MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Thursday 30 November 2017

FOR LONDON,DAVIDO AND WIZKID DON MAKE US PROUD AGAIN AS DAVIDO WIN BEST AFRICA MUSICIAN AND WIZKID WIN Di BEST INTERNATIONAL MUSICIAN FOR 'MOBO AWARDS'


Davido and Wizkid don kontiniu to make naija proud even though say dem be cat and rat.
For di MOBO Awards wey appun for London yestaday,Davido win di best African artiste why Wizkid difit pipo like Drake,Jay Z and Cardi B to win di best International artiste.
We no say dis two guys don turn enimis but we need selibrate dem as dem don kontiniu to put dis kontri name for map.

Wednesday 29 November 2017

COMEDIAN AY,DON TELL GIRLS WEY DiA BRAIN EMPTi SAY DEM NEED BETA BRAIN TO SEE CORRECT HUSBAND,NO BE TO DEY PACK MAKE-UP FULL FACE


Comedian Ay don yab all those girls wey dey carry make-up full face from morning till night just to look fine.
He say,if dem no know book naim be say to see beta man marry na ploblem.
No amount of make-up and aso-ebi wey you buy fit give you hosband to marry.
Akordin to Ay,if your brain empti koret men go dey use and dump you.

Tuesday 28 November 2017

PRESIDENT BUHARI DON GIVE ORDER TO ALL GOVNORS,MAKE DEM MAKE SURE SAY DEM PAY WORKERS WEY DEM STILL OWE SALARIES BIFOR CHRISTMAS


E be like say dis krismas go swit o as Uncle Buhari don tell all Gofnors say make dem no owe any worker salary bifor krismas.
If e get salary wey dem neva pay,Buhari don tell dem say make dem pay bifor di krismas selibrayshon.
Nice one,only say di money nor go still rish dem use as price of food stuff and evritin don double since Buhari enta pawa.

Monday 27 November 2017

CHECK OUT NIGERIA NEW JERSEY WEY DEM GO WEAR FOR Di FIFA WORLD CUP,RUSSIA 2018


Just like as e dey appun bifor evri World Cup wey we dey go,Nike don reliz new jersey wey di Super Eagles of Nigeria go wear for Russia 2018.
Few pipo wey I talk to for street gree say,dis one fine skata and e plasta finish.
Me sef agree.
How u siam?

I BE BOXER BIFOR BUT I STOP AFTA ONE DELTA BOY USE BLOW SCATTER MY FACE LIKE SAY KATAPILLAR JAM ME - MR IBU


Funny actor John Okafor a.k.a Mr Ibu,don yarn tori pipo say,if no be di film industri wey snatcham,he for kontiniu him work as a boxer.
Akordin to Ibu,him stop boxing di day wey one Delta boy use blow draw map for him face.
He say dem go one boxing kompetishon for Delta but dem niali killam for ring.
Di nollywood actor say,wen he rish house and see him sef for mirror,naim he tell imsef say,boxing bye bye.
Mr Ibu say di guy na idiot and he niali blind one of him eye wit blow and e take am sometime bifor he start to see wit di eye again.

Sunday 26 November 2017

GOODLUCK JONATHAN DON TELL ATIKU ABUBAKAR SAY,IF HE WAN BE NAIJA PRESIDENT FROM PDP,FIRST OF ALL,HE MUST GO BEG OBASANJO


Goodluck Jonathan don advise Atiku Abubakar make he go apologize to Ogakpatakpata of Naija politiks Olusegun Obasanjo,if he won be president of Naija for 2019.
Atiku naim be Obasanjo assistant,Vice President and nomba two man wen he be president from 1999 to 2007 but two of dem later turn cat and rat bifor dem comot for Aso Rock.
Now forma president Goodluck don advise Atiku say,if he want make PDP choozam as dia nomba one man for 2019 election,he must go beg Obasanjo to forgivam onto say,Baba still dey vex foram.
Akordin to Goodluck Obasanjo stil get say for who go be president.
Na wa for our leaders o.
No be we go vote to choose who we want again to be president?
Na only Obasanjo?
Ok o,we dey watch.

IKEBE DANCE COMPETITION,ENUGU 2017 FOR PHYNO SHOW (VIDEO)


Duncan Mighty put Enugu girls ikebe for high jump during di Phyno Fest groove.
Wen di bobo come out to sing Na so he do Ikebe konpetishon for di girls to choose di Enugu best Ikebe,2017.
All kind of yansh naim do di groove.
Slim,fat,stone yansh,soft and even water water yansh come stage for di konpetishon.
Watch who win Enugu Ikebe,2017 for hia...


Saturday 25 November 2017

CONFAM! DAVIDO DEY BUY MOST OF HIS SONGS AS 'TENI' SAY NA SHE WRITE DAVIDO NEW SONG 'LIKE DAT'


For abroad na norma tin for pesin to write miuzik and hawk dey sell.
Pesin like Davido nor send anybodi message as he don bring yankee style enta naija on top say he dey always buy most of him hit tracks from writas hand.
We bin hear say na General Pype naim sell 'Gbagbe Oshi' for Davido and Peruzzi wet just join him gang naim write 'Fall and Fia' foram.
Now, one of di new star 'Teni' don tell tori pipo say na she write 'Like dat' for Davido.
Na Davido new miuzik wey just come out yestaday.
Nice one Teni,all na bizness.
Make I enta street go find song buy.

Friday 24 November 2017

AFTA NEWS ENTA TOWN SAY TIWA SAVAGE DON DEY PREGNANT AGAIN,SHE DON COME OUT SAY DAT ONE NA BIG LIE FROM AMEBOR PIPO


Mama Jamjam and Tee Billz wife Tiwa Savage, don deny di rumors wey dey evriwia say she don carry belle of her second pikin.
She say na lie say she no dey pregnant.
She say if Tee Billz giam water drink she go let evribodi know.
If you dey follow up,last week Tiwa say she no mind to carry belle for 2018.

Thursday 23 November 2017

AFTA APC GOVNORS SAY NA PRESIDENT BUHARI DEM GO VOTE FOR 2019 ELECTION, BOLA TINUBU DON TALK SAY DAT ONE NO GO WORK..2019 NA FOR ANYBODY NO BE ONLY BUHARI


National leader of APC Bola Ahmed Tinubu don yarn tori pipo say anybodi wey get dream to bikom president of Nigeria, get di right to come out for 2019.
APC gofnors for naija bin talk few weeks ago say na President Buhari dem won soport for 2019 again but Tinubu no agree wit dem.
Akordin to Tinubu,he say even Buhari biliv in democracy.
He biliv say evribodi get right to come out for 2019.
He yarn all dis one wen he carry waka go Ondo state for one joinbodi meeting wit di govnor of di state Mr Rotimi Akeredolu on top di Afenifere meeting.

Wednesday 22 November 2017

LAGOS STATE POLICE OGA,EDGAL IMOHIMI DON TALK SAY,DEM DEY LOOK FOR BURNA BOY TO ARREST AFTA ARM-ROBBERS CONFESS SAY,NAIM SEND DEM GO ROB MR 2KAY FOR EKO HOTEL


Lagos state komishona of police Edgal Imohimi don yarn tori pipo say,dem dey use torch and candle take look for Burna Boy afta arm-robbers confess say,na Burna Boy naim sendem go rob Mr 2Kay for Eko Hotel.
Mr 2Kay bin lodge for di hotel afta him pafom finish for 2face show and imidiateli he enta di hotel room,di boys enta beatam and also thief him audemais piquet(AP),automatic gold wristwatch of $25,000,gold of 1.5 million,phones,adidas shoe and even perfumes.
Dem don alreadi confess say na Burna Boy sendem.
If u dey follow up,some weeks ago,Burna Boy threaten to beat up pastor veri soon bicos of dia karata.
Mr 2Kay kon advice Burna Boy say e dey veri wrong foram to yarn like dat and bicos di bobo no like dat kain advice,he quick quick send 2Kay message say him go showam pepper.
Hmm,no be small mata.


Tuesday 21 November 2017

WIZKID AMERICA MANAGER JADA POLLOCK DON BORN BOY PIKIN FOR WIZKID AND DIS ONE NA WIZKID NUMBER 3 PIKIN FROM 3 DIFFERENT WOMEN


Jada Pollock,WizKid America Yankee manager, don born Wizkid third boy pikin.
Dis one na di nomba 3 pikin from three diferen women.
Wizkid no waste time as he don give di pikin name.
Zion Ayo Balogun naim be di name wey Wizkid carry give di pikin.

Monday 20 November 2017

FROM JANUARY 1ST 2018, BUS CONDUCTORS FOR LAGOS GO DEY WEAR UNIFORM ACCORDING TO Di OGA OF DiA ASSOCIATION..


If you dey read dis tori and ya broda or friend na conductor, telam say,The Bus Conductors Association of Nigeria don put law say,from January 1st 2017 wey be new year day,all bus conductors go dey wear uniform for Lagos.
Di President of di association Mr Israel Adeshola naim yarn tori pipo dis message on Sunday for Lagos.
Adeshola say why dem put dis kain law be say,dem want make di world know say,conductors nor be agbero and dem won make dem,profeshona conductors.
He also yarn say,dem go dey give conductors training now on how di job sopose be and also to train dem make dem get beta attitude and karata towards passengers.
Wia dis kain tin fit start if no be Lagos.
Lagos na wa.

FROM JANUARY 1ST 2018 (NEW YEAR DAY),BUS CONDUCTORS FOR LAGOS GO DEY WEAR UNIFORM ACCORDING TO Di OGA OF DiA ASSOCIATION..


If you dey read dis tori and ya broda or friend na conductor, telam say,The Bus Conductors Association of Nigeria don put law say,from January 1st 2017 wey be new year day,all bus conductors go dey wear uniform for Lagos.
Do President of di association Mr Israel Adeshola naim yarn tori pipo dis message on Sunday for Lagos.
Adeshola say why dem put dis kain law be say,dem want make di world know say,conductors nor be agbero and dem won make dem profeshona conductors.
He also yarn say,dem go dey give conductors training now on how di job sopose be and also to train dem make dem get beta attitude and karata towards passengers.

Sunday 19 November 2017

MANUSHI CHHLILAR FROM INDIA DON WIN Di 2017 MOST BEAUTIFUL GIRL COMPETITION FOR Di WORLD,AGBAANI DAREGO OF NIGERIA NAIM WINAM FOR 2001


Di most biutifu girl for Di world for 2017 na Munashi Chhilar from India.
She win Di award for Sanya city arena for china.
Over 108 kontris naim enta did konpetishon inkluding Nigeria.
Congratulabia.

Saturday 18 November 2017

BOLA TINUBU DON TALK SAY,Di SPEED WEY BILLIONS OF NAIRA TAKE GET 'K- LEG' DURING GOODLUCK JONATHAN GOVMENT,PASS Di SPEED WEY USAIN BOLT TAKE DEY RUN 100 METRES


We nor get say for di kontrol of Nigeria money but pipo wey know about Nigeria bank account don dey blast demsef on who be thief.
Di national leader of APC Bola Ahmed Tinubu don yarn tori pipo say,di speed wey billions of naira take get K-leg under Goodluck Jonathan govment,pass di speed wey Usain Bolt from Jamaica take dey run 100 metres.
He say di koropshon squad of forma Presido Goodluck,thief Naija account dry.
He yarn dis one on Thursday November 16,2017 wen dem givam microphone during di presentation of 'Making Steady,Sustainable Progressive for Nigeria's Peace and Prosperity'.
Dis meeting na about President Buhari two years report card on how him don pafom.
Goodluck Jonathan sef don kukuma vex tell Tinubu say he dey talk robish.

MR P OR RUDEBOY,WHO HAS CREATED THE BETTER SONGS SINCE THEY WENT SOLO?


It is no longer news that the P Square brothers have gone their separate ways and are now seen as rivals rather than duo. In a bid to outshine each other and claim the better artiste,they've churned out two songs apiece. Mr P with 'Cool it down and For my head' and Rudeboy with 'Nkenji Keke and Fire fire.' Who do you think has cooked the better hits?

BOLA TINUBU DON TALK SAY,Di SPEED WEY BILLIONS OF NAIRA TAKE GET 'K- LEG' DURING GOODLUCK JONATHAN GOVMENT,PASS Di SPEED WEY USAIN BOLT TAKE DEY RUN 100 METRES


We nor get say for di kontrol of Nigeria money but pipo wey know about Nigeria bank account don dey blast demsef on who be thief.
Di national leader of APC Bola Ahmed Tinubu don yarn tori pipo say,di speed wey billions of naira take get K-leg under Goodluck Jonathan govment,pass di speed wey Usain Bolt from Jamaica take dey run 100 metres.
He say di koropshon squad of forma Presido Goodluck,thief Naija account dry.
He yarn dis one on Thursday November 16,2017 wen dem givam microphone during di presentation of 'Making Steady,Sustainable Progressive for Nigeria's Peace and Prosperity'.
Dis meeting na about President Buhari two years report card on how him don pafom.
Goodluck Jonathan sef don kukuma vex tell Tinubu say he dey talk robish.

Friday 17 November 2017

Di FIGHT BITWIN WIZKID AND DAVIDO DON DEY SERIOUS EVERYDAY AS DEM FIGHT EACH YESTADAY FOR Di 'ONE MUSIC FEST' CONCERT FOR DUBAI


If we as Nigerians nor do somtin about dis Davido and Wizkid fight, we go wake up one day just find out say dem don kill demsef.
Imagine wetin we dey feel say na odnari social media fight don dey turn somtin else.
Di 'One Miuzik Fest' show wey dem do for Dubai last night turn war bitwin Davido and Wizkid camp.
Akordin to tori wey enta our tori room,we hear say dem even punch Wizkid for face but we neva confamam.
Dem say Davido and him gang naim start di fight bicos di organisers allow Wizkid climb stage first bifor Davido.
Can u imagine di robish!
Well, nor be dia fault,dem chop belleful.
Watch Di video hia...


Thursday 16 November 2017

SHATTA WALE GHANA MUSICIAN DON TALK SAY, HIM NO SEE WIZKID AS SUPERSTAR AND NOTHING SPECIAL ABOUT WIZKID MUSIC


Dem  say success get many frends.
Afta many pipo start to yab Wizkid Davido win MTV Europe Music Awards, Ghana dancehall miuzishan Shatta Wale, don yab Ghana pipo wey dey see Wizkid as dia supastar.
Shatta Wale say God forbid! him no dey look Wizkid as supastar bicos him miuzik dey veri dry.
Since he yarn dis one, many naija pipo Don curse am welwell say he dey yarn dust.
He don reliz two videos now still dey insult Wizkid but Wizkid neva still ansaram.
Shatta Wale even yarn say,Davido,Burna Boy and Dammy Krane no dey fake like Wizkid and him no dey like fake pipo.
Na wa o,dis fight wey dis guy start so, he go fit end am so?
Abi him dey try to dey popular?

Wednesday 15 November 2017

ARGENTINA FANS DON DEY CALL DiA COACH JORGE SAMPAOLI 'YEYE COACH' AFTA Di SUPER EAGLES OF NAIJA TAKE DEM DO YEYE AND WIN DEM 4-2 YESTADAY


Di 4-2 wey Nigeria Super Eagles win Argentina last night for di frendli match wey dem play don dey cause wahala for dia kontri alreadi.
Goals from Kelechi Iheanacho,Alex Nwobi and Brian Idowu make sure say we win di Albiceleste of Argentina 4 kondo to two.
Di koko for di mata now be say,dis disgrace don dey cause kasala for yonda as di fans don dey insult di team and dia coach.
Some don even dey say make di coach carry hin load,him bag and live di team alone make anoda pesin take ova.

Tuesday 14 November 2017

AFTA WIZKID CALL AM LOCAL MUSICIAN, DAVIDO DON BECOME Di FIRST NIGERIA PESIN TO WIN TWO INTERNATIONAL 'MTV EUROPE AWARDS' FOR ONE NIGHT


Afta he win two awards 'Best African Act and Worldwide Act' for di MTV Europe Music Awards,Davido fans don inkriz sotay dem dey  insult Wizkid on top twita, facebook and also instagram.
Dat same day for Lagos,Wizkid win three Awards for di Afrima awards wey many pipo dey call local awards.
Although Wizzy win dis two MTV awards last year but MTV kon later take Di best African act award and givam to Alikiba of Tanzania.
If u dey follow up, Wizkid bin call imsef intanashona boy and di same Wizkid yab Davido and call am local boy earli dis year. 
Now fans don turn against Wizkid and yabam onto say he call Davido local miuzishan and na di same Davido stil win two intanashona awards for one night.
Wizkid and David wey be good frends don turn enimis for some months now as both of dem dey claim naija nomba one champion. 
Evriday naim dia fans dey insult demsef on top intanet bicos of dis two boys wey don make naija  proud. 
My queshon right now be say, wen we go stop dis kain fight and selibrate dis two boys onto say dem don put our name for intashona miuzik map.  

Monday 13 November 2017

FORMA PRESIDO GOODLUCK JONATHAN DON TALK SAY,PIPO DEY BEGAM EVRiDAY TO COME BACK FOR 2019 ELECTION AND CONTEST TO BE PRESIDENT OF NIGERIA AGAIN


Goodluck Ebele Azikiwe Jonathan don yarn tori pipo say, pressure dey on am to kontest for di 2019 election to bikom president again but him no dey sure say e posibo since na di turn of Hausa pipo to provide pesin wey go come out for 2019 for PDP.
He say even Ekiti gofnor Ayo Fayose wey don announce say him won be president fit no sorsid since dia party don zone am to North.
He yarn all dis ones wen he sidon wit Dele Momodu for one joinbodi intaviu.
Akordin to uncle Jona he say anytime wey him comot and crowd dey shout say we want you back, na so cry go dey hungri am to cry.
2019 no far again we dey wait to see wetin go appun.

Sunday 12 November 2017

VERY FUNNY ACTOR AFEEZ OYETORO a. k. a 'SAKA', DON TELL TORi PIPO SAY, POVERTY TAKE HIM EYE SEE PEPPER AND DAT IS WHY HIM NO QUICK MARRY AND BORN SHIDREN


One of di funniest actor for naija, Afeez Oyetoro a. k. a 'Saka', don yarn tori pipo say poverty bin take am do yeyno be small and  dis one be di reason wey make am no quick marry and get shidren.
Akordin to Saka he say, he born him first pikin wen him be 41 years old.
He say he tell imsef say him no won born shidren wey go come life kon suffer.
Shidren wey him no go fit train and na dis one make am work hard get money bifor he marry.

Saturday 11 November 2017

GUITAR SPECIALIST AND JOROMI SINGA 'SIR VICTOR UWAIFO', DON TELL TORi PIPO SAY, SIMI AND JAYWON NO TAKE PAMiSHON FROM AM BIFOR DEM ENTA STUDIO GO SING AND REMIX 'JOROMI'


Di man wey sing 'if you see mamiwater neva neva you run away ',Sir Victor Uwaifo, don yarn tori pipo say, Simi and Jaywon no try at all base on say dem no letam know bifor dem sing dia own version of him song 'Joromi'wey reign skata for evriwia ova thirty somtin years ago.
Akordin to Uwaifo di guitar man, dis pipo be like shidren toram and him no tink of to carry dem go cour instead, him dey advice anybodi wey won sing anoda man song wey him don sing bifor to take pamishon from di pesin.
Simi and Jaywon need to tank dia God bicos,like say he carry dem go court to win di case for hard dem.
Di law yarn say, bifor you go use anoda man material or pasona propati, you suppose let dat pesin know or take exkiuz.

Friday 10 November 2017

HOUSE FOR SALE AS Di QUARREL BITWIN Di PSQUARE BRODAS DON WEAR SHORT SKIRT AS DEM DON DEY LOOK FOR BUYER FOR Di HOUSE WEY DEM BUILD TOGEDA


Na wa for wire road o.
If you neva hia di latest gist on top Di fight bitwin Psquare di twins and dia sinior broda Jude naim be say you dey di right place.
Dem don put up Square Ville for sale.
Square Ville na di name of di house wey Psquare joinbodi build togeda and na Omole estate for Ikeja di house dey.
Akordin to tori wey rish our tori room,di agent say na N300 million dem won sell di house and we hia say ova 7 pipo don readi to pay di money wey dem put as price.
Na wa o, dis dia new fight don dey dey too sirios o.

Wednesday 8 November 2017

JULIET IBRAHIM DON WARN HER NIGERIA BOY FRIEND ICEBERG SLIM SAY, IF HE EVER TRY TO BREAK HER HEART, GHANA PIPO GO DEAL WITAM



Ghana big name and supastar babe Juliet Ibrahim don warn her Nigeria boyfriend Iceberg Slim say,if he break her heart Ghana pipo go deal witam.
She yarn dis one on top Ghana radio station Joy 97.7 Fm.
Juliet wey don act for many Nollywood and Ghollywood film yarn say,her kontri pipo dey listen and if di bobo try any nonsense,Ghana pipo dey her back to deal wit Iceberg Slim.
Weda na joke na dat one we neva know.
It's watch di video for bottom hia...



Tuesday 7 November 2017

PHILADELPHIA COURT FOR AMERICA DON SENTENCE NICKI MINAJ FORMA BOYFRIEND MEEK MILL TO PRISON FOR 2 TO 4 YEARS AFTA HE REFUSE TO GIVE WAHALA CHANCE



Oga lawyer and judge Genece Brinkley for Philadelphia court for Yankee, don give Nicki Minaj forma boy frend Meek Mill 2 to 4 years to stay prison afta di bobo fail to respect imsef since 2009 wey dem dey watcham weda he go change.
Afta dem free am for di gun and drug gbege wey him enta,Brinkley say him don dey watcham but he refiuz to get sense so diafor, make he o relax for prison so dat him brain go re-arrange imsef.

Monday 6 November 2017

DAMMY KRANE DON YAB TEKNO MAKE HE STOP TO DEY 'BORROW POSE' WIT PIPO MOTOR AND TAKE PICTURE WITAM KON DEY CLAIM SAY NAIM BUY Di MOTOR DEM


Dammy Krane,di bobo wey just free from di ploblem wit America konpini afta dem say him do wayo for di payment of private jet wey him hire,don give Tekno ogbonge yabis again.
He say,Tekno dey do borrow pose wit pipo cars and him go dey claim say naim buy dem.
Dis two pipo just dey yab demsef anyhow for some weeks now.
Na only God know wetin dem dey drag.

Sunday 5 November 2017

ZAMBIA GOVMENT DON GIVE 48 HOURS QUIT NOTICE TO OMEGA FIRE MINISTRIES TO COMOT FOR DiA COUNTRY BICOS DEM NO WANT MAKE Di FIGHT BITWIN MEMBAS TO TURN SOMETHING ELSE


Zambia gofment don tell Augustine Oso Ebosele di pastor of di Nigeria church, Omega Fire Ministries for dia say, dem giam 24 hours to carry di church comot for dia kontri.
Di reason be say,dem no want make di oga oga fight among di church membas turn to somtin else. 
Di rent of di church Don expire but Kampamba Mulenga wey yarn on behalf of di Zambia gofment  say, dem no go allow dem pay again. 
Akordin to dem, dem say dem no want wahala.
Di owna of Omega Fire Ministries wey dia headquata dey Auchi for Nigeria na,Apostle Johnson Suleiman. 

Saturday 4 November 2017

ONE BIG FAN OF REEKADO BANKS DON BUY TEAR RUBBER N16 MILLION NAIRA C300 BENZ DASHAM


Anything wey u dey do for dis life just try do am well bicos you no know who dey trip for ya job. One biggelest fan of Don Jazzy boy Reekado Banks don shook hand for pocket remove N16 million take buy car dash di bobo.
Di car name Benz C300 and na tear rubber.
No be small tin.
I hope say di guy dey rememba to do good for him own famili pipo sha.

Friday 3 November 2017

Di FRENDSHIP BITWIN DON JAZZY, IYANYA AND MAVIN RECORDS DON DEY GET K-LEG AS NONE OF DEM JOIN IYANYA SELIBRATE HIM BIRTHDAY


Frends today, enimis tomorow.
Dat na how I see dis mata.
One year afta Iyanya waka live 'Made Men Miuzik' go join Don Jazzy for Mavin Records, e be like say dia frendship don turn k-leg.
Iyanya selibrate him 31 years birthday for October 30 for Crust and Cream, Victoria Island, Lagos but Don Jazzy and oda mavin membas no show face.
If evritin dey fine you no need anybody to tell you say, di birthday groove for dey loud espeshali if Don Jazzy dey involve.
Akordin to pipo wey dey close to dem, dem yarn say, somtin dey wrong wey dem neva tell us.

Thursday 2 November 2017

BIGGEST WOMAN SUPASTAR FOR WORLD MUSIC 'BEYONCE', DON JOINBODi WIT WIZKID FOR HER NEW SONG 'YONCE RIDDIM' WEY GO SOON COME OUT



Wizkid don confam him levels tire as intanshona miuzishan.
Few days afta Boxing Champion Anthony Joshua use Wizkid song take enta ring fight Takam, we don diskova say, Beyonce don ink Wizkid name for her new album  wey go come out veri soon.
Di name of di song wey Beyonce joinbodi do wit Wizkid na,Yonce Riddim.
Oda pipo wey Beyonce put for di album na Nicki Minaj, Rihanna and her hosband Jay Z.
Starboy Wizkid you don try.

Wednesday 1 November 2017

GUY MAN AND FILM ACTOR JIM IYKE, DON TALK SAY PROPHET TB JOSHUA PLAY AM WAYO AND DO FAKE DELIVERANCE WEN HE CARRY HIM SICK MAMA GO HIM CHURCH


Jim Iyke di nollywood actor, don call TB Joshua fake pastor afta he carry him sick mama go him church for Ikotun.
Akordin to Jim Ikye he say when he mama dey sick,dem carry her go TB Joshua church, Synagogue.
He say upon say him mama come synagogue for dilivrance, di mama still die.
Jim Iyke say wetin pain am pass na wen one of Tb Joshua wise men touch am, he bodi system just change.
For five minutes he nor get imsef.
Dis one weak me o.
Make we sidon dey look weda Tb Joshua go ansaram.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...