MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Sunday 6 September 2015

JOSE MOURINHO DON COLLECT 5 GUINNESS BOOK OF WORLD RECORDS CERTIFICATES

Controvasha but sabi coachee, Jose Mourinho good work don get reward as Guiness book of Records don carry five awards givam.
Dem go ativate all dis record for 2016 vasion of di book.
Chelsea coach,Mourinho pose wit all di catifikate and he promise to do more dan wetin he don achiv.

Dis na di five award catifikate wey dem carry give di "Special One."

1.Longest football unbeaten run by a manager(9years)
2.Most Champions League titles wit differen clubs(2 titles)
3.Youngest coach wey don reash 100 Champions League matches(49 years and 12days)
4.Most points for a Premier League season (95 points)
5.Most unbeaten games for home for Premier League (77).

But wait o!
#OjoroAlert
Wia Kano Pillars Catifikate bicos dem no loose 202 home match for 12 years.
Na 4446 days be dat if u count am by days.
Even MIRROR,tori pipo for UK,write say nobodi get dis kain record.
Ova to una Nigeria Football Federation .
Do your work make e reash Guiness Books of Records.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...