MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Tuesday 22 September 2015

ROTIMI AMAECHI DON SUE RIVERS PDP FOR N300 BILLION AS HE SAY DEM DEY SPOIL HIM NAME

AMAECHI AND WIKE 
Forma River state Govnor and APC big name,Mr Rotimi Amaechi,don sue di state PDP chaman,Chief Felix Obuah and two oda pipo for 300 billion for Abuja as he accuse dem say dem dey drag him good name for mud.
For sometime now,di Govnor of Rivers State ,Mr Nyesom Wike don de accuse Amaechi of chopping di state millions and something dey tell me say Wike go be one of di two oda pipo wey di forma Govnor dey carry go court.
Dem accuse Amaechi of tiffing N87 billion wey belong to Rivers State and say,he hide dem for Bancorp Bank for Minnesota,America and anoda bank for Switzaland.
FELIX OBUAH
Amaechi yarn and sign all di document wey concern di mata on Tuesday as he say he sue all dis pipo bicos dem dey blow heavy lie for him head say he get foreign account wia he dey kip all dis billions.
He say all him frends don dey feel say him na bad pesin and as a result he won use dis pipo take do scapegoat for court so dat next time dia head go koret but he be like say all dis him rivals mean bizness too as dem dey sure of di accusement.
Me I go siddon fence dey watch to know who go win dis fight.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...