MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Monday 4 January 2016

YO MEHN! UNCLE DAVIDO AND WIZKID,MAKE UNA SHINE UNA EYES,I GO SOON TAKE OVA FROM UNA-BABY IVORY

Davido and Wizkid,make una go one side first,Tiwa Savage pikin,Ivory,won enta di stage.
Check out di smallie posing wit maikrophone and face cap wey een bend go one kona.
Guyyoyo.
Ivory papa Tee Billz,naim post di pishor and he dey tell Davido and Wizkid make dem readi for di baby take ova.
Na so e take dey start o.
Smallie abeg nor join illuminati o!
Make I also warn u,e get one tin wey most of dis miuzishans dey smoke wey make dem fit insult president say, "fukc you".
Nor be small fukc you Don Jazzy resiv on new year day,ask Olamide.
Some dey call dat tin sk,some dey call am high grade,some dey call am gbana.
If u won join yor mama and di rest of dem wen u grow,make u behave yorsef o.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...