MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Monday 16 January 2017

ONE AMERICA DJ AND RADIO PRESENTER,J NICKS OF 'HOT 107.9FM', DON YAB NAIJA PIPO SAY,WE NOR SABi SPEAK ENGLISH


Wetin dis J nick guy smoke?
E be like say devil don use hin brain fry akara.
Can u imagine di radio DJ yarn say we nor sabi speak inglish during one joinbodi intaviu wit America base Naija miuzik group,Mingo for 107.9 Hot Fm.
By di wey sef,na our mama language?
China dey speak dia language,Japan get dia own,France nko?dem get dia own.
If nor be oyibo wey use us take shine for slave trade piriod,we for get our own too wey di world go rekognaiz.
Watch di vidio for bottom hia wey J Nicks for dey yab us...


1 comment:

  1. See Legbere wey dey claim say im sabi speak English. If im believe say im gud 4 English make im go mit British pipo wit all dose in yoyo wey im dey talk. Kpolokos Legebere DJ....Who even sabi dis guy self?...Fufu wit ogi mix 2geda

    ReplyDelete

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...