MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Friday 31 August 2018

DAVIDO TWO BABY MAMAS,SOPHIA AND AMANDA WIT DIA CHILDREN, ON SPEND QUALITY TIME TOGEDA


Nothing money no fit do as Davido baby mamas,Sophie and Amanda plus dia daughtas don spend correct time togeda.
Imade na Sophie pikin why Hailey na Amanda pikin.

Thursday 30 August 2018

POPULAR INTERNATIONAL ACTOR EDDIE MURPHY, DON DEY EXPECT PIKIN NUMBER 10 FROM HIM PREGNANT GIRLFRIEND,PAIGE BUTCHER



Eddie Murphy, di popula America actor,don kack dey wait  for him pikin nomba 10 from him pregnant girlfriend Paige Butcher wey also be film actor.
Dis go be Paige second pikin for Eddie Murphy afta dem born dia first pikin togeda for 2016.
Di remaining eight shidren na from different women.

Tuesday 28 August 2018

FEMI OTEDOLA PIKIN,DJ CUPPY DON YARN SAY,SHE DON FOLLOW MEN OF DIFFEREN DIFFERENT COLOURS AROUND Di WORLD EXCEPT MEN FROM JAPAN,CHINA AND OTHER ASIA COUNTRIES


Billionaire oil man Femi Otedola daughter DJ Cuppy,one of di few female DJs wey dey do well for di DJ bizness don yarn say,she don follow diferen diferen men wit differen colours all over di world. Akordin to her,na only men from Asia kontris like Korea,China, Japan,she neva frend. Na wa o,see achievement.

FEMI OTEDOLA PIKIN, DJ CUPPY DON YARN SAY,SHE DON FOLLOW MEN OF DIFFERENT DIFFERENT COLOURS AROUND Di WORLD EXCEPT MEN FROM JAPAN,CHINA AND OTHER ASIA COUNTRIES


 Billionaire oil man Femi Otedola daughter DJ Cuppy,one of di few female DJs wey dey do well for di DJ bizness don yarn say,she don follow diferen diferen men wit differen colours all over di world.
Akordin to her,na only men from Asia kontris like Korea,China, Japan,she neva frend.
Na wa o,see achievement.

Monday 27 August 2018

TIWA SAVAGE DON CRY OUT SAY, TO DEY FIGHT TO SURVIVE AS A WOMAN DON TIRE HER AND E JUST BE LIKE SAY TO BE WOMAN FOR AFRICA, NA SIN



Abeg,make Tiwa Savage family and friends wey dey close to her like Wizkid,put one eye for di girl bodi make she no go drink poison.
Di way wey di babe take yarn about her life on top Instagram dey make me fear.
She say,she feel like giving up,she don tire to dey hustle,she tire to dey fight to survive like say she be man,she don tire to dey prove herself and di whole tin kon be like say na sin to be woman for Africa.
Tiwa abeg take am easy.
Na so life be.
Some women and even men dey pray to rish di level wey you dey.

Saturday 25 August 2018

MALCOLM OLANREWAJU, THE BABY DADDY OF 2017 BIG BRODA NAIJA STAR 'BISOLA', DON DIE AT THE AGE OF 37



Death like dem talk am na di most painful and useless thing for di world as e don take Malcolm Olanrewaju di baby dadi to big broda naija star,Bisola.
Malcolm die around 8pm August 24 for Model Specialist Hospital Surulere,Lagos akordin to him younga broda.
He die of one sickness wey don dey worry am for some time now at di age of 37.
Malcolm and Bisola born one girl pikin togeda and her name na Laila.
May his soul Rest in Peace.

Friday 24 August 2018

GHANA ACTRESS 'MOESHA BODOUNG' DON YARN SAY SHE NO FIT FOLLOW BOY WEY POOR AND BOY WEY NO GET CAR FOR HER LIFE AGAIN


Ghana film actress Moesha Bodoung don yarn tori pipo say,she suffer for her first boyfriend hand as di guy break her heart even tho di bobo poor like church rat.
 She day upon say she dey struggle and manage wit fi guy,di guy still daisapoint her and na dis one make her say she no go eva follow boy wey no getmoney again or boy wey no get car.
She say di boy must get at list corolla or Hyundai if he want her.

Thursday 23 August 2018

AFTA TORi COME OUT SAY DUNCAN MIGHTY BEAT HIM WIFE BADLY,ANODA TORi DON COME OUT SAY,HE GIVE ONE 'VIDEO DIRECTOR' DIRTY SLAP FOR PORT HARCOURT LAST WEEK



Godman Onyeso,Port Harcourt base video direktor don yarn on top twita say,Duncan Mighty givam one dirty slap wey make am see plenty stars.
Akordin to di guy ,he say him go beg for him boy camera wey Duncan Mighty seize and bifor him go say,'cameraman is a boy' Duncan Mighty don givam hot slap.
Dis one appun last week for Port Harcourt wen Duncan and Davido dey shoot miuzik video for PH.
If you dey follow up,you go don see di foto of him wife wit her eye wey dem give upper cut blow and dem say na Duncan Mighty handwork.

Wednesday 22 August 2018

AFTA DEM INKRiZ PAYMENT OF DSTV MONEY,Di FEDERAL HIGH COURT FOR ABUJA DON TELL DSTV OWNERS MULTICHOICE SAY, MAKE DEM STOP Di INKRiMENT


Di Abuja division of di Federa High Court don stop Multichoice from inkrizing DSTV payment.
Dem resentli di price and for di first time,court fight for di customersas dem don alreadi start to pay.
Justice Nnamdi Dimgba naim pass di judgement on Monday for di Federal High Court Abuja.
Make we dey watch and see weda dem go break court order.

Tuesday 21 August 2018

TIWA SAVAGE DON YARN SAY,FOR INSIDE STUDIO,DUNCAN MIGHTY DEY WORK HARD LIKE WHO NEVA BLOW AT ALL BUT MEANWHILE,Di GUY DON BLOW SINCE


Duncan Mighty wey sombodi say na wife beater and him nearly beat him wife die some days ago,don get high star praises from Tiwa Savage.
Akordin to Tiwa wey just reliz song wit Duncan Mighty she say,di bobo dey work like Jackie if he dey studio.
She also yarn say Duncan dey sing and work hard like pesin wey dey try to blow even tho him na big name alreadi.

Sunday 19 August 2018

NOLLYWOOD FILM ACTRESS 'LIZ ANJORIN' DON YARN SAY,ANYWIA WOMEN GADA,PROBLEM MUST DEY THERE


Nollywood babe Liz Anjorin don yarn tori pipo say,anywia women gada,evil must show face.
She yarn dis one wen on top the small intaviu wey she do wit Sunday Scoop as she talk say,women and wahala be like five and six.

Saturday 18 August 2018

SAM LOCO PIKIN 'OMORUYI' DON YARN SAY,NOBODY FIT TELL HIM PAPA TO STOP SMOKING WEN HE DEY ALIVE BICOS HE DEY QUICK PARA FOR DAT KAiN ADVICE


If you be nollywood fan,you go know say Sam Loco na one of di most funniest and di most goodest actor wey Nigeria don eva get.
One habit wey di guy no fit leave na cigar smoking.
Di guy dey blow cigarette like referee wey dey blow whistle for a living.
But him pikin Omoruyi,don come out to yarn say,fear no let any of dem tell him papa to stop smoking base on di way wey him tempa be.He fit para like mad for you.
Sam Loco die for 2011 and him death send cold enta di film industri bodi.

Friday 17 August 2018

MANY NIGERIANS DON BLAST DUNCAN MIGHTY SAY HE FALL DiA HAND AFTA Di VIDEO OF WEN HIM BOW DOWN TO GREET DAVIDO COME OUT



No be small blast Nigerians don dey blast Duncan Mighty afta di bobo bow down for Davido for di new video wey don full evriwia.
He see Davido as a biga miuzishan,di only reason wey make am prostrate foram be dat but many pipo dey vex for di Port Harcourt first son say na falling hand bicos he sinior Davido wit almost ten years.
No be only dat one o,he also first Davido dey serve Naija pipo koret jam.
Inshot,wen pipo dey enjoy Duncan Mighty jams,Davido still dey primary school and dis one sef dey among wetin make pipo dey para like paracetamol.
Well,Nigerians make una take am easy on Duncan,he go learn him lesson.

WHY NIGERIANS LAMBASTED DUNCAN MIGHTY AFTER PROSTRATING FOR DAVIDO



Rave of the moment Duncan Mighty,has received knocks from many Nigerians after a video of him prostrating for Davido surfaced online. Some say the video only displayed humility on the part of the Port Harcourt first son while others say prostrating for a kid you're way older than and even started making hits before he ever dreamt of joining the fray,is uncalled for. His career got resuscitated after the collaboration with Wizkid on unarguably one of the biggest song in Africa right now 'Fake Love'. It would have been understood and wouldn't have generated much furore if Wizkid was the one he prostrated for. Hope Nigerians won't wake up to see a video of him kissing Tiwa Savage's shoe after the diva featured him on her recently released single Lova Lova. Duncan Mighty,Davido,Wizkid are legends in their own right but we should learn how to contain excitement sometimes so we don't become subject of ridicule.

Thursday 16 August 2018

FOR SOYOYE,ABEOKUTA NORTH OGUN STATE,POLICE DON ARREST LANDLORD WEY JOIN ARM ROBBERS GO ROB ANODA LANDLORD FOR HIM AREA


40 years old Adegbite Taoheed wey be landlord, don lead oda fellow arm robbers go rob anoda landlord for him area for Soyoye,Abeokuta North council for Ogun state.
Di good ting about di mata be say,police don arrest him and him gang.
Dis Taoheed as we take resiv di tori,na memba of di Association of Landlords for Oke Odo,Ogun state.
Na wa o,dis guy own pass who winsh dey worry.

Wednesday 15 August 2018

IF YOU GET PLAN TO TRAVEL GO SUDAN AND YOU BE BREAD LOVER,SORRY BICOS BREAD DON SCARCE FOR DAT KONTRi


E don red for Sudan o!
Flour and wheat and evritin wey concern bread don dey cost.
Akordin to di tori,pipo dey queue like mad for bakeries sake of di skasiti.
Di reason wey we hear na bicos of dollar and other foreign money crisis.

Tuesday 14 August 2018

FRIENDSHIP CONTINUE AS PRESIDENT BUHARI STILL CHOOSE OSINBAJO TO BE HIM ASSiSTANT PRESIDO AND NUMBER TWO MAN FOR THE 2019 ELECTIONS


Di Sinior Spesha Assistant to President Buhari on top midia and publisiti mata,Garba Shehu don yarn tori pipo say,Yemi Osinbajo naim go still be Buhari nomba two man for di 2019 President election.
He yarn dis one wen he dey ansa queshons from tori pipo for Abuja.
He say di way wey APC take clear di bye elections wey dem just do for Bauchi,Katsina and Kogi state show say,evritin still dey work well for APC and no need to change di winning team.

Sunday 12 August 2018

SUPASTAR GOSPEL MUSIC SINGER 'SINACH' DON YARN SAY,SHE NO GO VEX EVEN IF DJs DEM DEY PLAY HER MUSIC FOR INSIDE NIGHT CLUBS


Sinach,one of di biggest gospel music singa, don yarn tori pipo say,she no mind if night club DJs dey blast her songs for clubs.
She yarn tori pipo dis one as she say, her friend send her one video of pipo wey dey sing follow her jam for club.
She say if you sing beta song pipo go look for di song bicos evribodi weda na club you dey or not,need inspiration,love and enkoragement.

Friday 10 August 2018

LAGOS STATE GOFMENT DON SCATA 9 STOREY BUILDING FOR OSAPA,LEKKI BICOS Di CONTRACTOR NO FOLLOW Di PLAN OF Di AREA


Lagos state gofment don start to skata di 9 storey building for Osapa London for Lekki area on Thursday.
Dem go take dia time skataram till e go reach ground kpatakpata.
Di reason be say dem no follow di master plan of di area.
Dada Fayemi naim be di name of di street.

Thursday 9 August 2018

GOD DON ANSWER Di PRAYERS OF 13 YEARS RAPPER,'MEGABYTE' AS BILIONAIRE OIL BOY 'FEMI OTEDOLA' DON PROMISE TO TAKE CARE OF Di RAPPER SECONDARY AND UNiVASiTi EDUCATION



Wen God don sign am say e go be,nobodi fit change am.
13 year old young rapper 'Megabyte' don get betament from Femi Otedola as di billionaire don promise to take kia of him sekondri and univasiti education.
He yarn dis one wen Megabyte visitam for him house.
If you dey follow up,Megabyte na one smallie wey don dey scata di intanet wit him rapping skills espeshali him free styling rap skills.

Tuesday 7 August 2018

GOOD NEWS: TANZANIA DON APPOINT FORMA SUPER EAGLES AND AFRICA FOOTBALLER OF THE YEAR 'EMMANUEL AMUNIKE' AS DiA NEW COACH


Nigeria football don resiv boost up afta di Tanzania football association appoint our own Emmanuel Amunike as dia new coach.
Di forma Africa footballer of di year go try re-arrange Tanzania soccer afta dia school boy football dey make dia oga dem dey vex for yonda.
Amunike go try to see weda him fit qualify dem for di 2019 nations cup since dem don alreadi start veri bad as dem dey di number three position for dia group.

Monday 6 August 2018

SKALES DON TELL TORi PIPO SAY,WEN HIM NO GET HOUSE TO SLEEP AFTA HE LEAVE BANKY W,NA TIMAYA AND OLAMIDE NAiM COMOT AM FOR SUFFER


Skales,forma boy for Banky W record label EME Records,don yarn tori pipo say,him suffer no be small.
Afta he live Banky he say him no go anywia to stay again until Timaya givam house to stay.

Sunday 5 August 2018

THE QUARREL BiTWiN HARRYSONG AND KISS DANIEL DON DEY TIE WRAPPER AS HARRYSONG DON TELAM MAKE HE KIP KWAYET AND GROW UP


Since di reliz of Harrysong new song 'Selense' wey him feature Reekado Banks and Kiss Daniel nor be small tin don follow.
Di quarel start afta tori boss out say,Kiss Daniel dey vex say him no won get anytin to do wit Reekado for di same song.
Di same Daniel camp don yarn say kwanta no dey bitwin him and Reekado say evritin dey fine.
Now Harrysong don come out to tell Kiss Daniel to shut up and grow up say na lie he dey lie.
Harry say as young as Kiss Daniel be,he don carry pride for bodi for dis age.
E for beta make he kip kwayet and grow up.

Saturday 4 August 2018

YORUBA FILM PRODUCER DEBBIE SHOKOYA DON TELL TORi PIPO SAY,SHE HATE MAN WEY DEY WEAR Di SAME BOXERS FOR TWO DAYS


Guys,Yoruba movie producer and actress, Debbie Shokoya,don call una out o.
She say di kain man wey she hate na man wey dey repeat boxers.
She say you sopose wear diferen boxers different days for your own good bicos afta dat day di boxers go don dirty and for you to carry am wear di next day just be like say you be madman.

Friday 3 August 2018

NOLLYWOOD ACTRESS CHIKA IKE,DON YARN SAY,TOGEDA WIT HER FORMA HUSBAND,SHE ALSO GET SOME PART OF Di BLAME FOR Di COLLAPSE OF DiA MARRIAGE FOR 2013


E no easy for pipo to take blame for di kolaps of dia marriage but for di new book wey nollywood actress Chika Ike write,she yarn say,she get some blame too for her marriage to Mr Eberibi wey skata for 2013.
She yarn all dis one for her book "Boss You' wey she write and many pipo don praise her say she try to come out to yarn clean like dis.

Wednesday 1 August 2018

KWARA STATE HOUSE OF ASSEMBLY SPEAKER, DR. ALI AHMAD WEY JUST RUN GO BACK TO PDP DON YARN SAY,HIM REGRET SAY HIM EVER JOIN APC


Kwara state house of assembly speaker Dr. Ali Ahmad don yarn say him regret say him eva join APC.
Dr Ali plus twenty two other house of assembly membas don  run go back to PDP.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...