MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Tuesday 19 January 2016

NEW BEEF:BLACKFACE DON ACCUSE WIZKID OF STEALING HIM MUSIC FOR NEW VIDEO 'KILLAH'

O boy,wetin dey appun wey evribodi dey accuse Wizkid of song tiffing?
Some days ago Dammy Krane naim fest say Wizkid tiff im slang and song.
As if dat one nor rish,dem earli kill demsef for Club Quilox last week as Wizkid use bottle abi na glass take injure Dammy Krane mouth.
Now di latest pesin wey don accuse Wizkid of di same tin na forma plantation boys memba,Blackface.
He yarn dis one inside een new miuzik, Killah.
For inside Killah,he sing say, 'Wizkid try steal me melody,Di copycat nah get me energy,Mi burn dem me send dem to di cementery.'
Na wa o,
Dis mata don tie wrapa o.
We dey wait for Wizkid reply.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...