MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Wednesday 13 July 2016

WONDAMENT AS ONE BABE FOR INSTAGRAM DEY BEG JIM IYKE SAY MAKE DEM DO DAT TIN JUST ONCE


Na wa for wire road o.
Intanet don dey make many pipo dey mad o.
One babe wey her name na Chichi for Abuja nor even kia weda pipo go read wetin she rite as she dey beg Jim Iyke make di bobo kon test her somtin.
Akordin to di babe she say make dem do am only once so dat she go fit comot Jim Iyke mata from her head.
Jim Iyke,in case u finalli dab di babe,abeg let us know weda fried rice and ketch up dey inside her own.
Robish?
Our gehs nor get shame again o!
Wot if her boyfrend ridam or her papa dey stroll pass Instagram?
If I hear God wan destroy di world,if I begam,make I die.
Yeye dey smell!

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...