MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Friday 8 July 2016

GANGNAM STYLE SINGA,PSY,DON YARN SAY WEDA RAIN DEY FALL OR SUN DEY SHINE,NA ALCOHOL BE HIN BEST FREND


YouTube record breaka,Psy,wey sing dat ogbonge song,gangnam style,don yarn tori pipo say,na alkohol naim be hin best frend.
He say weda him dey hapi or sad,him must shack akohol.
He say if rain dey fall or sun dey shine,if di weda hot or di weda cold,na akohol naim getam.
Di Korea bobo say na Korea vodka be hin best frend.
He say him dey drink evritin drinkable too.
Weda na whisky,weda na pami,weda na ogogoro,weda na tequila,him redi for all of dem.
Sometimes on top stage wen he dey pafom,Psy dey pound like five bottles of akohol.
Psy say di only time wey him nor dey drink na wen he get hang ova.
O boy,dis wan don pass be kiafu o!
Plenti dimons don hold meeting for dis one head.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...