MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Sunday 8 May 2016

WHAT A LIFE! RASHIDI YEKINI MAMA DEY SELL BREAD TO SORVIVE FOR KWARA STATE


Di mama of Rashidi Yekini,Nigeria best strika eva wey skor 37 goals for Super Eagles bifor he die four years ago,dey sofa siriosli for Offa,Kwara state as na bread she dey sell to take see front.
Nor be say she get bakery,no!
Na like six or seven bread she dey sell for her tray.
It's posibo say she dey do am for fun but I doubt bicos even bifor Yekini die,tins get as e be foram.
He sofa die.
Nor be dis robish futbol wey Super Eagles dey play nowadays.
Di time of dem Yekini,we enjoy futbol and dat same pesin sofa die and now di mama dey strogl to chop.
Abeg NFA we know say una own dey una bodi but abeg make una hep us do somtin for mama as una nor soport her pikin wit one singo position wen he dey alife.
Rumors wey we dey hear be say she just dey sell bread as hobby but NFA make una hep us find out weda na true.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...