MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Tuesday 31 May 2016

FORMA IMO STATE GOFNOR,OHAKIM,DON YARN SAY,BUHARI SLOW PASS SNAIL


Chief Ikedi Ohakim,di forma gofnor of Imo state,don yarn us say President Buhari dey try to repia naija but hin speed too slow.
He yarn tori pipo afta Buhari yarns on 'Democracy Day'.
Di forma gofnor wey Rochas Okorocha take ova from yarn say,Buhari don make mistakes like delay to apoint ministas wen he first land for Aso Rock.
Ohakim say,Buhari also too slow to re-arrange NNPC but he biliv say evritin go nack enta shape lastlast.
Di forma gofnor also yarn say,Buhari case be like some pipo wey dey start race well,bifor dem go rish di ending,dem go kolaps like pack of cards.
Why he get some wey go start slow,dem go end di race as champion.
So make we bia di snail life of Buhari.

Monday 30 May 2016

WIZKID RISE AND RISE KONTINIU,AS CHRIS BROWN DON ADD AM JOIN EEN EUROPE WAKA


Di way wey dis boy levels dey rise,nor go there o.
Rihanna forma baby,Chris Brown,don add Wizkid name join een europe waka.
E nor pass like dat.
Di boy don arrive.

Sunday 29 May 2016

ABEG UNA! ME AND PASTOR CHRIS OYAKHILOME NEVA SETTLE OUR KWOREL-FORMA WIFE


Forma wife of Pastor Chris Oyakhilome,Anita,don yarn evribodi wey dey carry rumor say she and Chris don settle dia kworel.
Pastor Anita bin waka comot for dia marage for February 2016 as she akiuz her forma main man of,funny bihavior and doing touchingbodi for outside.
Na play play we first take dey hia about dia kworel until dem kon turn di rumor to true.
Wen two pastors wey be hosband and wife marage dey skata like dis,who won kon show us di exampo wey we nid from di haus of God?
Baba God my mata dey yor hand,take kontrol.

NOLLYWOOD BIG NAME,RITA EDOCHIE SAY,ONE BAD BOY GIVAM BELLE WEN SHE DEY PRIMARY 6


Shuo!
See tori!
Nollywood star,Rita Edochie,don yarn us one big sikrit say,na primary six she dey wen she take carry belle.
She yarn tori pipo dis one wen she dey yarn for one 'oppression against shidren' joinbodi meeting.
She say e get one day wen she dey go hospita,naim one area boy use otumorkpor and juju take call her and use force play enta her website.
Afta dat roff play,as she miss her piriod,naim belle enta but fear nor allowram tell her mama.
Wen di belle don rish seven months,her mama finalli find out and she explain how evritin take appun.
Rita Edochie say her sinior bloda carry knife to kill her but her mama naim kon beg.
At di end of di day,dem kon find out say,di boy wey givam belle,na her mama frend pikin.
She later born di pikin afta dem kanso di abortion plan.

Saturday 28 May 2016

ORENTE SINGA,ADEKUNLE GOLD SAY,HIM TURN CHRISTIAN FROM MOSLEM AFTA HE FOLLOW ONE BABE ENTA CHURCH


I neva see dat tin wey Baba God nor fit do?
Evriday naim we dey wake up to new tori and Singa Adekunle Gold,don nack us di one wey konsignam.
Di bobo say as he folow babe enta church,since dat time naim e change from Moslem to Kristian.
Kunle say nor be small mata as hin Popsi first form vex but last last,di old boy chilax make he live hin life di way wey him siam.

Friday 27 May 2016

PROPHET T.B JOSHUA SAY DIS 'CHANGE' NA SMALL,Di REAL FOOD SKASITI DEY COME


Prophet T.B Joshua,di founda of di Synagogue of All Nation,Ikotun,say our eyes go see pepper for dis change piriod.
He say we go hear nhwi for di one wey dey ground so.
As usual, he yarn many profesi wey konsign di world.
He yarn about di Egypt plane krash,Agrikochor,Africa politiks and even terrorist atak for Britain.
He say some funny tins fit appun for wia crowd dey gada like dia railway area.
But di one wey I know say konsign my pipo,naim I won yarn about.
For di new year cross-ova service,he yarn about food skasiti and true true dat one sef don dey appun as four Sid of tomatoes don dey near N600.
T.B Joshua say di food skasiti mara go stil tie rapa as all men go hiaram.
Baba God,abeg push T.B Joshua profesi for one kona.
On bihaf of my pipo,I dey beg u make food boku again as my pipo don hiaram too mosh.
Akordin to di Synagogue oga,he say for di ekonomi and di two-fighting wey dollar and naira dey do,Buhari gragra go end soon.
He say Buhari go do evritin to reject di divalue of di naira but last last,he go kool down bikos di pipo pressure go too much.
Naija sef mata tire pesin.

Watch di vidio of wetin T.B Joshua yarn for di Sunday service for bottom hia...





Thursday 26 May 2016

NOLLYWOOD 'WICKED MOTHER IN-LAW',PATIENCE OZOKWOR(MAMA G) DON TURN PREACHER


Abi na true true say dis woman wicked for real life?
Now Patience Ozokwor alias Mama G,na sirios kristian now as her face don appia for one crusade posta and dis na oppozit of wetin u know am for for nollywood.
Is eida she be big winsh or wicked moda in-law for home vidio but now tori don tie rapa.
One month afta her namesake and forma First Lady,Patience Jonathan appia for one crusade posta for Port Harcourt,na Mama G naim be di latest one to appia.
True true,diaries God Oooo.
Patience Jonathan crusade posta last month.
Patience Ozokwor  kabashing go appun for Obosi,Anambra state and oda men of God go join to give Lucifa headache wey no merisin fit cure on dat day.
Devil,how market?
God shidren don vex o.
Yor own don finish be dat.
Abeg,our two Payshi of life,Patience Jonathan and Patience Ozokwor,as una dey fall di Devil fence wit prayer,make una rememba put our ploblem for prayer for dis kontri.
Make una helep us pray make God touch Fulani-born Buhari,make he rediuz fuel price.
Make una hep us pray make tomato wey four sid na N500 now,come down to di frendli price wey e dey bifor.
Gofment won kill us wit ploblems.
God bless una ministri.


WOW! POLITICIAN GIVE WIFE STRONG BIRTHDAY KISS


Govnor Nyesom Wike of Rivers state nearli faint hin wife wit strong birthday kiss.
Justice Eberechi Suzzette Nyisom Wike selibrate her betday yestaday and her hosband konaram wit hot kiss.
I nor know say politishans stil dey rememba to kiss dia wife o bicos of di plenti load of work wey di electorate pack full dia head.
Dem nor dey kuku rememba to work for dia pipo but nice one say he rememba to kiss hin wife for her betday.
Issorait.
Hapi betday to you Mrs govnor wife.

Wednesday 25 May 2016

DON JAZZY DON YARN SAY,NOW WEY TOMATOES DON COST,HE WON TURN TOMATOES IMPORTA


Dis change gofment won make many pipo diskova anoda talent apart from dia real talent o.
Don Baba J,say na importing of tomatoes naim sure pass since tins don dey turn upside down for naija.
I be tink say na miuzik produsa Don Jazzy gud for but now di bobo say time nor dey again.
Now wey four sid of tomatoes don turn to N500 from N100,di next step na to dey import tomatoes akordin to di Dorobucci oga.
Make we dey watch.

CHOi! BUHARI MINISTAS DEY SLEEP UNDA BRIDGE?


Afta petrol minista,Ibe Kachikwu and hin frends inkriz fuel price,he don kontiniu to dey yarn puan.
Di man yarn tori pipo say,none of di Buhari ministas don get haus to stay for Abuja.
Kachikwu say dem neva fit raise akomodashon money bicos gofment broke pass church rat.
Akordin to Kachikwu,dat na one ploblem wey Buhari neva fit solv for dem.
He say naim own haus him dey stay for Abuja since Buhari neva gree play ball.
Anoda minista wey dey niaram kon nod him head say na true Kachikwu dey yarn.
He say like imsef,na squat he dey squat wit pesin.
Kai!
Big man squat wit pesin?
Politishans and lie be like bread and butter.
Mr politishans,make una kam down wit una plenti talku talku.
Wia una kon dey sleep since?
Na unda bridge?
Yeye dey smell.
Watch di vidio of wetin Kachikwu yarn about di haus mata for botom hia...

Tuesday 24 May 2016

ORITS WILLIKI SAY NA N50K A MONTH HIM DEY SPEND JUST TO TAKE KIA OF HIM DADA


Rastaman Orits Williki,don yarn tori pipo say,to take kia of hin dada wey him don dey train for about 16 years now,nor be beans.
He say na ova N50k a month him take dey arrange hin dada.
Williki say spesha shampoo and krim dey wey hin dey use and di pesin wey dey take kia of di dada go come haus come do home savis.
50K for hair for a month and crowd dey hungri?
Well sha naim money but I nor won hia say he cut di dada troway any day.
Di reggae star say many rasta nor dey take kia of dia dada and many dada dey smell.
Dis one kon make pipo nor dey like make frend wit dem.
He say na dis one naim make am dey send mesage wit di neat dada wey dey hin head say rasta men na neat pipo.
Dis kain dada wey dis man carry for head na wa o.
U go fear dada na.

WATCH Di VIDEO OF 'OYIBO WOMAN' WEY DEY SPEAK AND BROKE URHOBO LANGUAGE LIKE PALM KERNEL


E gud like dis sef.
Nor be only we go len dia language,copy dia karata and kraze for dia mata.
Na dem naim yarn dat big gramma say,'No man is an island',meaning say,we all need each oda to sorvive.
As dis Oyibo pepper dey speak koret Urhobo from Delta state naim gud.
Make she use am oppress and see front too.
She speak di langua pass many pipo.
Watch di vidio for bottom Hia...


Sunday 22 May 2016

FEDERA GOFMENT DON RAISE ALARM SAY RIVER NIGER DON DEY DRY


Federa gofment don raise alarm say River Niger go soon dry kpatakpata sake of say dem dey troway dirty inside.
Apart from dat one,gofment also yarn say population and di weather nawadays also join dey dry di River Niger.
Di auditor general of yor kontri,Mr Samuel Tyonongo Ukura,naim raise dis alarm.
Akordin to Ukura if di kontris wey River Niger pass thru dia are nor join hands and do somtin aboutam,di riva go dry kpatakpata veri soon.
Ukura say kontris wey dis ploblem dey affet like Mali,Algeria,Niger,Benin,Burkina Faso,Cameroon,Côte D'voire and Chad,don agree to come naija for di joinbodi meeting as e take konsign dis riva.
River Niger naim be di nomba three longest rival for Africa afta River Nile and Congo Zaire rivas.

Saturday 21 May 2016

ALAPOMEJI SINGA 9ice,SAY NA ROBISH FOR MAN TO MARRY ONE WIFE


9ice don yarn say to marry more dan one wife naim pure pass bicos women plenti pass men nawadays.
Abolore Akande a.k.a 9ice yarn tori pipo Ebony tv all dis one.
Di bobos wey hin miuzik,Gongo Aso,skata evriwia da'year say,hin come from family of plenti wife and plenti shidren so diafor na fada Abraham tins naim sure pass.
9ice liv hin first wife,Toni Payne,afta dem get kwanta and now di bobo don dey fire down wit oda women.
One born twins foram and di last one don givam one dota.
9ice and Toni Payne

OLD PAPA YOUNGIE: SEE WETIN MAKE-UP TURN AKI,PAWPAW FREND TO



Di tv show "The Johnsons", get some karatas and one of dem na,Chinedu Ikedieze a.k.a Aki.
He play di role of old papa for di Johnsons and as a yong short boy,na only make-up fit turnam to old papa.
Di make up pesin,put white hair for him head,white mustache and white biabia.
Di scores naim u dey see hia so.

OLD PAPA YOUNGIE: SEE WETIN MAKE-UP TURN AKI,PAWPAW FREND TO


Di tv show "The Johnsons", get some karatas and one of dem na,Chinedu Ikedieze a.k.a Aki.
He play di role of old papa for di Johnsons and as a yong short boy,na only make-up fit turnam to old papa.
Di make up pesin,put white hair for him head,white mustache and white biabia.
Di scores naim u dey see hia so.

Friday 20 May 2016

CYNTHIA MORGAN SAY NA SHE MAKE FIXING OF RED HAIR START TO DEY REIGN FOR BABES



E dey soprise me sha how some pipo go just like make dia name nor dey comot for wrong mesage.
Cynthia Morgan di reggae miuzik mafia,don yarn on top twita say na she make red hair popular rite now.

She say na since she start to fix red hair for naija,na since den babes kon dey like di hair.
First of all,bend down low.. make i ask u Cynthia.
Yor red wig don hep anybodi?
Who yarn u say pipo like red hair?
How many pipo dey wear colored hair apart from once in a while?
Dis tin wey she yarn make me enta street ask like six gehs and na one ansa katch my attention.
She say make Cynthia Morgan dey tink bifor she talk.
I nor know since wen red hair kon turn food.

CHAi! SEE LOVE IN TOKYO,SORRY..LOVE IN CAMEROON


I bin tink say na mango,mungo park diskova,until I hear say na River Niger.
Whoeva diskova dis true love wey dis two lovas dey share,dat pesin riri try.
Inshot,we must to rush dat pesin name put for Guinness book of records.
All di way from Cameroon,we dey bring you,di best lovas for di world.
Dis two pipo don marry for sometime now and di love stil dey kamkpe.
If u nor rekognaiz di love bitwin Matinke and Dongare,my broda,u are on a long tin.
Gud make-up,gud smile,gud evritin.
Infact,Gold evritin,no silva.
Di type of love wey fit make Obama and Michelle jealous.
See more pikchors of Matinke and Dongare for bottom hia...

Thursday 19 May 2016

Di BOBO WEY TREK FROM LAGOS TO ABUJA TO SOPORT BUHARI AFTA HE WIN LAST YEAR ELECTION,DON DEY REGRET NOW


Dat bobo wey troway soport giv Buhari by treking from Lagos to Abuja to selibrate Buhari vitri ova Uncle Jona,don dey regretam like say dem forsam to trek.
Di bobo,Hashimu Suleiman rizin be say,pipo dey sofa and Buhari and him boys remove subsidy for our oil.
He say many pipo nor fit put food for dia table,no money,many konpinis don pack up and pipo don dey expect dis change for a long time and now gofment kon make tins dey hard more more for pipo.
Although sha,some pipo don dey say dis Suleiman nor well.
Dem say,e be like say Buhari nor bless di guy afta he swallow trekmasin kon trek from Lagos to Abuja.
You sopose read some Buhari textbook.
Dat man nor dey troway money anyhow.
He stingy die.
Like say dis Suleiman trek for Patience Jonathan a.k.a mama peace,she for blessam,I trust her for dis kain mata.
Next time look well bifor u trek.
Life too hard to trek troway nowadays.

WIA DIS IYANYA OF A BOY,TIE ONLY TOWEL DEY GO?



I nor undastand dis bobo again o.
Shey Iyanya stil dey sing or na model him be now like Olajumoke di forma breadsella?
Today di bobo go sampo chest,tomorow he go sampo muscle.
Now he don sampo us only towel wey him tie round him waste.
Except say him don don ambasador of di towel makers.
If not...Na so kolo take dey start.
Okorowanta neva fit stil explain how him kolo take start.
Kwantiniu,we dey watch.

Wednesday 18 May 2016

19 PAPA AND MAMA OF Di CHIBOK GEHS WEY BOKO HARAM KIDNAP,DON DIE


Boko Haram?
Boko Haram??
Boko Haram???
How many times I call una?
Make una reliz di Chibok gehs wey una kidnap ova two years ago,na God I take beg una.
Una neva hia for yonda say, 19 papa and mama of di gehs wey una hide,don die?
Una don use tinking kill dem now.
Wetin dem do una?
A whole 19 pipo naim don die.
Di chairman of di Pileh and Mileh Asociation of di kidnap Chibok gehs,Mr Yakubu Nkeki,naim anounce am during di joinbodi meeting wey dem get wit Aisha Buhari di First Lady.
Aisha Buhari kon donate N30 million give dem and kon also donate N25 million giv di papa and mama of di Buni Yadi boys wey Boko Haram kpai.
Di association say dem nor appi say afta two years,gofment neva stil know wia dem hide dia shidren.
Dem kon beg gofment make dem try do somtin about am.

AREA! ABEG, DiS BANKY W SHOE NA FAKE?


Guy,I no sabi lie.
If I tell u say,I know origina or fake of dis Yeezy snikas,dat na beta cooked lie.
Banky w naim post di kicks on top Instagram say him don arrange am for imsef.
Akordin to Banky w,na Yeezy product and na eepop badboy,Kanye West,naim get dis shoe konpini.
Bifor Banky go say, 'Sidon look' is a verb,sombodi don sharp sharp yabam say di shoe na fake wit plenti rizins to backam up.
U go blame di guy?
Banky wey get shoe,kon dey proud sampo ram on top Instagram say,yes! him don buy Yeezy,naim I be blame.
If dem chop kpomo,we go know on top Instagram,if dem tosh bobi,dem go yarn,if dem fry indomie,we go hia,if dem fab malawi wey get koret ikebe,we go hiaram.
Make dem dey enjoy di insult wey dem dey find.
Afta di bobo don yarn full ground,na dat time naim Banky kon dey yarn say na him junior broda buyam foram as gift and say make dose pipo wey dey yarn anyhow go look for dia apiness.
I be Uncle Jona dia last born.
We nor get shoe,na empti leg we dey use waka.
If u know about shoe,abeg tell us weda dis Yeezy shoe na fake or origina.
Time no dey.

Tuesday 17 May 2016

LIL KESH SAY NAIM CHURCH MIND HE USE,NOBODI FORSAM TO LIVE OLAMIDE YBNL RECORD KOMPINI


Eva since shoki singa,Lil Kesh live Ybnl go form hin own,'Yagi',pipo don dey yarn say na wrong advice him follow dat is why he live hin forma oga.
Now,Lil Kesh don come out to yarn say,dat tori na big lie.
Di bobo say,him nor get frends outside Ybnl,so who kon be di pesin wey advice sam?
He say di only pipo wey him dey folow waka bifor,na Ybnl gang and Yagi dey work hand in hand wit dem.
Lil Kesh say na him forma oga,Olamide,even use him own mouth yarn say,he want make dem grow big for di industri.
He also yarn say,bicos he arrange hin own kompini nor mean say he nor dey unda Ybnl again.
Kesh say til today,him and Olamide stil dey record for di same studio.
Even kpakpa sef dem stil dey work wit di same produsas.

NOLLYWOOD BABE,CHIKA IKE,DON VISIT SHIDREN OF SOLDIERS WEY DIE (fotos)


Since I bigin to dey get sense kon rish now wey I don wise pass Solomon,I neva hia any tori of star pesin wey go visit di pikins of sojas wey die for war.
But Chika Ike don finalli let me siam as she nor just visit dem,she also arrange plenti gift giv dem.
I dey always dey call pipo wey do gud tins and show gud exampo like dis,my selebriti of di week and Chika Ike wey also be peace ambassador for United Nations,naim get dis award for dis week.



Monday 16 May 2016

SUPASTAR ACTRESS,YVONNE NELSON SAY,SHE NOR GET ONE SINGLE LOVE FOR HER PAPA


Ghana top actress,Yvonne Nelson,don yarn say,she nor dey agree wit her papa but she get mad love for her mama bicos na only she take kia of her from day one.
Akordin to her,she say her mama start to take kia of her wen she dey akara school and up til now her mama stil dey call her for phone to know how she dey.
She say her mama na her frend dats why she dey even call her 'Charlie'.
Yvonne Nelson yarn tori pipo all dis one and she say she take her papa as evri oda odnari pesin to her.
She say she and her papa nor get any sirios bondment bicos her papa abandon her and na di truth be dat.
Yvonne wey be Iyanya forma babe,yarn say,her phone nomba dey wit her papa and dem dey yarn sometimes but na dia e end.
She say she nor get time to add sugar to di tori and lie say say evritin dey alrite wit her papa.
Na wa o.
Papa and mama and evri oda pesin wey dey hope to be papa and mama for di future,nor abandon yor pikin wen dem need yor care.

Sunday 15 May 2016

OKOKOBIOKO! AFRICA CHINA DON TURN HAIR DRESSER FOR FESTAC TOWN


Chinagorom Onuoha a.k.a Africa China,don use hin church mind bifor e go dey late.
Di 'Mr President' singa from Ikeduru local gofment area of Imo state,don enta oda bizness apart from miuzik so dat e go fit dey see front.
Dem say if one way close anoda one go open.
Nor be say Africa China don stop to sing sha,just dat dem Wizkid,Davido Olamide,Burna Boy,Yemi Alade,Tiwa,Pato Ranking don pusham comot for bizness.
One tin wey I kon like aboutam be say,as a shap Ibo boy,di bobo don open hair dresser and barbing salon bifor we go kon stat to hia stori dat touch.
Di name of di saloon na 'Chyna Town Unisex Beauty Saloon' for inside Festac Town,Lagos.
Di last time wey I yarn wit China,di bobo bin code me say,him dey manage one klub for Festac.
At list di two bizness go stil dey put wack for hin table.
E beta like dat bicos,e be like say dis new miuzishans don swear say dem nor go allow any old miuzishan reign again.

YEKPA! SEE Di BOBO WEY DEY WEAR SUIT DEY KLIN AND WIPE WINDSCREEN FOR TRAFFIC


Dem say na who alarm neva tear dey do yanga.
Na who owu neva show pepper,naim dey select work.
Abdulahi Olatoyan na one bobo wey comot shame for eye dey hussle for traffic for Abeokuta,Ogun state.
Some pipo even konfamam say dem bin dey siam for ILorin,Kwara state too.
Nor be di koko of di mata be dat.
Di koko of di mata be say,di bobo dey nack suit dey wipe windscreen for traffic.
No mata di eye wey u take dey look dis work,at list,he beta pass who dey tiff.
Abdulahi say him enta street go hussle afta he stop school bicos hin papa die.
Di bobo say,he won gada enof money and later go back to school one day.
Gudluck to you bros.






LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...