As for me, i be Heaven boy,i nor know about u.

Tuesday 24 January 2017

AKWA IBOM MEN NOR DEY TRIP ME AT ALL BUT I FIT DIE FOR IGBO MAN LOVE..NA SO ACTRESS BRYCEE ADIAH BASSEY TALK




Fine shenkess and actress,Brycee Adiah Bassey,don yarn tori pipo say Akwa ibom men nor dey Trip am no mata wot but,she nor dey use Igbo men play.
She say Igbo men asent dey sexy and dia voice dey switam for bodi.
Dat is,di way wey dem dey yarn dey trip her like mad.
Evribodi get wetin dey make am hapi.
If Bryce own na love for Igbo men dey make her hapi,goodluck toram.
My own na just N1 Billion naira i dey look for to make me hapi.

VIDEO OF BURNA BOY WEY DEY COOK MONEY FOR POT


See money wey pipo dey find naim dis pikin wey dem dey call Burna Boy take dey play.
See dollars!
Weda hin plan na to use am dey pepper us for eyes i nor kon know.
if not,why he dey cook di money for inside pot and crowd nor even get money to buy pot take cook banga soup.
Watch di pepper-eye vidio for bottom hia...


Monday 23 January 2017

BILLIONAIRE BIZNESS MAN 'RAZAK OKOYA' SAY HIM NOR REGRET SAY NA ONLY PRIMARY SCHOOL CERTIFICATE HIM GET BICOS MONEY WEY ALL OF US DEY FIND,HIM DON GETAM



Di chairman of Eleganza products like biro,plastic chairs etc,Mr Razak Okoya,don yarn tori pipo say him nor regret say him nor get pass primary school certificate.
Afta he finish primary school,bizness enta him head and as he start to see money,na once baba head knock for anytin wey konsign school.
Although for di bigining,he dey spend time for im popsi tailoring shop.
Razak Okoya wey selibrate him 77 years baitday last week say,even tho him busy,he stil dey krate time to yarn wit hin famili and also yarn dem tori of how he take make am so dat dem go learn from am.

Sunday 22 January 2017

ONE GUY 4 TWITA DON YAB FELA PIKIN 'FEMI' SAY,HE NEVA ACHiV ANYTIN FOR MUSIC APART FROM CAUSING TRAFIC AND PRODUCING PLENTi iGBO SMOKERS AND THIEFS 4 OGBA,LAGOS


Naija pipo bad mouth and razor blade, we nor know di one wey sharp pass.
Just simple sense wey Fela pikin Femi Kuti try to make,naim some pipo start to yabam for twita.
Some days ago,Nigeria Air Force throw bomb from plane on top inosent pipo head.
Plenti pipo die and Dem kon tell us say na mistake.
Now Femi kon yarn on top twita say,imagine di president of Nigeria Air Force dey go abroad for holiday instead of am to first visit di familis of pipo wey die for di bomb blast.
Since Femi yarn dis one,some pipo nor hapi witam for twita.
One wey call imsef Thenthanus say,Femi neva achiv anytin for miuzik apart form inkrizing di population of igbo smokers and tiffs for Ogba area for Lagos.
He also yarn say,anoda Femi achivment na to use dia Africa Shrine cause traffic for Ogba.
Femi sef nor waste time to reply am.
He say naim be di first Naija miuzishan to win Kora Award for Nigeria,him don reliz 9 intanashona albums and Dem don choose am 4 times for Grammy Awards for Yankee even tho him nor win any of di award.
Na wa o.
Drama evriwia.

Saturday 21 January 2017

POPULAR TV COMEDIAN HAFEEZ AYETORO A.K.A SAKA,DON TALK SAY,LIKE SAY HIM NOR KNOW GOD,WOMEN FOR SKATA HIM MARRIAGE FOR 2016


Popular tv komedian Saka,real name Hafeez Ayetoro,don yarn tori pipo say if nor be God,women for tiffam from hin wife for 2016.
As dem try rish di man nor fall for dia temptation,he hold imsef.
As a star,women go dey pack come meet you.
Dem go try try to sleep wit u,some Go role yansh pass yor Front make you konfiuz.
Saka say all dis ones wey dem do,no one move am bicos he get agreement wit God not to cheat on him wife wen he marry.
You dizav praise,e nor easy.

Friday 20 January 2017

DEVIL DON DEY USE TEKNO BRAIN FRY AKARA AS Di BOBO WEY SING 'PANA' GO BARBinG SALOON AND AS DEM DEY BARB HIN HAIR,HE DEY SMOKE iGBO AT Di SAMETIME


To make am and to dey popular don bikom crime again?
Imagine Tekno enta saloon to cut hin hair and di bobo dey smoke igbo as di barber dey Barb hin hair.
Naim first start to smoke ganja?
Na must say he must let di whole world nor say he dey smoke?
Wich kain Yeye exampo dis shidren dey set?
Yeyebritis.
Watch di Yeye karata wey dis boy dey show for bottom hia...


VIDEO: Di BABE WEY DEM SAY SKATA TONTO DIKEH MARRIAGE DON YARN HER OWN SIDE OF Di STORi


I watch dis vidio of di babe wey dem say dey behind Tonto Dikeh marage kasala and I nor undastand wetin she dey yarn.
Her name na Rosaline Meurer and dem say she dey always dey do tins for di 'other room' with Tonto Dikeh hosband.
She get two jobs at di same time.
She be Nollywood actress and she also dey work for Churchill foundation akordin to wetin she yarn for dis vidio.
She say Tonto Dikeh hosband Churchill get good heart well well and she yarn plenti oda tins.
You dey study anoda woman hosband heart?
You be scientist?
Watch all wetin she yarn about Tonto Dikeh marage wahala for bottom hia...


Thursday 19 January 2017

SUPER EAGLES CAPTAIN MIKEL OBI,DON LOOSE FIRST 3 MATCH WIT HIM NEW CLUB FOR CHINA TIANJIN TEDA..DEM LOOSE 2-1,6-2 AND 1-0 FOR DiA LAST MATCH


Forma Chelsea playa Mikel Obi don loose three straight match wit hin new club Tianjin Teda.
Na wa o.
Fear change o.
Tins can change anytime.
Just now just now,Mikel don turn Forma Chelsea playa.
Dem loose dia first match 2-1,di second one 6-2 and dia third match 1-0.
Dis one don pass be kiafu o.
I pray make hin nor go score own goal for Super Eagles match o.

Wednesday 18 January 2017

AFTA HE MAKE MILLIONS WIT HIM FIRST TWO FILMS,COMEDIAN AY DON ANNOUNCE Di NAME OF HIM NEW FILM " 10 DAYS IN SUN CITY"



Warri born but Yoruba boy,Komedian Ay,don announce di name of di new film wey him dey work on,on top Instagram.
He sample tori pipo di pishor of di production meeting wey go appun for South Africa.
Di name of di film akordin to AY na,10 days in Sun City.
Hardworking bobo.
Goodluck.

AWWW! SEE Di PiKiN WEY DEY CRY BICOS OF WIZKID SONG 'DADDY YO'


Nor be small tin o.
Papa say make hin pikin learn more about ABC but di son dey cry say hin won hear Daddy Yo by Wizkid.
Small Daddy yo and small book nor be bad idea.
Aftaraw,if una no like di song,una nor go dey play am make hin hear.
Now di baby boy don love di song like cheese balls.
Di winna for hia na Wizkid.
Wen shidren don dey,hook to yor songs,dat one na epidemic.
Watch di vidio of wen di smallie dey cry for Daddy Yo for bottom hia...


Tuesday 17 January 2017

Na Wa o! 2FACE WIFE,ANNIE IDIBIA,DON PRAY TO GOD MAKE SHE AND 2FACE DIE TOGEDA Di SAME DAY


Na wa o!
Dis kain prayer tire me o.
Now wey Annie Idibia don dey pray make God allow she and 2face life end di same day so,she well?
Dat kain tin nor dey quick appun except say na accident or poison.
Be kiafu about yor prayers.
Dem born una di same day?
Abi dem plant una placenta for di same place?
You nor see anytin pray about,na as you and 2face go take die di same day naim u dey tink.
Kontiniu.

Monday 16 January 2017

ONE AMERICA DJ AND RADIO PRESENTER,J NICKS OF 'HOT 107.9FM', DON YAB NAIJA PIPO SAY,WE NOR SABi SPEAK ENGLISH


Wetin dis J nick guy smoke?
E be like say devil don use hin brain fry akara.
Can u imagine di radio DJ yarn say we nor sabi speak inglish during one joinbodi intaviu wit America base Naija miuzik group,Mingo for 107.9 Hot Fm.
By di wey sef,na our mama language?
China dey speak dia language,Japan get dia own,France nko?dem get dia own.
If nor be oyibo wey use us take shine for slave trade piriod,we for get our own too wey di world go rekognaiz.
Watch di vidio for bottom hia wey J Nicks for dey yab us...


SEE BABE! AMERICA BOYS MAKE UNA NO DISTURB DIS OBAMA DAUGHTER O!


Na fatalaiza Barrack Obama dey feed dis hin first daughta wit?
Di rate wey dis hin daughta,Sasha take dey ripe nor be small mata o.
America boys go allow dis one rest so?
Maybe her papa fit advice her to marry woman like her since na wetin her Papa like be dat.
Woman marry woman,man marry man na wetin Obama tell us for di 8 years wey he rule America.
As I play enta Miami Beach for Yankee make I katch small fun,wetin my eyes see wen I sight Obama daughta,Na my Foto Camera go fit tell una.
See her bikini pishors yorsef.
Wen i see her,I niali toast her but I just kpror bicos she be only 15 years old.
Make man nor go enta prison.

Sunday 15 January 2017

UPON SAY HIM MAMA NA TiSHA,DADDY SHOWKEY DON TELL TORi PiPO SAY,E PAIN AM ENTA HIM BONE SAY HIM NOR GO SCHOOL


Yestaday,I bring una tori say Nollywood big name Kanayo O. Kanayo don go back to school but today,Getto Soja Daddy Showkey don yarn tori pipo say,he dey regret Til today say him nor finish school.
He say him for like get PhD too bicos anytime wen he see miuzishans wey go school,him dey dey proud of dem.
Di galala king say,di sekondri school wey him nor finish and di univasiti wey him nor go stil dey pain am and if he get anoda chance again,him go take edukayshon sirios.
Showkey say although hin mama na tisha but she stil givam chance to dey do anytin wey him like and like say hin bodi phone nam dat time,he for jejeli finish school bifor he start di miuzik.
Of resent,Showkey say him and komedian Helen Paul diskors di school mata but di way wey di tin be now,him brain don knock but him shidren go kontiniu di school for wia him stop.
Daddy Showkey exkiuz be say,he nor fit live hustling and start school now bicos di pipo wey him dey take kia of too plenti.
But Showkey,part time school dey now.
Ask Ayiri.

Saturday 14 January 2017

Naira and Dollar Fight: NAiRA DON KONTiNiU TO SUFFER AND KONTiNiU TO FALL YAKATA FOR WERE DOLLAR DEY AS PIPO CHANGE ONE DOLLAR TO 497 NAiRA YESTADAY


Pipo wey see Di vision say one day Naira go fall to N500 to one dollar fit klap for demsef now as na 3 naira naim remain make devil ansa dia prayers.
For parallel market or black market yestaday,naira sell for N500 to one dollar.
Dis one na pure bad market.
Make dis kontri nor go fall inside well one day o.

Friday 13 January 2017

IN CASE U NEVA HEAR,ONE OF NOLLYWOOD BIGGEST NAME KANAYO .O. KANAYO,DON TALK SAY,HIM DON GO BACK TO SCHOOL AS HE DON DEY ENTA CLASS FOR UNiVASiTi OF ABUJA


My broda,notin like school o espeshali wen you see most of di pipo wey dey rule di world today.
Nollywood actor Kanayo O. Kanayo,don announce on top Instagram say him don go back to school.
Nice one but i hope say we nor go hear later say,na film he dey shoot?

Thursday 12 January 2017

FOOTBALL WIZARD RONALDINHO FROM BRAZIL,DON YARN SAY,NAiM CHANGE BARCELONA STORY WEY DEM MESSi AND NEYMAR DEY ENJOY TODAY


Brazil player Ronaldinho,don talk say na wen he come Barcelona naim dia stori take pick up again afta so many years.
E get one time wey Barca reign wen Johan Cruff dey play for dem but afta dat time na Real Madrid be nomba one until Ronaldinho come for 2008.
Since dat time come rish today akordin to di bobo from Brazil,many pipo don rekognaiz Barca style of play and evri club dey dream to play like Barca.
And wen Messi carry hin own magic come join too,Barca kon large die.
Nor be lie,we biliv u Ronaldinho aftaraw wen u join Barca,you win La Liga,Champions League,You win World Cup wit Brazil and also win di best playa for di world two times.
Wetin remain?

Wednesday 11 January 2017

AFTA HE FAIL AMERICA EMBASSY INTERVIEW TIRE FOR MANY YEARS, Di AKPAKO MASTA TERRY G,DON FINALLY TRAVEL GO AMERICA FOR Di FIRST TIME


God don finalli ansa Terry G prayer as he don finalli enta America for di first for him life.
Di Akpako masta imsef,don try tire to go America plenti times but anytime wey di bobo go embassy,he always dey fail dia test.
Dis life na wa o.
See America wey i dey travel go anytime wey I like like say na my backyard.
Anyway sha,Terry G congratulashons.
But wait o,
I hope say Terry G shirt no always dey smell igbo naim make he always dey fail is test?
Well at list dis time around you pass dia exam.

Tuesday 10 January 2017

SEE MONEY! iNSiDE TWO WEEKS,DAVIDO DON BUY N150 MiLLION CARS FOR iMSEF..Di FIRST ONE NA 2017 RANGE ROVER and Di SECOND ONE NA 2017 MERCEDES BENZ GLE 430



Sidon look is a noun,e don appun is a verb.
Baba God,abeg how many head u give Davido?
Di bobo don plasta area skata.
Inside two weeks di bobo don buy 150 million naira cars.
He buy 2017 Range Rover of N80million for imsef for krismas.
Two weeks afta DAT one,he don buy Benz GLE 430 of N70 million again.
Dis one don pass be kiafu.
No wonda some boys dey ask wia dem for dey change head.
God abeg change your shidren stori.
Nor be only Davido dey dis world.

Monday 9 January 2017

DADDY FRESH DON BOAST SAY,NAiM STILL BE Di GODFATHER OF AJEGUNLEE MUSICIANS AND NAiM MAKE DEM GIVAM Di TITLE 'ASIWAJU OF AJEGUNLE


Di eleru gberu singa,Daddy Fresh don yarn say NAiM be di godfather of Ajegunle miuzishans.
Akordin to Fresh,he say dat na why dem givam di Asiwaju of Ajegunle title.
He say na wen he enta miuzik,miuzishans like Daddy Showkey,Fada U turn,Baba Fryo dem follow am for back enta and wen he comot dem still follow am comot.
So diafor,now wey he dey try come back, he say him hope dem go follow come back too.
But dis one wey Daddy Fresh say naim be Godfada of Ajegunle miuzik,Daddy Showkey go hapi so?
Bicos many pipo bin dey feel say na Showkey be di real Godfada.
I nor won hia kworel sha.

Sunday 8 January 2017

NA ONLY NIGERIA MUSICIANS DEY FLY PRIVATE JET FOR AFRICA AND E SHOW SAY WE TOO MUCH AKORDIN TO PMAN PRESIDENT,PRETTY OKAFOR


Performing Musicians Association of Nigeria, PMAN President, Pretty Okafor,don dey praise di entertainment industri for Naija base on wetin di miuzishans don achiv.
He say for Nigeria miuzishans to be di only ones wey dey fly private jets for Africa show say we don gap other Africa kontris for di bizness.
He also yarn say,di success wey Wizkid, Yemi Alade,Tekno and di rest get for 2016,na koret evidence say na we be nomba one.
Di bobo say,even as pipo dey konplain rish say tins hard,e nor affect our miuzishans.
He say if u go Nite clubs for America, Jamaica and oda parts of di world,dem dey blast Naija miuzik steady.
Dat one self dey but na only Naija miuzishans dey fly private jets for Africa?
Well make we liv mata for Mathias,I nor fit argue.

Saturday 7 January 2017

ONE NAiJA BOBO DON YAB ONE TANZANIA BABE,MICHELLE, ON TOP TWITA SAY TANZANIA PIPO TONGUE DON WEAK AFTA Di BABE SAY,GHANA JOLLOF RICE SWEET PASS NAiJA JOLLOF




Wen dis Naija and Ghana jollof rice war go end?
Since dem born me naim I dey hear Ghana pipo and Naija pipo dey drag say na dia jollof swit pass.
Oda kontris don dey shook mouth for dis jollof war.
Di ansa wey one Tanzania babe get from one Naija bobo on top twita afta she say Ghana jollof swit pass Naija jollof,go shock you.
Di bobo just reply di babe say Tanzania pipo tongues don weak naim make to know swit food dey hard dem.

Friday 6 January 2017

ABI NA JOKE? COMEDIAN SEYI LAW,DON YARN FOR STAGE SAY NA SINGA TiMi DAKOLO,NAiM INTRODUCE AM ENTA 'MMM'


All dis komedians don too yarn so tay we nor dey know wen dem dey yarn truth.
One of di spiritual Bank 'MMM' wey pipo put money and wey also don make pipo faint anyhow,don resiv one ogbonge konfeshon.
Top komedian Seyi Law don yarn say na West Africa Idol Winna Timi Dakolo naim pusham enta MMM.
He yarn dis one for comedy big name, Alli Baba new year day groove for inside Eko hotel.
Trap don katch many pipo money since dis spiritual bank announs say dem won take small break bifor dem go come back for January 14.
Out of June 12 and January 14,I nor kon know di one wey popular pass.
We go bring una more tori as e take konsign Timi Dakolo anytime wen he respond for di mata wey dey ground.

Thursday 5 January 2017

GOVNOR ABIOLA AJIMOBI OF OYO STATE DON YARN SAY TO RULE Di STATE NOR BE BEANS,AS HE SAY Di STATE DEY GIVAM HEADACHE BICOS E TOO HARD TO RULE


Dis kain konfeshon fit make pesin loose election bicos pipo nor go get one single konfidens for you.
Oyo state Gofnor,Abiola Ajimobi don yarn say,to rule Oyo state nor be beans at all.
Make di bigness of Oyo state nor go givam high patenshon bicos akordin to di gofnor,he say only Oyo be like 7 states put togeda.
He yarn dis one for Oyo state 2017 inter-faith service for Ibadan.
Oga Gofnor,if Oyo too big for you,step down for me,i sabi rule welwell.
Ruling na MY calling.

Wednesday 4 January 2017

CONGRATULABIA TO MICHAEL JACKSON JUNIOR SISTA,JANET,AS SHE DON FINALLY BORN HER FIRST PIKIN AT 50 YEARS AND NA BOUNCING BABY BOBO


Notin God nor fit do.
At 50 years,God don do am for Janet Jackson di junior sista to Michael Jackson as she don welkom her first pikin wit Arab hosband and billionaire Wissam Al Mana.
Akordin to her tori assistant,she born yestaday and evritin go siriri wereren,evritin go smooth as she dey born di bouncing baby bobo.

Tuesday 3 January 2017

SEKEM DANCE FOUNDER,MC GALAXY,DON TELL TORi PIPO SAY,IF HIM NEW SONG 'YOUR LOVE' NOR BLOW,HE SAY HE GO PACK AND GO BACK TO VILLAGE


Sekem singa Mc Galaxy,don yarn tori pipo say if hin he nor blow wit hin new song for 2017,e go pack go back to village.
Di song,Your Love akordin to di bobo get evritin wey go change di industri.
Okay,we dey wait.
We go remind you if e nor blow but if you blow wit di song,we go join u thank God.

Monday 2 January 2017

NICE ONE BABA: DON JAZZY DON DEY FIND 120 PIPO TO GIVE WORK FOR 2017,YOUR OWN NA JUST TO SEND YOUR CERTIFICATE TO QUALIFY YOU FOR ANY OF Di POSITION


Mr Don Jazzy,don dey give pipo opotuniti to work foram as he don reliz positions wey get vacancy for Mavin Records.
Positions like bizness executives,content developers,image experts and plenti oda jobs for 120 pipo.
Nice one don baba j.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...