MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Tuesday 19 January 2016

SENATE PRESIDENT,NATIONAL ASSEMBLY MEMBAS AND PATO RANKING DON MEET AND ENTA ONE JOIN BODI MEETING

Pato Ranking don carry one ogbonge waka enta Abuja go see some of di pipo wey dey rule una.
E nor dey hard to know at all if e don start to dey appun.
Pato don dey get beta Ranking smallsmall as e dey hot as di bobo don meet Senate President,Bukola Saraki and oda national assembli membas including Ben Bruce.

Saraki and Pato Ranking post on top twita about di meeting but wetin I neva stil undastand be say,wetin di meeting dey about apart from say dem discuss how to move di entatayment industri foward.
Imidiateli I get more infomashon about wetin Pato go kolet I go let una know.
Abi na nationa cake or na show kontract e go sign i go soon know wen I call een manager and di first set of pipo wey go hiaram na una wey dey read our tori from morning til nite.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...