MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Friday 18 September 2015

I DEY SINGLE AND NA WHITEMAN I WON MARRY - JULIET IBRAHIM

Biurifu Ghana actress,Juliet Ibrahim don yarn say she don tire for di way wey black men dey rizin wen e come to di kain job wey she dey do so diafor as a single malawi,she prefa to marry whiteman now.
Juliet Ibrahim and her Ghana forma hosband,Kwadwo Safo,get quanta and dem end dia marriage some years ago and na one pikin she born for di man.
JULIET IBRAHIM ,FORMA HOSBAND AND PIKIN
Now,she say she dey single and na white man dey her mind to marry.
She say di kain eye wey dem take dey look celibritis for Africa no gel at all.
Juliet Ibrahim say even frends and family go spoil di man mind,givam bad advice wen di man marry public figure.
She say tho nor be about di colour of our skin but di mind towards public figure,no be am at all and she give rizin why she go prefa white man.
She say dia rizining go rhyme wit her lifestyle bicos dem know di diferens bitwin yor job and yor oda life.
Wen tori pipo ask her weda she don dey thru wit black men,she say not reali espeshally if di blackman go change di way wey he dey rizin if not na only whiteman go be her choice.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...