MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Wednesday 28 February 2018

PLATEAU STATE GOVMENT DON BAN KEKE NAPEP FOR JOS AND BUKURU AREA FOR Di STATE BICOS DEM SAY,Di KEKE RIDERS DEY SHOW STUBBORN HEAD FOR DiA


Keke riders for Jos and Bukuru areas for Plateau state don enta wahala as di govment for dia don ban dem from movement.
Akordin to di tori wey we gada,dem say make dem pay some money and also do some some training but dem refiuz and Na dis one make dem stop dem from doing dia bizness.
Na wa o.
E don red be dat o.

Di FAMILY FOTO OF BRIGHT CHIMEZIE Di SINGA OF 'I CARRY MY EBA,I CARRY MY OGBONO SOUPE' DON ENTA TOWN


King of guy yoyo dance steps ,Bright Chimezie family foto don rish our hand.
If you rememba dat song,African Style wey he for dey sing say,..I carry my Eba,I carry my ogbono soupe,...you go know who Bright Chimezie be.
Check out him famili pishor wit him wife and shidren.
Fine man,fine famili.

Tuesday 27 February 2018

ONE BABE DON GO PARA FOR OLAMIDE FOR HIM HOTEL FOR GERMANY AFTA HE PERFORM FOR STAGE FOR ONLY 20 MINUTES AS FANS START TO BREAK BOTTLES BICOS DEM FEEL SAY DEM WASTE DIA MONEY


Olamide pafom for Germany last wikend and no be small parai fans para as dem start to break bottles anyhow sake of say Olamide dey stage for only 20 minutes.
One girl wey dem say di bottle hit her head,even vex go di hotel wey Olamide lodge for Germany go shout for Olamide and she even record di video.
No be small tin o!
Oya watch di video for bottom hia....


Monday 26 February 2018

NIGERIA GOVMENT DON ENTA SERIOUS MEETING WIT WORLD BANK TO BORROW ONE BILLION DOLLARS ($1BN) TO TAKE SOLVE NEPA AND LIGHT PROBLEM FOR DiS KONTRi


Di day wey we go free from light ploblem for dis kontri ehn,I biliv say heaven go come down come join us selibrate.
Upon all di billions of naira wey naija don borrow and spend to fix NEPA wahala for dis kontri,we still dey suffer to see di light.
Now Federa Gofment don enta deep talk wit World Bank to borrow one billion dollars ($1bn) from dem to pump enta NEPA.
Akordin to news wey enta our tori room,di meeting wit World Bank don enta di final stage.
Di money wey dem won borrow no be problem.
Di problem be say,all di ones wey dem don dey borrow bifor wetin dem use am do?
Na so we go dey one day dem go come arrest evribodi for dis kontri say we dey owe World Bank big money.
God nor let dem fall our hand.

Sunday 25 February 2018

E NO EASY TO LIVE 40 YEARS FOR NAiJA WITHOUT YOU NO TURN TO MAD PESiN ACCORDING TO ACTRESS FOLUKE DARAMOLA WEY SELiBRATE HER 40 YEARS BIRTHDAY DIS MONTH


Akordin to Foluke Daramola wey be nollywood actress,she say,her biggest hapiness na to live life for naija for 40 years and she no turn to mad pesin.
She say di kain ploblems wey we dey face for naija sopose make pesin run mad bifor di pesin rish 40 years.
She say lot of pipo sef dey espet too much from dem espeshali bicos dem dey see dem for film.
Foluke say make you forget wetin you dey see for tv,all na film tric bicos life for naija fit can turn us to mad pipo and na only God fit do am for you to rish 40 and you still dey norma.

Saturday 24 February 2018

NOLLYWOOD BADBOY JIM IYKE,DON FINALLY AGREE SAY,Di SONG WEY HIM SING WIT 2FACE FOR 2009 NA NONSENSE BICOS HIM GET ZERO TALENT FOR MUSIC


Wen ya heart disiv you say you good for somtin and you kon listen to ya heart,naim be say you be learner.
If you rememba some years ago,Home vidio and Nollywood baddest boy Jim Iyke bin enta miuzik and even reliz one song wit 2face wey dem call 'Who I'm I' for 2009.
Many pipo yabam say he fall he hand and right now Jim Iyke sef don agree say,true true miuzik no be him calling.
Jim Iyke wey turn baba for di film industri for naija say him just enta miuzik just to see how di mata dey go.
Jim say he just won try him luck but miuzik fail am and he find out say na zero talent him get for di mata.

Friday 23 February 2018

ACCORDING TO DAVIDO HEAVEN GO TOO SWEET AND TO GO HEAVEN DEY HUNGRY AM

 

I hope say no be to die dey hungri dis boy wey dem dey call Davido?
Afta Dagrin sing say,'wen I die,make u no cry for me', he no tay na so di bobo kpeme.
Na Davido don't dey talk say him no fit wait to go heaven bicos heaven go sweet welwell.
Davido pipo still love you and your miuzik,so you beta be kiafu of di tins wey you dey yarn.

Thursday 22 February 2018

FOLORUNSHO ALAKIJA,ONE OF Di RICHEST BLACK WOMAN FOR Di WORLD DON TALK SAY,SHE NO GO UNiVASiTi BUT GOD STILL MAKE HER BILLIONAIRE


Folorunsho Alakija,di richest woman for naija and one of di richest woman for di world don talk say,na Baba God do am foram to be billionaire even tho say she no go school.
She say she bin dey dream to bikom lawyer but her papa no gree train her bicos dat time dem biliv say to train girl pikin na waste of time.

Wednesday 21 February 2018

PAUL OF PSQUARE DON TALK SAY,INSTEAD OF HIM TO GO VOTE FOR OLD POLITICIANS, HIM GO KUKU STAY HOUSE


Paul Okoye a.k.a Rudeboy,don talk say him no get time for naija politiks bicos our leaders don fail us.
He say di same old politicians na dem dey run tings for dis kontri.
Paul say instead of am to vote for old politician, him go kuku stay house.

Tuesday 20 February 2018

PRESIDENT OF WORLD FOOTBALL INFANTINO SAY,DEM BE TELAM SAY NAIJA PiPO DEY CRAZE FOR FOOTBALL BUT WEN HIM COME HERE,HE FIND OUT SAY FOOTBALL NA LIFE AND E PASS CRAZE


President of football mata for di world,Gianni Infantino don say football na life for Nigeria.
He say bifor him enta Lagos,dem be telam say pipo dey craze for football for here.
Infantino say football pass crazeness for naija.
Wetin football be for hia na life akordin to Infantino.

Monday 19 February 2018

VERY VERY BEAUTIFUL WOMAN AND NOLLYWOOD ACTRESS 'CAROLINE DANJUMA' DON YAN TORi PIPO SAY,NA Di GOOD BRAIN WEY SHE GET DEY GIVE HER WORK,NO BE HER FINE FACE



Caroline Danjuma,one of di finest baby for nollywood don yarn say,she sabi book and her brain dey work like konputa and na di reason why she dey get work and roles for di work wey she dey do.
If you dey follow up you go know say,di babe na old meat for Nollywood and naija home vidio as she don tay for di bizness.
Now she don tell tori pipo say,na her brain no be her fine face dey make film produsas dey givam job.

Sunday 18 February 2018

ACTRESS MERCY JOHNSON DON TALK SAY,WHY SHE ALWAYS DEY ACT LIKE MUMU FOR FILM NA BICOS HER HUSBAND DEY VEX ANYTIME SHE PLAY LOVE AND ROMANCE PART FOR FILMS


Nollywood big name,Mercy Johnson don tell tori pipo say,Di reason why she dey avoid lovi lovi roles for inside Naija home vidio na bicos,her hosband dey always para if he watch am.
Mercy say Na dis one make am always dey do like Mumu for film and make di hosband laff.
Akordin to Mercy Johnson,e beta make she kuku dey act Mumu roles dan make she use jealousy take kill her hosband.
E good as you respect ya man feeling.

Saturday 17 February 2018

FORMA PRESIDO,OBASANJO,DON TELL STUDENTS FOR BAYELSA STATE SAY,HIM FOR DON KOMiT SUICIDE IF HIM NO GET HOPE SAY NAIJA GO BETA


Forma khaki and sivilian presido, Olusegun Obasanjo don yarn say,him get hope say dis kontri go beta.
He talk dis one for di 'joinbodi Sidon talk' wey him do wit students of Ijaw National Academy (INA) for Bayelsa.
He say him for don kill imsef since if to say him no biliv in Nigeria and biliv say tings go beta.
He also yan say na dis one make am always dey talk if tings dey go wrong for naija.

Thursday 15 February 2018

SOUTH AFRICA PRESIDENT JACOB ZUMA,DON RUN LIVE HIM POSITION AS PRESIDENT AFTA HIM PARTY 'ANC' TELAM SAY DEM NO WANT AM AS PRESIDENT AGAIN


Nor be news again say South Africa Presido Jacob Zuma don step down as president sake of say him party ANC telam say dem don tire for him gofment.
Zuma resign yestaday bicos di pressure don too much.
Akordin to Zuma he say,na oppress dem oppress am bicos since he join di party for 1959,him don make sure say,evritin nice finish for South Africa.
Him asistant Cyril Ramaphosa go take ova as president fromam.

Wednesday 14 February 2018

OLAMIDE BADOO DON COLLECT TWO YOUNG SINGERS 'LIMERICK and LYTA' FROM STREET TO JOIN HIM RECORD COMPANY 'YBNL'


Olamide wey many pipo don crown as di voice of di street for naija hip hop,don sign two new artiste to YBNL wey be di name of him record kompini.
Dia name na 'Limerick and Lyta' and na dem be di latest membas of di gang.
Olamide wey study science for school dat time wey him still be student,don hep many miuzishans blow for di industri.
Adekunle Gold,Lil Kesh,Viktor na some of di bobo wey blow thru di YBNL empire.
Di industri dey wait to see di twist wey dis guys karia go take afta Olamide sign dem.
Nice one Badoo.

Tuesday 13 February 2018

LAGOS STATE GOVNOR AKINWUNMI AMBODE DON PUT LAW SAY,TO ENTA UNiVASiTi,POLYTHECHNIC OR ANY BIG SCHOOL FOR LAGOS,YOU MUST PASS YORUBA LANGUAGE


Akinwunmi Ambode,how you go feel if yoruba students wey choose to go school for outside Lagos no fit enter dis schools bicos dem no dey hear dat state language or dem no pass di language exam?
Now  Lagos gofment don yan say,if u no pass yoruba for school,you no fit enta school for di state again.
Dis na law wey dey enkorage evribodi to go back to him state go school be dis.
We dey wait to see how pipo go accept dis law.
We dey wait.

Monday 12 February 2018

CONDITION NAiM MAKE CRAYFISH BEND AS FORMA SUPER EAGLES CAPTAIN UCHE OKECHUKWU a.k.a GENTLE GIANT,DON TURN 'HUNTER' FOR ABIA STATE



For ova ten years now,tori pipo don dey struggle to know wia di forma Super Eagles skippo 'Uche Okechukwu' hide afta he retire to play football.
Finalli, dem don diskova say di guy dey him village for Umuoria for Obingwa local govment,Abia state and na hunter work di guy dey do now.
Any monkey,antelope, grass cutter, bush pig wey no behave imsef for bush,don enta Okechukwu a.k.a Gentle Giant wahala be dat as he go gun dem down.
But how much him go make for di hunting job kompia to wetin footballers dey resiv?
If he too make money for a week,he kant gada pass 20k a week.
Time don rish wey gofment go open ministri wey go dey look afta pipo wey serve dis kontri.
Rashidi Yekini suffer die,Coach Amodu cry tire for salary wey NFA dey owe am bifor he die,even Wilson Oruma bin dey waka waka for street as dem say small kolo bin enta him head bicos of pepper wey nor rest again.
Uche Okechukwu bin dey di Tunisia 94 squad wey win NationsCup,he also play for USA 94 World Cup and plenti oda match for naija.
Now kondishon don drive am enta bush dey kill bush meat.
Nigeria wake up,your heroes don die of povati finish.

Sunday 11 February 2018

GHANA BAD BOY SINGER,SHATTA WALE DON TALK SAY,HIM GO BURN CHURCHES IF HE DEY ALIVE TILL DECEMBER AFTA ONE GHANA PASTOR YAN SAY,SHATTA GO SOON DIE


Shatta Wale,Ghana Reggae and Dancehall miuzishan,don yan say,him go burn churches down if by Disemba him no die afta Ghana pastor say him see vision say Shatta Wale go soon die.
Shatta Wale post video and also write on top twita say,if him no die by Disemba,na big war against fake prophets go take place.
Top Ghana girl miuzishan 'Ebony' die on Tuesday for accident afta anoda pastor bin talk for 2016 say she go die young.
Evribodi for Ghana know say fire dey Shatta head abeg God,nobodi go die.
But Mr Pastor,na only bad bad vision and news una dey see for pipo head?

Friday 9 February 2018

MICHAEL JACKSON THIEF SOME OF HIM SONGS WEY MAKE Di WORLD LOVAM ACCORDING TO JACKSON NUMBER ONE PRODUCER,QUINCY JONES



Almost 19 years since Michael Jackson die,him produsa dat year,Quincy Jones don yan say,Michael Jackson tiff some songs wey him take blow and skata evriwia.
Akordin to Jones he say,songs like Billy Jean,na Donna Summer song 'State of Independence' naim Jackson tiffam from.
Evribodi wey know about dis two miuzik go know say true true,dis two songs be like broda and sista and na Quincy Jones naim produce di two songs.
He also yan say if no be long throat Michael Jackson sopose pinsh somtin give piano playa Greg Philinganes for him kontribiushon to di song 'Don't stop till you get enough'.
Well,di 84 years Quincy Jones know Michael Jackson finish since naim boy but di only tin wey dey vex some pipo right be say,why him no talk am wen Jackson neva die so dat di bobo go defend imsef.

Thursday 8 February 2018

WIZKID DON BLOW AGAIN AS HE DON SIGN BIG MONEY CONTRACT WIT OGBONGE SPORTSWEAR COMPANY 'NIKE' TO DEY SELL ORIGINAL 'STARBOY FANS' JERSEY


Bifor week go end,di Aba made of Starboy and Wizkid fans Jersey, go don full market.DAT one sef dey.
But dat no be di news,di bigelest news right now be say,ogbonge sportswear konpini 'Nike' don sign kontrat wit Wizkid to dey produce and sell di 'Starboy fc fans' Jersey.
Nike,na dem also be di makers of  Super Eagles of Nigeria Jersey and dem let us know abou di kontrat wit Wizkid di same day wey dem show di world di type of Jersey wey Super Eagles go wear for di FIFA 2018 Football World Cup wey go appun for Russia in four months time.
But wait o,
Abi Wizkid don dey eye football club?
Anyway,Kongratulabia to Starboy Wizzy.
Watch di video for bottom hia...


Wednesday 7 February 2018

NICE GUY WILLIAM UCHEMBA 'THE i DONT LIKE WHAT i HATE BOBO' DON YARN SAY,HE WON SEND 100 CHILDREN BACK TO SCHOOL AND HE DON START ALREADY


Leader of di #GiveChallenge and film actor William Uchemba don promise to send back 100 shidren back to school.
For sometime now,dis same guy don dey dash plenti pipo money for street alreadi.
Nice one,as you dey hep pipo like dis,God get reward for you.

Tuesday 6 February 2018

FILM MAKER FEMI OGEDENGBE, DON CONFAM SAY,HIM DON RUN GO AMERICA GO DO GATE MAN WORK BICOS SUFFER FOR NAIJA TIRE RAM


Femi Ogedengbe wey be Film maker for nollywood don run go America go hustle bicos he say di money wey him dey make for dia as gate man,don finalli dey reach am take kia of him famili.
Pipo bin dey say he don enta Yankee go be gardener but he say na lie na sikioriti work him dey do and he dey put beta food for him table.
He say our gofment won use suffer kill pipo as dem dey tiff all di money for dia big pocket and bank.
He finish Buhari,Obasanjo and our senators for ground for di video wey don enta evriwia.
Oya watch am for bottom hia...


Monday 5 February 2018

GOFNOR OKOROCHA DON BAN SMOKING AND SELLING OF IGBO FOR IMO STATE AND HE SAY BETA PUNISHMENT DEY WAIT ANYBODi WEY BREAK Di LAW


Gbana,marijuana,kpom or igbo,wicheva name dem dey call am,Gofnor Rochas Okorocha don yarn say anybody wey dem katch dey smoke am or dey sellam,go enta big wahala for di state.
Rochas yan dis one during di annual Nigerian army west Africa social ativitis program.
No be only igbo di gofnor ban o,he also say any drug wey strong and wey dey giv sirios highness,go expiriens dis ban too..
Akordin to Rochas he say,all dis highness of igbo and cocaine dey turn di youths dem to useless pipo and make dem dey komit crime.
Nice one gofnor but wich of di drugs dey make our gofnors and oda lidas dey tiff our money go hide for obodo oyibo?

Sunday 4 February 2018

ONE NAIJA GUY DON KILL TWO OTHER NAIJA GUYS 'NZECHUKWU AND CHIDI' FOR SOUTH AFRICA JUST BICOS HE NO HAPPY WIT DiA KARATA AFTA DEM DO BIZNESS TOGEDA


One naija bobo wey he name na Sunday don kill two naija guys for South Africa bicos dem run bizness togeda and e no favour ram.
Police dey find di guy wig torch and candle right now as him don run.
Di seketri of di Naija union for southi Mr Emeka Ezinteje naim yarn dis one.
Di name of di pipo wey him kill  na,Nzechukwu Alabuche 35 years and Ekweghiariri Chidi Isaac wey be 34 years old.
Akordin to Ezinteje he say dem don carry dia bodi put for mortuary and dem don also report di mata to South Africa police.

Saturday 3 February 2018

IME BISHOP alias OKON LAGOS DON TALK SAY,ONE TING WEY FIT MAKE AM CRY BUCKET FULL NA,IF HIM NO SEE FOOD CHOP


Funny man,comedian and nollywood actor,Bishop Ime a.k.a Okon Lagos don yarn tori pipo say,one ting wey him know say fit make am cry na,if you no givam food chop.
Food na life,we agree sir but Okon Lagos,Now wey ya wife don know ya weak point,be kiafu.
Nor make her vex any day if not,you go cry sotay Grammy go notice you.

Friday 2 February 2018

POLICEMAN DON SHOOT AND KILL ANODA POLICEMAN FOR ADAMAWA STATE BICOS OF N20 NAIRA OGOGORO CHANGE


Di day wey policeman go vex shoot fowl bicos di fowl no gritam go soon rish.
Bicos di way wey policemen take dey shoot shoot for wetin no rish to shoot dey sorprise me.
Only police pipo go shoot kondoktor bicos of N50,policeman go kill okadaman bicos of bribe.
Now for Adamawa state two policemen Emmanuel Timothy and Bala Adamu dey fight bicos of 20 naira ogogoro change for Madagali local gofment area for Adamawa state.
Adamu carry gun shoot Timothy die.
Wetin be 20 naira?
which kain nonsense be dis?

Thursday 1 February 2018

Di SON OF POPULAR MUSICIAN PERICOMA 'SPEED DARLINGTON' Di NAIJA AMERICANA SAY,HIM NO BE LIKE DAVIDO WEY USE HIM PAPA MONEY AND NAME TAKE BLOW


Bangdadadeng master Speed Darlington wey be di pikin of popular miuzishan Pericoma,don yab Davido.
He say him papa Pericoma wey die some years ago na veri popular miuzishan but yet him no use am take get short cut to enta di industri.
Speed Darlington di Naija Americana say, him hustle by imsef to rish wia him dey but pipo like Davido use him papa name and richness take rish dis level.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...