MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Wednesday 30 September 2015

KOREDE BELLO DON YARN SAY NA ''ASA '' MIUZIK BE DI FIRST CD WEY HIM BUY WIT HIM MONEY

Don Jazzy student and Godwin singa,Korede Bello,don talk say di fest time wey him eva dip hand enta pocket to buy cd na,wen he buy Asa miuzik.
Some years afta,di same Korede,don fichor Asa for him new miuzik wey him call,"somebody great".
He say he rememba in dose days wit him frends,wen dem go listin to Don Jazzy beat and Dem go conclude say na Jazzy na one of Africa best produsa.
Korede say,since dis two pipo wey him dey respet welwell dat year,kon diside to join head togeda to joinam sing him new miuzik,naim be say he dey di right line to bicom somebodi great by God's great.

JIM IYKE DEY CHOP ROASTED CORN LIKE MAD FOR HOLLAND (photo)

Anytin can appun like dem talkam.
E go shock wen u hia say dem dey sell akara for one dip Germany vilage.
Na dia u go fear fear.
Ok wetin you go yarn about dis nollywood actor Jim Iyke,wey dey wipe roasted corn like say tomorrow no dey for Holland?
Check out di pishor for yorsef:


Monday 28 September 2015

YAGA !!! DEM DON RELEASE AMERICAN RAPPA,DMX FROM PRISON BUT.....

Dmx sopose serve 6months for jail bicos he no dey arrange money for im baby mama to take kia of dia pikin.
For inside dis six months,he serve only two months bifor dem reliz am.
Court ansa im prayers as he file for reliz thru him lawyer as he tell dem say na yeye arrest police arrestam bicos nobodi telam say he dey owe di baby mama any money.
Dem bin sendam go jail for July and afta two months he don regain freedom.
Dmx lawyer Dominic Candino welcomam from jail but sha o,dem fit still send di bobo go jail back if court find out say he know about di money problem but he choose not to pay.

KAi!!! NAIJA SOLDIERS DON CUT BOKO HARAM MEMBA HEAD COMMOT(WARNING! DIS PICTURE NO GOOD TO LOOK)

Somebodi naim put dis pishor for facebook yestaday and he say he getam from him soja frend wey dey among sojas wey dey fight Boko haram for north.
I nor know wetin dis Boko haram fighta do wey vex catch Naija sojas like dis,sotey dem remove di bobo head veri pafect like say tailor naim do di measurement.
Who know,he fit don do dia fellow sojaman strong tin bifor dem catcham.
Look di pishor well u go even see anoda soja wey dey snap and vidio di head wey dem cut.
Boko haram don do worst pass dis one but intanationa law dey against dis kain killing wey di sojas do.
Dem get name foram and na 'human right abuse' be di name.
E get how e go be,dem go fish out and arrest di sojas and charge dem to court.
Make we siddon dey wait wetin United Nations go talk for di mata if true true say na Boko haram fighta head naim dem cut.

Sunday 27 September 2015

JIM IYKE DEY CHOP ROASTED CORN LIKE MAD FOR HOLLAND (photo)

E go shock you wen u go hear say dem dey sell akara for one deep Germany village.Na den u go fear fear.
Ok wetin u go talk about nollywood actor,Jim Iyke wey dey wipe roasted corn for Amsterdam,Holland.
Check out di pishor for yorsef:



DEM DON RELEASE AMERICAN RAPPA,DMX FROM PRISON BUT.....


Dmx sopose serve 6months for jail bicos he no dey arrange money for im baby mama to take kia of dia pikin.
For inside dis six months,he serve only two months bifor dem reliz am.
Court ansa im prayers as he file for reliz thru him lawyer as he tell dem say na yeye arrest police arrestam bicos nobodi telam say he dey owe di baby mama any money.
Dem bin sendam go jail for July and afta two months he don regain freedom.
Dmx lawyer Dominic Candino welcomam from jail but sha o,dem fit still send di bobo go jail if court find out say he know about di money problem but he choose not to pay.

Saturday 26 September 2015

SOUTH AFRICA GIRL DON CALL YORUBA MEN 419,UGLY PIPO AND THIEVES

Wetin u feel say he make dis South Africa babe wey call hersef Ama Gentle for Facebook finish Yoruba men wit curse like dis?
She finish den wit curse no be small.
She post dia pishor and di curse for Facebook.
Na wa for wire road.

Friday 25 September 2015

OMO SEE SCAMMING!!! IYANYA SELL GROUNDNUT AND BOTTLE OF HENNESSY FOR N400,000 TO FANS

Kukere masta Iyanya fans wey attend him album launch for Abuja don dey para siriosli for di bobo.
Di ones wey pay N400,000 for di VIP table dey vex say na ordinari groundnut and hennessy dem serve dem for dat kain big money wey dem pay.
Dat money go buy plot of land for some kain area and dem go even give u change on topam.
Wen tori pipo kontat Iyanya manager and co-owner of Made Men Miuzik,Ubi Franklin,he imsef dey yarn puan for di mata.


He say nobodi promise pipo wey pay for di VIP table, heaven and earth for di album launch advert.
Ubi yarn say, to siddon for di table alone na levels for dem and even sef,Iyanya give dem beta show for good three hours.
So diafor,he no see any rizin why pipo dey drink panadol for di mata.

EEYAH! 94 YEAR OLD BRODA TO DI LATE 99 YEAR OLD HID AWOLOWO BUSS CRY AS HE HEAR ABOUT HER SISTA DEATH

Di junior broda to di late Mrs Hid Awolowo wey die at di age of 99,Pa Taiwo Adelana,buss beta cry as he find out say her sinior sister don die.
Di 94 year old Pa Taiwo Adelana travel from Lagos to di Awolowos famili haus for Ikenne,meet bad news for dia as dem finalli yarnam say him sista don kick bucket.
Nor be small cry papa cry even tho say him yarnings nor too clear again but pipo still manage dey hear,"ha!ha!ha!"for him mouth and na white hanky he take dey klin di tears.
He say wetin make am say make dem carry am to see him sista na bicos he don dey dream of her death for di past three days.
Na wheelchair dem take dey push Pa Taiwo Adelana around as age sef don dey catch up onam.

Thursday 24 September 2015

SALLAH GIFT BEREKETE AS D'BANJ DASH FANS 'MALU' AND 'KOKO GARRI '

Biznessman and miuzishan,D'Banj,show some love to him fans for computa village for Ikeja as he carry waka go dia go sign anoda ogbonge deal wit one phone seller compini.
Dem even dasham one wicked Porsche motto as part of di deal as he don turn ambassador for di compini.
Afta he sign di deal finish,he later show love for Computa village as he dash out Koko garri to fans and also give out cow to di fans make dem take celibrate di sallah.
In case u no rememba,di Koko master compini naim dey produce Koko garri.
Dem say if one bizness dey take u dey play,try anoda one.
D'Banj now na garri seller.
Tomorrow he fit stat to sell gala for traffic,na di pakaging mata.

#OJOROALERT FOR NOT LOOSING MATCH FOR 202 HOME MATCH,KANO PILLARS DON BREAK RECORD

Guiness Books Of World Records don give some sports pipo catifikates few days ago.
Jose Mourinho,Chris Smalling,Lampard,Cristiano Ronaldo, na some of di pipo wey dem reward but i hope say dem no go foget Kano Pillars record by next year bicos even MIRROR,di tori pipo for UK,write say,dem no know any club wey get dat kain record.
Kano Pillars no loose for 202 home matches for 12 years.
Na 4446 days be dat if u count am by days.
Coritiba of Brazil record dey Guiness book.
Who say Naija club no fit enta dat book?
My advice to Nigeria Football Federation,na to let FIFA know officialli and Guiness Books Of World Record go take am up from dia.
#ProudlyNaija.

Tuesday 22 September 2015

ROTIMI AMAECHI DON SUE RIVERS PDP FOR N300 BILLION AS HE SAY DEM DEY SPOIL HIM NAME

AMAECHI AND WIKE 
Forma River state Govnor and APC big name,Mr Rotimi Amaechi,don sue di state PDP chaman,Chief Felix Obuah and two oda pipo for 300 billion for Abuja as he accuse dem say dem dey drag him good name for mud.
For sometime now,di Govnor of Rivers State ,Mr Nyesom Wike don de accuse Amaechi of chopping di state millions and something dey tell me say Wike go be one of di two oda pipo wey di forma Govnor dey carry go court.
Dem accuse Amaechi of tiffing N87 billion wey belong to Rivers State and say,he hide dem for Bancorp Bank for Minnesota,America and anoda bank for Switzaland.
FELIX OBUAH
Amaechi yarn and sign all di document wey concern di mata on Tuesday as he say he sue all dis pipo bicos dem dey blow heavy lie for him head say he get foreign account wia he dey kip all dis billions.
He say all him frends don dey feel say him na bad pesin and as a result he won use dis pipo take do scapegoat for court so dat next time dia head go koret but he be like say all dis him rivals mean bizness too as dem dey sure of di accusement.
Me I go siddon fence dey watch to know who go win dis fight.

Monday 21 September 2015

OYA, MEET Di NEW OLU OF WARRI WEY DI TRADITIONAL COUNCIL CHOOSE

Two weeks afta di Olu of Warri Ogiame Atuwatse 11 die,di Itsekiri traditional Council don choose 
new Olu.
Him name na Ikenwoli Godgrey Emiko di junior broda to Ogiame Atuwatse 11.
Di oldest memba for the Olu advisory council,Chief Tesigiweno Yahya Pessu,naim announce him name as di new Olu for Ode Itsekiri on Saturday.
Pessu also paform di braking of di calabash,di old tradition to confam say di Olu don rili kpai.
Dem go officiali crown di new Olu veri soon.
Although sha dem neva chooze date wey e go appun.

Sunday 20 September 2015

TARIBO WEST: I USE JUJU AND OTUMORKPOR FOR MY FOOTBALL CAREER

Di born again Taribo West,forma Super Eagles difenda,don confess say during dose time wey him dey tap leda,him do juju join him talent.
He say him get manager wey come from Senegal and he dey carry am go dia go do otumorkpor and charms to take play futbol.
He say dem dey cut him tongue,legs,hands and cookam.
No wonda dat year,If Taribo enta field plus him coloured dada wey dem put beads,u go tink say na masquerade.
Taribo say he nor know why footballas dey fear to yarn di truth wen e be say most of dem dey do di bizness.
PASTOR TARIBO 
He even talk say for some club,di president or lidas go give you lucky charm to play wit.dem go tell u  to putam for yor socks and boots bifor you enta field.
He say na dia bilif say e go hep win match.
Taribo wey don turn pastor say,God don toucham and na di gospel him dey preach now and di gospel don carry am enta places like Ughelli,Orile,Ajegunle and so on and so fort.

OYA MEET Di NEW OLU OF WARRI WEY DI TRADITIONAL COUNCIL CHOOSE

Two weeks afta di Olu of Warri Ogiame Atuwatse 11 die,di Itsekiri traditional Council don choose
new Olu.
Him name na Ikenwoli Godgrey Emiko di junior broda to Ogiame Atuwatse 11.
Di oldest memba for the Olu advisory council,Chief Tesigiweno Yahya Pessu,naim announce him name as di new Olu for Ode Itsekiri on Saturday.
Pessu also paform di braking of di calabash,di old tradition to confam say di Olu don rili kpai.
Dem go officiali crown di new Olu veri soon.
Although sha dem neva chooze date wey e go appun.

GHEN GHEN!!! SENATE PRESIDENT DON REMOVE APC FROM HIM TWITTER ACCOUNT

Dat time wey Oritsefemi sing flog "politishans koboko, dem too dey play us ojoro "many pipo fil say na robish he dey sing.
But e don clear now say di boy teeth complit bcos he know wetin he see bifor he sing dat miuzik.
Na now I know say dis polishans nor get our time.
See as dem dey use us dey play kalokalo instead of make dem tink how dem go take provide fatalizer for farmers,how dem go take stop service charge for NEPA,how dem go take reduce school fees,how dem go take comot potholes for our road.
Instead of dem to put smile for our face,na who get power pass naim dem dey fight for.
Senate Presido,Bukola Saraki,don vex remove APC for him twita page sake of say he get gbege wit di party lidas.
Code of conduct,di asociation wey dey challenge anybodi for govment wey won play ojoro,dey give Saraki heavy headache right now sake of say he nor diclear all him propati finish.
Court even say make dem arrestam to come defend imsef.

See di twita evidence say he don dey give APC chance smallsmall for bottom hia:

Friday 18 September 2015

TIMAYA DON GET ACCIDENT AS HE CRASH HIM BENTLEY

Di Egberipapa 1 of Bayelsa dey involve for one accident yestaday but tank Baba God,nobodi injure but di Bentley injor no be small.
Di hole front skata finish.
He put di damage car on top Instagram.
We join to hepam tank God say notin appun toram.

I DEY SINGLE AND NA WHITEMAN I WON MARRY - JULIET IBRAHIM

Biurifu Ghana actress,Juliet Ibrahim don yarn say she don tire for di way wey black men dey rizin wen e come to di kain job wey she dey do so diafor as a single malawi,she prefa to marry whiteman now.
Juliet Ibrahim and her Ghana forma hosband,Kwadwo Safo,get quanta and dem end dia marriage some years ago and na one pikin she born for di man.
JULIET IBRAHIM ,FORMA HOSBAND AND PIKIN
Now,she say she dey single and na white man dey her mind to marry.
She say di kain eye wey dem take dey look celibritis for Africa no gel at all.
Juliet Ibrahim say even frends and family go spoil di man mind,givam bad advice wen di man marry public figure.
She say tho nor be about di colour of our skin but di mind towards public figure,no be am at all and she give rizin why she go prefa white man.
She say dia rizining go rhyme wit her lifestyle bicos dem know di diferens bitwin yor job and yor oda life.
Wen tori pipo ask her weda she don dey thru wit black men,she say not reali espeshally if di blackman go change di way wey he dey rizin if not na only whiteman go be her choice.

Thursday 17 September 2015

NOBODi GET Di RIGHT TO DECIDE FOR ME WEN TO GET BELLE - MERCY JOHNSON

Some of Mercy Johnson fans don dey drink panadol for her mata as dem yarnam say she dey fall dia hand sake of say she nor dey give beta space bifor she born follow her shidren.
She don ansa dem say make dem cane dia line bicos as a big girl she know wetin good foram and she can do anytin wit her life.
She say she dey xpect her nomba 3 pikin and as a married woman she no xpect anybodi to askam why.
She tank pipo wey dey wisham well and also di ones wey dey drink agbo for her mata.
Mercy Johnson yarn all dis one wen she do small join bodi intaviu wit Goldmyne TV tori pipo.
She say her nomba 3 baby dey on di way and also di nomba four go even rush enta soon to settle di skors.
She say afta di nomba four, anybodi wey won hug tranforma dey free to hug am but for now na good news,so make dem join am to celebrate.

Wednesday 16 September 2015

FOR KENYA,HOUSEGIRL USE PISS PREPIA WACK FOR OGA JUST TO PUNISHAM (PHOTOS)

I be tink say na Naija pipo wicked pass for dis world but wen i dey hia some kain tori from oda kontris,since den,I kon change my tinking say Naija naim be di best kontri for di world.
Make I ask u one queshon..;
You go fit use your piss take cook soup chop?
Or,you go fit use my piss take make tea drink?
Dis kain queshon sef no swit for ear but all dis ting don appun for Kenya as dis house geh wey u dey see for dis pishor store plenti piss put for rubba bottle and she kon dey use am cook food giv her oga chop.
Akordin to dis 19 years old new devil,she say na do me,I do you,God no go vex.
Afta plenti pressure wen dem arrest her,she konfess to police say she dey do am to ponish her oga bicos she dey matrit her.
Who knows,her oga fit don dey enjoy di wack since.
Her oga fit don dey eat and lick plate clean.
Her oga fit don even dey praise her and tell family and frends say dem get koret house geh wey dey arrange koret wackis for dem.
But see wetin dem kon diskova thru CCTV camera.
Na wa for wire road.
Pipo wicked!

Tuesday 15 September 2015

GOOD NEWS!!! FEMI OTEDOLA DON REDUCE KEROSINE PRICE TO N50 AS HE CALL AM,"BUHARI KEROSINE"

Di more u look,di less u see.
I hope say dis one nor be abracadra as Forte oil oga,Femi Otedola ,don reduce di price of kerosine to N50 per lita for all Forte oil filling station and dem call am "Buhari Kerosine ".
Billionaire Femi Otedola name be dey among pipo wey dem mention for subsidy ojoro.
Dis news so pose be good news but nor be di first time wey dem don reduce kerosine price be dis as forma presido,Goodluck Ebele Jonathan also reduce am go N50 afta he win election but wen u go filling station,na diferen price dem dey sellam.
In short,u go pray make u see di kerosine buy sef wen u go filling station.
Dis week alone,kerosine don sell for N160 per lita.
Weda dis one go work or na play dem dey take us play,we go soon know.
Na so Dangote say him don reduce cement price toN1000 but e no appun.
Instead na 2,000 dem dey sellam.
I hope say dis one nor go be film trick.

Monday 14 September 2015

JAHBLESS DON TELL TIMAYA PRODUCER SAY, MAKE HE READY TO LIVE HIM LIFE FOR PRISON

Jahbless don yarn Timaya produsa say,afta he carry am go court,he must enta jail for tiffing one of im instrumenta.
Jahbless say di beat wey im use take sing di song JeJe fichoring Oritsefemi,naim di produsa tiff give Timaya and Timaya kon sing him new jam 'Halleluyah' on top.
Na for twita naim he twit to tell di Egberipapa one of di sin wey im produsa comit.
He don advice di produsa to readi im lawyer bicos he no go escape court.
Jahbless say im biliv say Timaya no know anytin about di beat bicos of him plenti years of xpirience for di industri and dis kain offence get penariti for court of law.
As at wen we dey prepia dis tori,Timaya neva yarn anytin about di mata.

Sunday 13 September 2015

CORRECT MEHN!!! NAIJA SOJAH DON CLIMB BUILDING TO BRING DOWN BOKO HARAM FLAG(foto)

Dis Boko Haram mata,nobodi know wen e go end but well,anyhow u look di mata pass,Naija sojas stil dey try to do dia best.
Me I no even know wetin dem dey fight for and why we dey kill oursef no mata di rizin.
But anyway,one Naija soja wey dey among di batalions,climb go top of one building go bring Boko Haram flag down wey dem hang to take claim say na dem dey rule dat area.
I kant wait to see dis war to end as plenti pipo don die bicos of dis fight.

Saturday 12 September 2015

NO MATA HOW Di SHOW BIG REACH,I GO STILL DEY WEAR SHORT NIKA GO STAGE - EEDRIS ABDULKAREEM

Eedris  Aabdulkareem,don yarn say di fest day wey him wear suit,na for him felow group memba, Eddy Montana wedding and na so so laff he just dey laff imsef afta him dress up finish.
He say di second time wey him wear suit na wen he dey shoot 'Mr. Lecturer' video.
Wen he dey follow tori pipo yarn,he yarn say na short nika be di best tin wey him like to dey wear,even if na di biggest show for di world,im go still wear short nika go di stage.
Eedris say, if he get chance to meet Obama today,him go stil nod him nika and t-shirt and put him towel for neck jejeje.
He say even if he get visa apointment today too,na short nika he go stil wear.
Di bobo also yarn say,upon say Wole Soyinka nor dey wear suit,naim stil be one of di pipo wey dem dey respect pass for naija and nobodi don kilam bicos he no dey wear suit.
Although Eedris talk say,blingbling naim be one tin wey him don stop to wear bicos as u dey mature, u go drop some kain habit and as a married man,pesin need to wise up.

NO MATA HOW Di SHOW BIG REACH,I GO STILL DEY WEAR SHORT NIKA GO STAGE - EEDRIS ABDULKAREEM

Eedris Aabdulkareem,don yarn say di fest day wey him wear suit,na for him felow group memba, Eddy Montana wedding and na so so laff he just dey laff imsef afta him dress up finish.
He say di second time wey him wear suit na wen he dey shoot 'Mr. Lecturer' video.
Wen he dey follow tori pipo yarn,he yarn say na short nika be di best tin wey him like to dey wear,even if na di biggest show for di world,im go still wear short nika go di stage.
Eedris say, if he get chance to meet Obama today,him go stil nod him nika and t-shirt and put him towel for neck jejeje.
He say even if he get visa apointment today too,na short nika he go stil wear.
Di bobo also yarn say,upon say Wole Soyinka nor dey wear suit,naim stil be one of di pipo wey dem dey respect pass for naija and nobodi don kilam bicos he no dey wear suit.
Although Eedris talk say,blingbling naim be one tin wey him don stop to wear bicos as u dey mature, u go drop some kain habit and as a married man,pesin need to wise up.

Thursday 10 September 2015

MOURINHO DAUGHTER,MATILDE,ESCORT HER PAPA GO GROOVE ALMOST NAKED(photos)

Matilde,di 18 years old dota of Chelsea coach,Jose Mourinho,know her papa as one of di best coach for di world and she go also know say her papa don get plenti gbege wit players,coach,referees,jornalists and bicos of dis one,he name no dey comot  for news.
Now,Matilde hersef,don give tori pipo somtin to write about as she ecort her papa go one award nite groove wey dem call "GQ Men Of The Year Award for London.
Di kain dress wey she wear go di groove go make u tire if u be pesin wey biliv say woman sopose respect hersef and her bodi.


For di dress,na small tin remain her breast for fall come out as she nor wear bra and na only small part of di breast naim di dress cova.
Mourinho sef no complain bifor dem comot for haus and all of us know say white pipo own dey dia bodi.
Trust Africa,like say na hia she come from,nobodi bornam well to dress follow her papa like dat.

Wednesday 9 September 2015

INSTEAD OF QUORAN, NA CONDOM, BURANTASHI, MAN POWER, MARIJUANA NAIM WE DEY SEE FOR BOKO HARAM CAMP

MR USMAN
Nigeria Army on Tuesday don yarn say,na so so condom,burantashi,igbo and drugs wey go make dem get power for kerewa action,naim dem dey see for Boko Haram camp wey dem don capchor.
He say instead of dem to see Holy Qur'an for dia camp wey dem run live,na condom and burantanshi dem dey see.
Di tori pesin for di Army,Sani Usman,say, all dis one show say dis Boko boys nor be Moslems as dem dey claim to be as most of dem wey dem don arrest nor fit read Qu'ran not to talk of to sing or yarn even di fest chapta- Suratuh Al-Fatiha and yet dem go dey shout say dem want Islamic kontri.
He say di ones wey di Nigerian Army 3rd Division don arrest,na amunitions,local charms,bombs,man power,fuel,igbo chloroform(AKA macaron suck and die),tramol and oda drugs,naim dem dey supply Boko Haram.
Mr Usman also yarn say di ones wey dem don catch dey confess beta infomaytion to dem wey go dey veri veri useful.

INSTEAD OF QUORAN, NA CONDOM, BURANTASHI, MAN POWER, MARIJUANA NAIM WE DEY SEE FOR BOKO HARAM CAMP

MR USMAN
Nigeria Army on Tuesday don yarn say,na so so condom,burantashi,igbo and drugs wey go make dem get power for kerewa action,naim dem dey see for Boko Haram camp wey dem don capchor.
He say instead of dem to see Holy Qur'an for dia camp wey dem run live,na condom and burantanshi dem dey see.
Di tori pesin for di Army,Sani Usman,say, all dis one show say dis Boko boys nor be Moslems as dem dey claim to be as most of dem wey dem don arrest nor fit read Qu'ran not to talk of to sing or yarn even di fest chapta- Suratuh Al-Fatiha and yet dem go dey shout say dem want Islamic kontri.
He say di ones wey di Nigerian Army 3rd Division don arrest,na amunitions,local charms,bombs,man power,fuel,igbo chloroform(AKA macaron suck and die),tramol and oda drugs,naim dem dey supply Boko Haram.
Mr Usman also yarn say di ones wey dem don catch dey confess beta infomaytion to dem wey go dey veri veri useful.

Tuesday 8 September 2015

TUFIAKWA! WE NO GO EVER HANG BUHARI PICTURE FOR OUR OFFICE - PDP

Afta Buhari 100 days for office,di Nationa Tori Seketri of PDP, Olisah Metuh, don yarn say God forbid! say dem hang President Buhari pichor for dia office wall espeshally for dia nationa secretariat.
He say e no go eva appun bicos dem nor know Buhari for dia party and he no be lida for dia party.
Na norma ting for many office like banks,schools,compinis, to hang president pishor for wall but for dis case,Metuh say ova dia dead bodi.
OLISA METUH
Altho dem don remove pishor of Goodluck wey enta power thru PDP umbrella, from dia wall.
Metuh also yarn say dem no fit hide am say dia party, PDP stand on dia own and dem be rivals to oda partis.
Buhari sweep forma presido,Goodluck Jonathan comot for Aso Rock unda APC as he winam welwellwelwell wit plenti votes during election for April.

MIUZISHANS BODI NOR BE FIREWOOD - KOLLINGTON AYINLA

If you be pesin wey know about Fuji miuzik,naim be say, Alhaji Kollington Ayinla and him Fuji 78 band nor go be problem for yor memory to rememba.
Di Fuji Ropopo singa,Kollington,wey marry fellow Fuji miuzishan Salawa Abeni later for him career don yarn,dia is no way miuzishans go fit do witout women.
In short,womanizing na part of di bizness.
Kollington Ayinla talk dis one wen he dey yarn wit tori pipo about many tins.
He say, nor be only Fuji miuzishan dey womanize as oda miuzishans na champions for di mata too.
He say blood dey flow for dia bodi too as singas and man bodi nor be firewood.
He also get some good and harsh words for journalist.
He say journalists biro too dey write wetin dem no sopose write sometimes as dem don build and also destroy many homes.

KOLLINGTON AND SALAWA ABENI
Kollington also yarn say, Salawa Abeni na still him wife; she born 3 pikins foram;she nor marry anoda man and she nor get any oda pikin for any man.
So him nor undastand why journalist dey make pipo feel say him and Salawa dey quarel.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...