MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Sunday 31 July 2016

RASKIMONO Di KING OF ARUMBA STYLEE,DON YARN SAY,NA NONSENSE NAIJA YOUNG MIUZISHANS DEY SING


Reggae miuzik big name for naija,Raskimono don yarn say,na robish young naija miuzishans dey sing nawadays.
He say wen he don rish to sing about yansh,na dat time dem go dey do mouth like parrot.
He say none of dem dey sing about real tins again espeshali di reggae miuzishans wey sopose to even dey epp us sing to enta gofment ears.
Kimono say imagine only Buhari na president,only him na petro minista and nobodi fit sing about am.
He say di tin dey pain nam welwell.
But Kimono,you Neva retire from singing na.
If nobodi sing about am,you kuku sing about di Buhari.
We go hapi for u.

NOLLYWOOD FOOL EVRIBODiiii, AS ACTOR ANI IYOHO FIRE ACCIDENT NA FILM TRICK AFTERALL (Video)



If our gofment nor fit make me hapi since I relocate back to naija from America,finalli I don see wetin make me dey proud to come from Nigeria.
One film wey dem go soon reliz base on road safetyness to take Epp drivers dey veri kiafu for road,don alreadi make name bifor di reliz.
If I hia anybodi yarn say nollywood nor dey try again,I go fight di pesin til di pesin quench.
Ova 90% of pipo wey watch di vidio earli dis week biliv say na real.
I bin tink say na only dem James Bond sabi do beta film trick until I see wetin nollywood achiv dis week wit beta filmtrick.
Di name of di new film 'Behind the Wheels', get one part wey Fire go for burn di actor,Ani Iyoho.
But dis week,we watch di short vidio of how fire take burn di bobo skata and Tori pipo carry di news all ova di intanet say,film trick fail dem and fire burn Ani Iyoho wey dey fight to sorvive for one hospita for Lagos.
Now di prodiusas of di film don show us how dem take do di filmtrick for dis vidio wey I carry come show una.
In shot,I respect evribodi wey get hand for dis film espeshali Stanley Ohikhuare,di direktor of di film and di bobo,Ani Iyoho wey act di fire part.
Abeg join me watch di vidio for bottom hia and see naija wonda...



Saturday 30 July 2016

ACTRESS BEVERLY NAYA SAY,SHE NOR FIT FORM KILL HERSEF,SHE SAY HER BOBO MUST SABi HANDLE HER BIFOR SHE GO MARRY AM


If you nor sabi sample,my guy,nor konsida yorsef among pipo wey Berverly Naya fit marry as hosband.
Wen she folow Genevieve magazine yarn,di actress say she nor dey for forming,her bobo must sabi solve maths for bed bifor she go marry am.
Di babe say she undastand some law wey talk say make u and yor bobo nor sample unasef bifor marage but dat law nor be bicos of am.
She say if for ezampo she nor sleep wit di man bifor marage,
wot if di man ting nor dey work well or di man nor fit dey plizam for bed?
dat one nor be igbese?
She say she nor dey for dat one bicos she like man wey fit handle her from left,right and senta.
Beverly say she nor like men wit big belle like pot or man wey nor fit trit her like woman.
Also,di babe say her guy must get money so dat wen dem marry di guy nor go live all di work foram.
Many gehs dey marry money.
Dem nor Kia weda di man sabi di tin or not.
Beverly,I hope say u nor be one of dem.

Friday 29 July 2016

FORGET HOLY HOLY,I MUST DEY SURE SAY MY BOBO GOOD FOR BED BIFOR I MARRY AM-BEVERLY NAYA



If you nor sabi sample,my guy,nor konsida yorsef among pipo wey Berverly Naya fit marry as hosband.
Wen she folow Genevieve magazine yarn,di actress say she nor dey for forming,her bobo must sabi solve maths for bed bifor she go marry am.
Di babe say she undastand some law wey talk say make u and yor bobo nor sample unasef bifor marage but dat law nor be bicos of am.
She say if for ezampo she nor sleep wit di man bifor marage,
wot if di man ting nor dey work well or di man nor fit dey plizam for bed?
dat one nor be igbese?
She say she nor dey for dat one bicos she like man wey fit handle her from left,right and senta.
Beverly say she nor like men wit big belle like pot or man wey nor fit trit her like woman.
Also,di babe say her guy must get money so dat wen dem marry di guy nor go live all di work foram.
Many gehs dey marry money.
Dem nor Kia weda di man sabi di tin or not.
Beverly,I hope say u nor be one of dem.

ACTOR AND POLITICIAN,DESMOND ELLIOT DON TELL Di AREA WEY HIM REPREZENT SAY HE CANNOT GIVE DEM LIGHT BICOS HE NOR BE NEPA


Desmond Elliot,di Nollywood actor wey don also turn politishan,don yarn hin Surulere konstituency pipo wey him dey reprezent for Lagos State house of assembly say,e nor get anytime wen he take join NEPA.
Desmond bin dey reply een pipo wey dey telam make he fulfil een promise during campaign.
One of dem konplain to Desmond say dem nor dey see light for dia area.
Desmond reply yam say,nor be him go give dem light bicos him nor be NEPA but him go do hin best.
All dis politishans na di same.
Why he nor tell dem dat time wen he dey fight to enta say him nor be NEPA?
He for beta make he kuku tell di guy say,'dis light wahala tire pesin o,but hin go kontiniu to dey talk to NEPA pipo about di light.
Afta he don yarn puan finish,he kon dey say him go try him best.
As a poblik figor and pesin wey dem vote for to lead,e good make you avoid negative yarns bifor yor pipo.
Na so i siam.


Thursday 28 July 2016

FEDERA GOFMENT DON DEPORT 3 SOUTH KOREA PIPO BACK TO DIA KONTRi BICOS DEM USE FAKE PAPERS ENTA NAIJA


Shuo! See o!
Naija Gofment don dey vex too like obodo oyibo gofment as dem don dipot 3 South Korea pipo back to dia kontri sake of say dem nor use beta paper enta naija.
I bin tink say na only dem sabi send us come back from yonda wen our papers nor konplit until I hia dis Tori from our imigration officers.
Nor be only wetin appun to di three of dem be dat o.
Gofment also ban di three of dem from coming to naija for di next ten years and dis one kon make me dey wonda.
Shuo! Na so dia ofence plenti?

Wednesday 27 July 2016

BICOS HE WON POPULAR LIKE 2PAC,ONE NEW RAPPER,KASPER KNIGHT,DON SHOOT IMSEF FOR MOUTH (VIDEO)


Tori don pass be kiafu o.
Lord of Ajasa don yarnam bifor say,e nor easy to be popular.
New rappa,Kasper Knight,don shoot imsef for mouth just to be popular.
As he shoot imsef for one side of him jaw,he kon hold im jaw as blood dey pour from im mouth.
Di bobo say him nor care about anytin wey anybodi won yarn bicos naim life.
He post di vidio for Facebook and he yarn Tori pipo say,he bin wan shoot imsef for inside one miuzik vidio but no camera man agree to epp am bicos fear katch dem.
Since di vidio come out,Kasper don resiv plenti curse nor be small.
My own be say wich kain yeye gun di bobo use wey di bullet nor fit buss out from di oda side of di jaw?
Next time make he use beta bullet so dat he go dey popular welwell.
Oya klik and watch di vidio for bottom hia.....




Tuesday 26 July 2016

QUARREL SETTLE! QUARREL SETTLE! PSQUARE DON SETTLE DiA QUARREL AGAIN,WEN DiS DiA DRAMA GO STOP SEF?


E appun once dem settle,e appun di sekond time dem settle,e appun di third time,dem settle,now e don appun di fourth time,dem don settle again.
Wetin now Psquare?
If una won brake up,make una brake up,if una won kontiniu to stay as one make una stay.Shuo!
If u rememba,earlier dis month,Peter nor gree follow him broda Paul go play show for Congo afta di show promota book Psquare to pafom for di east Africa kontri.
Akordin to Peter he say,he nor like di kontract wey dem sign and as dia manager and sinior broda,Jude,naim folow dem discuss.
Now Peter don come out to say evritin naim fault.
Make dem forgivam.
We don hear.
We nor won hear any Tori again o!

Monday 25 July 2016

MOHAMMED ALi SON DON RUN LIVE HIM WIFE AND TWO SHIDREN SINCE DEM SHARE 80 MILLION DOLLARS REACH AM AFTA ALi DIE


Mohammed Ali junior,di only man out of di 9 shidren wey Mohammed Ali born,don abandon him family afta him bank account change ovanight.
Akordin to many pipo,Mohammed Ali wey be di greatest boxer of all time,die June 3 dis year.
He die live plenti money and propati for hin 8 daughtas and one son.
Afta dem share di money,80 million dollars naim rish Mohammed Ali Jr.
Since he kolet di money,di bobo don run live him wife and daughtas go flex alone.
He don even come out yarn say,Mohammed Ali nor take kia of am wen he small,so now wey money don rish een hand,make he enjoy imsef.
Tori wey even rish our backyard be say,di guy won pack go xpensiv area go fil funky.
Na wa o!
E be like say dem plant bomb for some pipo head o.
So bicos money don rish him hand,naim kon make am abandon hin own famili.
Wetin dey wrong if he groove di money wit him family wey don dey sofa witam since?
Mumu man.

Sunday 24 July 2016

FRESH ORORO FOR RONALDO POT AGAIN AS Di PRESIDO OF MADEiRA,PORTUGAL,DON NAME DiA AIRPORT AS 'CRISTIANO RONALDO AIRPORT'


Since Portugal win di Euro 2016 Cup,dia kaptain,Cristiano Ronaldo,don dey get plenti rekognishon.
Di bigest one be say,di airport of Madeira don get new name and di new name na "Cristiano Ronaldo Airport".
See levels.
Di Presido of Madeira for inside Portugal,Miquel Albuquerque,naim yarn Tori pipo dis one.
Madeira na di town wey Cr7 come from and dem use dis one take rekognaiz am as he don put di city name for world map thru futbol.
Some days ago,Ronaldo open one five star hotel for Madeira wey get style like mad.
See life.

ZAHRA BUHARI SAY ADEKUNLE GOLD 'WORK' SWEET LIKE HONEY


E be say God rili hear Adekunle Gold begment for dat 'pick up' song wia di bobo dey beg Baba God make He pick hin call.
Na God o.
Wetin pesin won yarn again wen president dota don alreadi dey talk gud about you?
Wen president dota endorse yor album,dat na one million copy extra
Zahra,president Buhari dota,talk for twita say,she don taste Adekunle Gold new album wey di bobo go reliz next week.
I hope say na only di miuzik dis babe don taste sha.
I don dey mad o! Wetin konsign me na?
Taste anytin u like Zahra,sofa e swit.
If you like Taste track 1,track 2,even track 10 sef,wetin swit don swit.
Dem say dem nor dey spit honey wey don touch tongue troway.
If you dey folow up,you go notice say some months ago,Nigeria Sickle Cell Foundation,chooz Zahra and Adekunle Gold as dia pasona pesins wey go dey reprezent dia intrest.
Di title of dis Adekunle Gold album na,'GOLD'.


Saturday 23 July 2016

CHOi! ADELE KISS ONE NAIJA BOBO FOR STAGE FOR CANADA


O boy,
I nor know say pesin fit selibrate like say he win jackpot just bicos Adele kissam.
Dat na di stori of one bobo wey attend di show of big name and supastar singa,Adele for Vancouver,Canada.
Di way wey di guy take hapi shock me sha.
He own na small.
Many pipo go roll bodi for ground if Adele kiss dem.
I nor dey among.
Klik and watch di vidio for bottom hia...


SHOW PROMOTERS BEWARE BICOS DEM DON CATCH ONE 'FAKE ADEKUNLE GOLD' FOR LAGOS NITE KLUB


Pipo get heart o!
Say bicos u rezembo pesin,you go enta town dey claim to be di pesin?
One bobo wey dey claim to be Adekunle Gold get luck as police for use am to chop if nor be say pipo wey katcham for Surulere later free am.
Di fake Adekunle Gold dey waka from club to club dey form supastar for Surulere.
Gehs dey gadaram,he dey shack henessy wit cold ice.
Na one fan wey notice say na fake,phone one popular show promota,Kogbagidi say fake Adekunle Gold dey club dey flex.
Di bobo start to misyarn as dem use brain dey askam some kain queshons wey konsign Adekunle Gold and Ybnl.
Wen di guy see say yawa don gas,he kon dey beg for him life.
As dem manage free am,di race wey di bobo take comot for di klub go fear even Ben Johnson.

Friday 22 July 2016

FROM ATUTUPOYOYO TO BEYONCÈ: MAKE UP ARTIST,I HAIL UNA


Make up artist fit paint vegetable leaf to money and u nor go know.
Base on say u nor know,u go won spend di money.
Na wen u don enta police wahala,bifor yor eye go clear say di money na kantafit.
Make up magishans,I hail una.
See as dem turn dis babe for dis pishor to veri biurifu babe.
Dem finish work.
But my advice to you,na make u stop to toast babe for nite o,
if not,u go marry atutupoyoyo for house.
Make una live all di atutupoyoyo for me,I love dem.

YES O! FEDERA GOFMENT DON FIX TRAIN TRANSPORT FROM ABUJA TO KADUNA FOR N500


Di minista of transportation,Mr Rotimi Amaechi don yarn say Federa gofment don fix di money wey we go dey pay from Abuja to Kaduna for di new railway lines for N500 naira.
He yarn Tori pipo for Abuja say president Buhari go komishon di project next week.
Amaechi also yarn say na four weeks dem plan to test di railway but Dem livam reachsix weeks to dey veri sure say di tin dey work well.

YES O! FEDERA GOFMENT DON FIX TRAIN TRANSPORT FROM ABUJA TO KADUNA FOR N500


Di minista of transportation,Mr Rotimi Amaechi don yarn say Federa gofment don fix di money wey we go dey pay from Abuja to Kaduna for di new railway lines for N500 naira.
He yarn Tori pipo for Abuja say president Buhari go komishon di project next week.
Amaechi also yarn say na four weeks dem plan to test di railway but Dem livam reachsix weeks to dey veri sure say di tin dey work well.

Thursday 21 July 2016

YOU DON TIRE TO BLEACH? DIS NA Di QUESTION WEY FANS DEY ASK SEAN TIZZLE AFTA HIM SKIN DON DEY RETURN BACK TO BLACK


Whoeva advice Sean Tizzle to stop to bleach him yansh and oda part of hin bodi,di pesin try welwell.
For sometime now,di Sholee singa,kon dey yellow evri singo day like rotten pawpaw.
E fit be say di curse wey di bobo dey resiv on top Instagram,naim make am stop to bleach.
Sean Tizzle post some pishors for Instagram some days.
Pipo nor letam rest and some bigin say na Vaseline he dey use now bicos pepper nor rest again.
Dis Buhari regime nor izi for anybodi and di tin also affect blichas.


Wednesday 20 July 2016

DAVIDO PAPA NA CORRECT MAN AS HE GIVE SCHOLARSHIP TO OVER 100 STUDENTS FOR ADELEKE UNiVASiTi FOR OSUN STATE


Di owna of Adeleke Univasiti,Chief Adedeji Adeleke,wey also be Davido papa,give skolaship to ova 100 students out of di ova 200 wey graduate.
Na Davido himsef yarn us dis one on top Instagram  as he praiz hin palleh for di gud tins wey he dey do.
He also pray make Baba God bless hin popsie for all of dem.
Nice one sir.

Tuesday 19 July 2016

BISHOP OYEDEPO SAY,WETIN MAKE POVERTY DEY TAKE BLACK MEN DO YEYE NA BICOS DEM NOR SABi USE DIA BRAIN


Founder and chancellor of Landmark univasiti,Omu Aran,Kwara state,Bishop Oyedepo,don yarn say,wetin make poverty dey show blackmen shege,na bicos blackmen nor dey gree use dia brain.
He yarn dis one during di convocation serimoni of di skul for Omuaran last wikend.
Di bishop yarn say wetin we Africans need to make life beta na to use local solutions.
He say we must tink big and we must take farming veri sirios if we won tell povati bye bye.

CHINEKE! CHECK OUT Di PAM SLIPPERS WEY MERCY AIGBE DEY SELL FOR N35,000


O boy,tori don land o.
No mata yor work,e stil nice make u get side bizness wey go dey giv u 'top up' join yor osusu.
Dat kain spirit naim nollywood actress Mearcy Aigbe get,wey make her enta Pam slippers bizness.
Now di biurifu babe don carry her pam put for Instagram showglass make pipo for siam buy and some of her fans tire for di slippers price espeshali wen Aba made chip wella.
Mercy peg di price for 35K and one fan vex beta vex for di price like kilode.
Di bobo say 35k ke!
Wen wit 6k5 or 7k5 he don arrange beta pam.
Mercy Aigbe nor find am funny as he face di guy one time.
She say make di guy cut him coat akordin to him size bicos di pam nor be for evribodi,and if di bobo dey find chip pam of N500,make he go Yaba or Oshodi.
Hmm,dat pam for 35k sha,nor be here o.
I nor fit riskam o.

Monday 18 July 2016

YEMI ALADE DON YARN US SAY,NA SHE GET HER LIFE AND E NOR CONCERN ANYBODi IF SHE DEY FREND HER MANAGER


Wen u be public pesin,dem go always put eye for yor life.
Pipo go won know di kain shoes wey u dey wear,di kain soup wey u dey like,di kain salon wia u for dey cut or make yor hair.
Dem go even wan know di kain toilet wey dey use.weda na shalanga or WC.
For sometime now,Tori pipo don put eye for Yemi Alade bodi to know who be her bobos bicos dem neva fit undastand her love life.
But di rumors wey dey fly pass our ears be say,she dey frend her manager ,Taye Aliyu.
Taye naim also be di CEO of Efizzy Miuzik Group and Yemi Alade dey unda dis group.
Wen Tori pipo ask her say weda na true,she giv dem one konikoni ansa.
She turn her ansa to queshon.
She say,man managers nor be human being?
She also yarn say if her manager na woman bifor,who go ask her dis queshon?
Aftaraw,Madonna frend her fitness trainer,Kim kardashian sef run shows wit her bodyguard.
Yemi Alade nor mind dem,do anytin you like wit yor life.
Aftaraw na dem naim talk say love is blind.

MAMACITA:WIZKID BABY MAMA DON SEND 'HOT LEGS' MESSAGE TO WIZZY


Baby mamarizim favor some gehs,why e nor favor some.
But e be like say e favor Sola Ogudugu,Wizkid baby mama.
Di babe always dey shine and dis time around she don nod one sexy polo wey show her sexy legs.
Togeda wit dia pikin,Boluwatife,she post di pishor on top Instagram.
Weda she won use di pishor oppress di street or na Wizkid she use di pishor send mesage to,we go soon find out.
But I know say Wizzy go alla shuo,wen he see hin forma lova for dis foto.
Di last time wen I check Wizkid nor blind.

Sunday 17 July 2016

WICH KAIN CALL UGANDA PRESIDENT SIDDON DEY MAKE FOR EXPRESS ROAD?


Yoweri Museveni,di Uganda long throat president wey don dey rule for ova 29 years,stop for express road kon dey make 30 minutes call akordin to him press seketri for Facebook.
Di president escort,block di road and dem even carry chair givam make he sidon dey make call.
Nor be say na cripple.
He dey carry chair folow bodi?
I nor know why Africa lidas dey like to show dem sef.
How dis one wey he dey do for road take join for good life wey di Uganda pipo say make he giv dem?
Small time now,na kpomo he go dey go cut for market like Fayose.
E be like say Fayose don sell efizzi give dis president wey won rule Uganda for 100 years.
Now diferen pipo don dey mockam wit dia own pishors.
Yeye dey smell.
See some of di pishors wey pipo fotoshop for botom Hia...







OSHIOMOLE DAUGHTA DON BEG PIPO MAKE DEM LIVE HER PAPA ALONE MAKE HE ENJOY Di MARRAGE TO HIM NEW 25 YEARS OLD WIFE


Since Edo state gofnor,Adams Oshiomole marry dat yellow 25 years old sisi from Eritrea,Lara Forte,many pipo don blastam and many stil soportam.
Now Oshiomole dota,Winifred Isimakhome Oshiomole,don beg naija pipo make dem allow her papa enjoy di marage.
She say many pipo just dey yarn opata about her papa afta di marage.
Winifred say she nor blame dem sha bicos dem nor know half of di stori.
She say since her papa don gada heart to move on afta her mama die,make dem livam alone.
Although no famili memba dey prezent for di marage.
She say she dey busy naim make her no attend but she nor fit speak for di rest pipo on why dem nor attend.
Buhari and hin frends attend di marage.
Me and my frends also attend make e for nor loss.

ONE JOINBODI SIDON OF WEN PATO RANKING AND TIMI DAKOLO DEY SING 'ONLY JESUS CAN SAVE',DON SHOW FACE FOR INTANET


Dis guys must dey in high spirit as dem enta dat ginga mood.
Pato Ranking and Timi Dakolo and some oda pipo,giv respet to di son of God,Jesu Kristi as dem bigin sing "only Jesus can save" for one joinbodi sidon.
Guys,abeg make una join me Watcham for botom Hia..


Saturday 16 July 2016

RITA DOMINIC DON YARN SAY,YOR RICHNESS NA FOR YOR POCKET BICOS HER LOVE NOR BE FOR SALE


Nollywood big name Rita Dominic, don yarn 'Hollywood London Magazin' say,she nor kia about any man money bicos she get her own.
She say she nor go bicos of any man richness put bodi for ground bicos her love nor be money for hand back for ground but true love.
She yarn say if yor pocket full dey troway sef,nor be bicos of am.
Akordin to Rita wey selibrate her 41 years betday some days ago,she say,she go only folow man bicos of love not bicos of di richness wey di man don gada.
Veri gud Rita.
I get one koret mesage for you.
Asosiashon of jobless youths say make I ask you weda you go gree marry dem even as dia pocket dey leak?
Dem say make I hep dem somit dia aplicashon.
No shishi,dem nor get shingbain,but dem sabi love pass Ramsey Noah.
U fit marry any of dem?
Dem dey wait for yor ansa.
Tank you.

Friday 15 July 2016

MY PAPA GET SKILLS PASS OKOCHA--NA SO ANDRE AYEW OF GHANA TALK


Black stars of Ghana and Swansea of England playa,Andre Ayew,don yarn tori  pipo say,Jay Jay Okocha skills dey learn for wia hin papa skills dey.
Hin papa,Abedi Pele wey win di Africa Cup of Nations wit Ghana for 1982 and also win Champions league wit Olympic Marseille,na one of di best playas from Africa.
Now Ayew don come out to yarn say,Abedi get evritin pass Okocha and he dey more tactika and more skillful pass Okocha.
Although he say,e pain am say Jay Jay nor eva win di Africa futbola of Fire year award bifor he retire.
Even for Ghana,if dem vote for playa wey get skills pass for di world,Okocha go carry first.
Abedi Pele name nor go dey top five hundred.
Abi na back of TV Andre Ayew dey watch?
Abi nobodi don yarnam wetin world best playas and coaches like Arsene Wenger,Samuel Eto,Roger Milla,di real Pele of Brazil don yarn about Jay Jay?
Playa wey introduce hin own Motorola skill enta futbol!
If nor be say na one tin one tin,I for say na raw ogogoro wey Andre Ayew shack,naim dey givam eye ploblem.
Abeg Andre,try watch one of 'skills papa' vidio for bottom hia witout raw ogogoro for yor mouth.
Oya klikam....



Thursday 14 July 2016

NOLLYWOOD STAR,MERCY AIGBE SAY,SHE DEY WEAR BUM SHORT MAKE ALL DIS TOOTHPICK LEG GIRLS NOR GO SNATCH HER HUSBAND


Dem say yor own na yor own o.
Anytin wey u go do to take protect yor own,nor waste time to do am.
Nollywood actress,Mercy Aigbe don yarn Tori pipo say,she dey wear bum short take denge for her hosband front make all dose toothpick leg gehs nor go snatch her hosband fromam.
Mercy Aigbe nor want any drama for her marage to avoid storis dat touch.
Mercy Aigbe make I giv you one advice.
Na now u goer buy more sexy bum shorts.
Yes o,diferen diferen wicked wicked bum shorts bicos,all dis gehs go won show u say yor bum short nor rish.
Dem go won use monkey sense take tempt yor hosband just like devil try evritin to tempt Jesus.
Now wey dem don know yor game plan,na for you to shine yor eyes welwel.


Wednesday 13 July 2016

ORITSEFEMI DON USE GOD TAKE BEG NAIJA BOYS MAKE DEM ALLOW HIN DAUGHTA FINISH SECONDARY SCHOOL


Di double wahala singa,Oritsefemi,don dey beg all of una wey una eyes dey shook steadi say,her dota  go start secondary school anytime from now but make una allowram finish di skul jejeje.
Di bobo even dey beg say make dem forgivam for all di kukere waka wey hin waka.
All wetin he use Ajegunle gehs eyes take see dat time,he nor want make dem do am to hin dota.
Oritsefemi,e nor dey work like dat.
You get fast for 40 days and 40 nights.
Oritsefemi get two dotas wit een baby mama and na evriday hin forma babe dey swear foram bicos he brake her heart.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...