MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Sunday 31 January 2016

KANU NWANKWO AND THIERRY HENRY POSE TAKE OMIOMIORISTIC SELFIE

Arsenal big names dat year, Kanu Nwankwo and Thierry Henry,jam demsef ofresent and dem nor live each oda witout some pishor memories.
Dem jam demsef wen dem go watch Arsenal FA Cup match against Burnley.
Kanu join Arsenal from Inter Milan of Italy why Henry join from Monaco.
Na Kanu wife,Amara naim post di pishor of hersef,Kanu and Henry.
Kanu also postam ontop twita make e for nor loss.
Beta smile.
#Legends.



KING WIFE DON ENTA ONE CHANCE FOR UDUMUJE UGBOKO,ANIOCHA,DELTA STATE AS DEM DON DRIVE HER COMOT FOR PALACE BICOS OF KUKERE WAKA

Oba nor dey go transfa as dem talk am but Queen Okwukwe Nwoko,di wife of Obi Agbogidi Nwoko 111 of Idumuje Ugboko Kingdom,Aniocha north,Delta state,don get transfa to comot from di palace bicos of kukure waka.
Akordin to di mata wey dey ground,dem say she dey waka pionpionpion go find man.
Dem even akiuz her say,nor be di Obi givam belle of her three year old dota.
Well,I hope say nor be bikos di Obi na 90 years naim make her dey shook leg for outside?
Well I just dey ask sha.
Di main pesin wey dey giv di Queen headache na,di Obi son,Prince Nonso Nwoko bikos he nor won see di woman for di palace.
Nor be only di kukure waka be di problem o,dem say dem also catch her dey watch blue film for inside palace.
Wey dem gada all dis tins togeda, naim dem drive am from Obi Agbogidi Nwoko palace.

FACEBOOK OWNER,MARK ZUCKERBERG,DON BICOM DI NOMBA 6 RICHEST MAN FOR DI WORLD AND NOMBA 4 FOR AMERICA

Like play like play,di Facebook teknologi wey dis guy start for inside one tiny room dat year,don tornam to one of di richest human being for di world.
Mack Zuckerberg di owna of Facebook,don bicom di nomba 6 richest man for di world and nomba 4 richest man for America.
Afta bizness yestaday for di world,Mark Zuckerberg money shoot go $47.9 billion and di bobo na just 31 years.

Dis na pesin wey some of us sinior o!
Baba God who we offend?
If na to carry Jesus Christ cross give us we go carry am.
He don try to dey carry am for us all dis years.
Di only pipo wey rich pass Zuckerberg for di world right now na, Bill Gates,Amancio Ortega,Warren Buffet,Jeff Bezos and Carlos Slim Helu.
Congratulations my veri veri gud frend,Mark Zuckerberg.

Saturday 30 January 2016

FORMA SUPER FALCONS PLAYA CHICHI IGBO SAY GET DI KAIN IKEBE WEY FIT BREAK COCONUT

U nor fit tell weda dis babe na man or na babe trutru bicos of di way wey she dey behave.
Most futbol playas dey rezembo man bifor but e be like say since di forma Falcons of Nigeria playa Chichi Igbo vex,she just carry di mata of  'ova look like man ' for head like lakpalakpa.
She just reliz anoda pichor now and she dey show us her strong yansh and she say di strongness of her yansh fit brake coconut.
How dem take dey wake up bigin tink to dey do all dis kain tins sef?
Wetin konsign me sef.
My own na just to tell una wetin dey paa for evri kona.

SOME PIPO FOR ABA DON GADA ONE MAD WOMAN WEY DEY GIVE LUCKY NOMBAS TO PIPO WEY DEY PLAY FOOTBALL BET

Evriday u must wake up to jam one new mad tin for naija.
Today,na di news of pipo wey dey gada one mad woman for Aba and she dey give pipo lucky nombas wey Dem fit take win for all dis Nairabet,Bet9ja,Merribet and di rest betting kompinis games.

Well,bifor dem dey gadaram like dis,maybe she don alreadi giv koret winning nombas some pipo wey win witam.
Why dem no go gadaram wen e be say to win 5k,u go don loose like 500k.
Wondament kontiniu for dis world.

REEKADO BANKS DON GIDEM ONE STRONG SELFIE WITH HIM MAMA


Anytin u like u talk.
Reekado Banks nor send anybodi mesage as di bobo don enta hapi mood folow een mama snap one wicked selfie and shiaram on top Instagram.
Di talk of say he nor dizav di Headies award for di next rated,nor dey distobam as di bobo just dey use hapiness dey do am dey go jejeli.
Wetin konsign agbero wit ovaload.

Friday 29 January 2016

LEBANESE PIPO DON ARREST ONE BIG VULTURE AND DEM ACCUSE DI VULTURE SAY EEN NA SPY FOR ISRAEL GOVMENT


Anoda wondament don appun.
Dis time na for Lebanon were some Lebanese pipo don arrest one big vulture wey dey fly anyhow for dia zone.
Dem say di vulture na spy for one of dia enimi,Israel.
Israel and many of di Arab kontris nor dey agree.
Dem say dem even pack rings full di vulture bodi to take get signal of tins wey dey appun for Lebanon.

Lastlast,at di end of all di argument,dem kon find out say di bird nor be spy na bird wey dem dey train for all dis big farm for games.
Dem later reliz di vulture make e fly go meet een ownas.
True true na Israel di vulture for fly enta dia area wey nor too far from each oda but di vulture nor get anytin to do wit spying.

Thursday 28 January 2016

UCHE JOMBO DON CLEAR CHIOMA AKPOTA SAY MAKE SHE NOR ALLOW DEVIL USE AM

Wetin dey appun for dis kontri wey all dis celebriti won use beef and quarel take faint us?
Early dis morning,pipo wake up come jam nollywood star Chioma Akpota troway small mesage wey get meaning on top twita give Uche Jombo and some nollywood babes wey u dey see for inside dis pishor so.

E be like say her annoyance akordin to wetin we dey hear na bicos dem nor inklude her for one film wey dem shoot.
Dis one kon vex Chiomaa and she kon write for her twita page say,some sistas nor dey do like sistas so diafor,she won mind her bizness and maintain her lane.
Evribodi wey dey di pishor don see wetin she yarn and dem don dey reply her one by one.
Di direktor of di film,Blessing say Chioma don fail if na so she won take let di world know say somtin dey pain am.
Uche Jombo say wetin dey pain am wey make her nor fit call and she get her phone nomba.
Uche jombo also clear ram say make she nor allow Devil use am take do robish.

Read all wetin Uche,Blessing and di rest pipo wey dey di pishor yarnam for bottom hia:

Wednesday 27 January 2016

2FACE: BLACKFACE NOR SEE ME AS HIM FRIEND AGAIN AFTA HE SAY I THIEF HIM MUSIC


Last year 2face do one show 'Fortified' for Lagos to take celibrate een 40 years old birthday and een forma singing frends Blackface and Faze,paform for di groove.
We fil say all di small quarel wey dem get bifor,don pass there settle.
Just last week here,Blackface akiuz 2face on top twita of tiffin een song again.
Dis na di sekond time wey Blackface dey tell us say 2face don tiff een music.
Di first one akordin to Blackface na 'African Queen' why dis time around na 'Let somebody love you' and di bobo don dey threaten say een go jack 2baba go court.
Now 2face don shook mouth for di mata wen tori pipo,Channels,intaviuram.
He say him dey soprise about dis kain tori and wia e dey come from.
2baba say wen he first see di tori,een fil say sombodi don tiff Blackface twita account to dey write robish.
On dia frendship,2face say him nor get any bad belle againstBlackface but Blackface nor see am as him frend again afta all dis kasala.
2face kon yarn lastlast say no shakings,dem go settle di mata.

I SORRY FOR NIGERIA: CHECK OUT DI BIUTIFU ESTATE OF FORMA CHIEF OF ARMY STAFF,IHEJIRIKA


Chisos!
Wen Nigeria go eva beta?
Wen?
Nigeria lidas and rulas don dey tiff dis kontri dry for plenti plenti years now witout fear and pity.
I see di pikchors of di estate wey di forma Chief of Army Staff Azubuike Ihejirika build as him propati and I just dey shout since.
Di estate fine nor be small.
Dis na pesin wey gofment dey pack money give to take fight Boko Haram for Jonathan regime,now see wetin he use most of di money do.
Na now I don see say Buhari govment mean bizness for di fight against koropshon and di pipo wey tiff don enta dia blood,as EFCC don lock and seize di estate from di forma ogakpatakpata of sojas.
Join me look dis pishors for bottom hia and shout small.


IF YOU NOR MARRY TWO WIFES,YOU GO SPEND DI REST OF YOR LIFE FOR PRISON - ERITREA GOFMENT


E don appun.
If u be man and u come from dat small Africa kontri wey dem dey call Eritrea,gofment don say make u nor dull yorsef as u must marry two wives weda u like am or not.
Any attempt for u to marry only one wife,na prison u go spend di rest of your life wit hard labor.
Di Eritrea gofment say if your wife nor gree make u marry anoda wife,she don die be dat sofa make u repot di case.


Dem say na jail she go die put.
Dem yarn all dis one wen
All dis yarns come out for arabic language by di Grand Mufti.
Dem be di bigest pipo wey dey in charge of religion law for Eritrea.
Gofment say make di men nor fear say dem go pay for di marage serimonis and di hauses.
Akordin to gofment,dem say why dem dey do am na bicos dem dey short of men afta many of dem kpai during di civil war wit dia neighbbors,Ethiopia.
Na di Eritrea depatment of Religion Affairs put all dis law and who disobey di laws dey play wit fire.

FANS DON TELL DAVIDO MAKE HE SHUT UP HE MOUTH BICOS HE SAY HIM DEY MAKE TOO MUCH MONEY AND HE NOR SEND ANYBODI

Pipo don dey tire for di evriday boast of Davido about him riches as dem finisham for Instagram about wetin he yarn yestaday.
Afta Sony Bmg for Yankee sign am last week,e be like say Davido nor like wetin some pipo dey yarn about di deal and na dis one kon make di bobo yarn say, een dey make too much money so him nor get time to kon dey worry about di robish yarns wey dey come out from twita,facebook,instagram and di rest tori site.
Trust naija pipo,dem say how much him get?make he shut up!

Read wetin dem reply Davido for botom hia....


Tuesday 26 January 2016

HANDSOME BOMBOY: CHECK OUT DIS SOLIDSTAR PIKIN

Choi!
Dis one nor be say one tin one tin o.
Dis Solidstar baby fine nor be small.
Solidstar post di foto of him fine bobos wey don dey grow just now just now.
Di smallie enta nor be small.

I bin know say na papa dey gaid him dota make bois for nor dey trespass anyhow but di way wey I dey see dis one,na Solidstar go get buy cotlass dey chase babes wey go dey kon line up to cramp dis een boy.
Fine smallie,dem don die well.


AY SAY NA MERCY JOHNSON MAKE DEM NEVA SHOOT DI PART TWO OF 30 DAYS IN ATLANTA

Big name Ayo Makun a.k.a AY,don yarn us say di rizin why dat home vidio '30 days for Atlanta', neva get part 2 na bicos of Mercy Johnson wey stil dey rest afta she born baby nomba three.
Akordin to AY,di talented Mercy Johnson get veri impotant role to play for di kontinuashon of Akpos and  een crazy doings wey u don see for 30 days for Atlanta.
Ay also yarn say,all tins get hol' brake for pesin wey dey mataniti leave or any type leave as far as di pesin get strong role to play for inside di film.
He say dis kain patan dey appun for evriwia inkluding Hollywood.
He also yarn say,for Hollywood,pipo dey hol' brake rish two to three years sef and di world go undastand evri.
Oya Merci Johnson quik quik plasta yor mata make men enjoy part 2.

Monday 25 January 2016

WIZKID DON WELCOME ANODA BABY DIS TIME AROUND WIT GUINEA MODEL BABE

Yeekpa!
E be like say e don appun again o as one tori wey dey fly pass our backyard say one Guinea model don arange bounsing baby boy for Wizkid.
Di babe name dey escape me rite now but she dey bear 'Blue Diamond' for twita and Instagram.
Na she post di pichors of wen she don born di pikin and even let us know say di baby name na Ayodeji Ibrahim Balogun Junior di same names wey dem give Wizkid afta dem bornam.

But wait o!
Na Guinea be dis boys Mecca now?
Yestaday,na so Davido Guinea babe for Amerika,joinam to celibrate een new kontract wit Sony bmg for Yankee.
Like dog make we sidon dey look wetin Wizkid go yarn for di mata.

SENATOR SANI SHEHU DON DISTRIBUTE 100,000 RADIO GIVE MALLAMS FOR KADUNA



Dem say Hausa man and radio na like 5 and 6.
Dem be like bread and butta as notin fit seprate dem.
Na dis one make Senator Shehu Sani dey arange 100,000 transistor radio give him pipo for di seven local gofment wey een dey reprezent for Kaduna sentral.
Now dem fit listin to BBC Hausa and VOA Hausa Savis and plenti Hausa program and news for oda radio station.
.
Senator Shehu say na to raise awareness politikali and make dem always dey get infomate of wetin dey appun for both local and intanashonali.
He say him kom from di area wey e be say,radio na dia major source wey dem take dey get infomashon.
He also yarn say for plenti plenti years for north dem no dey use radio dey play as naim dem take dey edukate and infomate demsef and na dis one make him dey enta all di ikoro and inside di ghetto go distribute di radio give malams.

Sunday 24 January 2016

ONE GUY MAN DON PROMISE TO COMIT SUICIDE BICOS OF CHIDINMA IF SHE NOR GREE HANG OUT WITAM

Somebodi get tell dis mumu boy papa and mama bicos dia pikin don dey craze for Instagram.
I dey sospet say na marine spirit dey worri di bobo.
Aftaraw,na Tutu_marines he call imsef for Instagram.
Akordin to wetin dis bomboy post for Instagram,he say,he go comit suicide if Chidinma nor folowram comot one evening.
I wonda wetin he won do to miss kedike for evening.
Weda dem plant een placenta for Chidinma bodi wey make am won kill imsef I nor know.
We dey wait.

DANKO,ORITSEFEMI FORMA MANAGER SAY NAIM CARRY AM COMOT FROM AJEGUNLE AND HE GO SOON EXPOSE ALL HIM LIES

Na anoda beef be dis abi na wetin?
Oritsefemi forma manager Danko,don say apart from say een remove Oritsefemi from Ajegunle ghetto,naim also link di bobo to all di big names for di industri.
From D'banj to Davido to all oda big name wey he dey folow role now,Danko say all naim handwork.
He say naim also take am to een own bizness patnas wey dem take sign am wit plenti money.
He say naim carry Oritsefemi from Ajegunle go Ikeja,from Ikeja to Lekki but now di double wahala singa kon dey talk many lies against am.
Danko say een just dey wait for di rite time to adress all dis ishoos and him go also expose all di lies wey Oritsefemi don blow for di industri.
I hope say we nor go hia later say dat haus wey Oritsefemi say een buy for Lekki for N200million say na lie?
Ok o,we dey wait.

Saturday 23 January 2016

SEE DI ADVERT WEY CHICKEN REPUBLIC TAKE LAFF OLISA METUH,DIS KAIN TIN GOOD OR E BAD?

Bifor bifor talku talku oga of PDP,Olisa Metuh dey een own jejeje and Chicken Republic just dey find e trouble.
Metuh wey gofment force to go rest him muscle for inside prison,bin chop or try to chop di paper wey he write een statement put akordin to tori wey spread enta town.
And now Chicken Republic don use dat one take do advert and even putam on top twita.
For di advert dem say, why u dey chop paper and yor word instead make you chop dia food?
As if dat one nor rish,dem kon draw fowl wey carry food dey go diliva for Olisa Metuh for jail.
Dem even put EFCC logo make di tin for pepe anybodi wey di tin touch.
Me I dey veri sure say if dis man free from dis wahala,na court dem and Chicken Republic go find demsef.
Many PDP soportas and some oda pipo don dey para for twita for Chicken Republic on top di mata.
How u see am?
Wetin dem do gud abi e bad?


LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...