MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Sunday 10 January 2016

WHY MOST MIUZISHANS DEY SMOKE IGBO AND DRINK HENNESSY - HARRYSONG

Gala ambassador and supastar singa,Harrysong,don yarn say even tho een nor dey drink and smoke,he undastand why most of dis oda miuzishans like highness.
He say some of dem dey veri shy and wen dem shack akohol or smoke ganja or take drugs,di ginga go just enta dia system from no wia wen dem enta stage.
He say een nor dey for all dose shack dis,smoke dat mata bicos im get natural ginga.
He go hard many pipo to biliv Mr song say he nor dey stain di system sometimes but me I know many pipo wey be say dem dey naturalli drunk witout akohol.
Na just God's blessing.
Di Reggae Blues singa say,he nor dey smoke and drink bifor he climb stage as he don alreadi get Baba God inspiration full bodi and dat one richam.
Harrysong say drug dey kill smallsmall as he nor dey allow artiste use dia talent well.
He say di excuse of say na shyness to face crowd naim make dem dey take drugs na propa robish.
He say wen God give u talent,di same God go giv u di power to witstand di chalenge wey di talent dey bring.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...