MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Tuesday 12 January 2016

GENEVIEVE NNAJI DON TIRE FOR FILM TRICK AS SHE DEY READY TO MARRY ALHAJI BAKO VERI VERI SOON

Di rumor wey dey waka pass my ear now now be say,36 year old Genevieve don see her switi pie in di pesin of 29 years old Alhaji Ishaya Bako.
Ishaya Bako na film maker why Genevieve na film actor and e be like say two of dem don tire for film trick as dem go soon settle down akordin to tatafo pipo.
Dis two pipo meet as Genevieve relo kate go Abuja from Lagos two years ago.
Two of dem don do plenti work togeda and di latest one wey dem do togeda na Genevieve new film,"Road to Yestaday".

No be today Genevieve di motha of one don dey be frend to celebritis.
Di main one wey pipo see her wit dat year na di koko masta,D'banj as dem later knock as dia dem dia bodi language nor fit spik di same language.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...