MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Wednesday 11 May 2016

AY COMEDIAN SAY HE SPEND 9 SOLID YEARS FOR SCHOOL BIFOR HE GRADUATE FROM UNIVASITI


One bobo wey him life stori dey sorprise me and na big inspiration to plenti pipo til tomorow,na Ay.
If nor be say i knowam rish haus for Warri dat year,i for say di guy won just yarn.
Guy,live mata,wetin di bobo yarn tori pipo yestaday,na di riri truth.
Akordin to AY,he say for 1999 wen popsi die,he say to carry hin famili load for head hard like pesin wey won boil rock chop.
To make mata worse,Ay say hin momsi kpai almost di same piriod wit popsi.
He say to take kia of hin four sistas and two brodas plus landlord rent for one kona,nor make tins eazi as e make am spend 9 years for Delta State Univasiti,Abraka.
But today,God don change he stori as He bless him hustling.
Ay say, apart from say God don make am a susesfu comedian,him dey proud of di success of hin two brodas.
Lanre,wey dey package big shows now and Yomi wey get Yomi Casuals,one of di most popula fashion designa for town.
From notin,di bobo show 'Ay Live', don turn one of di most susesfu show for Africa and dat one na inspirayshon to chop and drink water on top.
Ay kon advice pipo say,with God,nobodi wey no fito make am sofa make u kontiniu to put eye for ground and dey humble.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...