MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Monday 9 May 2016

SOUTH AFRICA PRODUCER,OSKIDO,DON YARN SAY,WIZKID ALBUM GO ACHIEVE WETIN NO OTHER AFRICA ALBUM DON ACHIEVE


Di smallest seed for di world na mustard seed.
But wen u plantam,e go kon grow and turn to one big tree wey birds dey build dia flat put.
If u kompia Wizkid stori to dat of mustard seed,nobodi go arrest you bicos,di man of di moment,Wizkid career dey grow wit di spid of Usain Bolt even bifor Drake put eye for hin mata.
As Drake and di rest intanashona miuzishans kon rekognaiz Wizkid miuzik,as champagne to di ears,di rise kon inkriz.
Wizzy and Oskido
Now,top South Africa miuzik produsa,Oskido,don yarn di world afta he listin to Wizzy album say,di album go rish di level wey no oda Africa album don richam bifor.
Although Wizzy neva reliz di album but some of di pipo wey go first hiaram bifor you and me na,produsas wey dey close toram.


No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...