MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Saturday 14 May 2016

SERENA WILLIAMS SAY SHE DEY REGRET AFTA SHE EAT DOG FOOD


Long throat na wen you live yor own food dey eye yor dog food bicos crayfish,fried eggs,abodi,chaki,kpomo and plenti medemede dey inside.
Lawn Tennis big name,Serena Williams,live her food kon chop her dog food sake of say di wack nice for eye.
Her dog wey she name 'Chip' waka live hin wack and wen she see di wack,her eyes shook beta shook.
She say dem bin swrve di dog koret wackis.
Nice soup and plenti oda gud tins dey inside di plate.
Beta rice and salmon fish .
Wen Serena site di wack,na so so spit she kon dey swalow as she nor fit biaram.
Nor be small sick Serena sick afta she put one spoon for mouth.
Now she dey blame di hotel pipo for Italy say dem for write on top di wack say human being nor sopose eat am.
Wen u don dey get long throat for animal food naim be say u need hundred days dilivrance be dat.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...