MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Saturday 23 January 2016

MR IBU DON TELL NOLLYWOOD PIPO SAY,ANYBODI WEY CHOP FOR INSIDE DI PLENTI MONEY WEY GOODLUCK JONATHAN GIVE DEM,GO DIE

Mr Ibu
Nor be news again say many pipo benefit from di forma gofment of Goodluck Ebele Jonathan.
Di entatayment industri benefit welwell like agric fowl wey dem give fatalizer chop.
Many celibritis bank account fat wella bifor last year election espeshali di account of nollywood stars.
Mr Ibu don dey swear for pipo wey Uncle Jona put di money for dia hand wey nor gree investam inside di nollywood industri espeshali dat dia join bodi asosiation,Actors Guild Of Nigeria (AGN).
Mr Ibu say all of dem go kpeme bicos dem nor know how many souls don die bicos of di money wey dem cramp for dia pasona gain.
Nor be lie Mr Ibu yarn sha bicos e get some nollywood actors wey don die bicos di joinbodi lidas nor gree put money for ground to take asist dis pipo during di piroid wey dem dey sick.
Mr Ibu,if anybodi die by mistake for dis una industri,Nigeria police fit go arrest you o.
Make anybodi nor die o,make dem just vomit di money.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...