MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Saturday 7 May 2016

WATCH DI VIDEO OF DI SMALL PIKIN WEY LOVE STOUT BUT REJECT WATER


Can u imagine!
Even stout wey dey bita,naim dis pikin love like say na cheese balls.
How di mata take rish dis level?
How di smallie take start to like stout wey bitaleaf swit pass?
Dis boy famili get many queshon to ansa.
Wen pikin wey neva pass two years dey reject water kon dey cry say na stout he won drink,naim be say devil don dey krip enta di smallie life small small.
And if di famili nor do somtin about am,na dat same stout bottle he go take dey brake dia head one by one wen he don rish like 13 years.
Wetin di family of dis pikin dey do to stop dis kain robish karata?
If u watch di vidio,u go even see as pipo dey laff instead of dem to flogam make he sense koret.

Watch di vidio for bottom hia and tell me how u see di mata....


No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...