MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Friday 1 July 2016

TIMAYA: Di INDIA BOY AND EGBERIPAPA ONE OF BAYELSA



Di Egberipapa 1 of Bayelsa don plasta di area again dis time around ina India stylee.
He put di pichors for Instagram of wia he nack India clothes and di tin nor bad at all for een bodi.
My only only fear na make dis India gehs nor go vex play enta naija come pay Timaya dowry since na babes dey pay dowry for yonda akordin to dia korchor.
Dose babes can trace anybodi enta naija.
We even hia say na dem carry apple from di kontri of Mahatma Gandhi come giv our forma president.
We also hia say dem ovafidam wit di apple naim make am kpai but Timaya sopose know apple wey dem poison if he see one.
Anyway make we dey watch weda we go see dis India tins for hin next Vidio sha.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...