MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Saturday 2 July 2016

KANYE WEST WIFE,KIM KARDASHIAN,DON YARN SAY,ANYBODi WEY SAY HER BIG BAKASSi NA FAKE,DEY LIE


Of resent,pipo don akiuz star geh Kim Kardashian say,she dey wear yansh pad just to make her bakassi shoot out.
Dem say di way wey di bakassi be from back wen she attend her sista,Khloe betday for Los Angeles dis week,be like wetin dem load pillow put.
Kim hersef don come out yarn on top her website say,dat na big lie.
She say evribodi don see her yansh welwell for magazines bicos she dey always naked.
Di motha of two say she nor dey wear sholda pad or pillow to make her yansh big.
Na wa o,wetin pesin nor go hia?
Na all dis robish some of our gehs dey copy nawadays bicos dem wan make dia bombom shoot out.
Altho she say her own ikebe na nachora make anybodi nor argiuram.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...