MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Friday 1 January 2016

BUHARI YOU NOR GET RIGHT TO STOP US NOT TO BUY N4.7bn CARS-SARAKI AND HIM BOYS

Buhari don tell di National Assembly say e dey veri bad say dem dey collect transport allowance and dem stil dey say dem won buy cars of N4.7bn for 109 National Assembly membas.
He say na robish spending.
Buhari say if een fit turn down 400 million naira wey dem won take buy cars for presidency,him xpect dis pipo to use dia church mind and say no to dat plenti money wasting too.
He say een pray make dem neva buy di cars alreadi bicos he get to hold meeting wit dem.
But dis pipo don tell Buhari now say he nor get one singo right to stop dem from spending dat money for di cars since di constitution allow dem to do wetin dey law.
Dem say Buhari sef sopose mind him bizness make dey demsef mind dia own.
Dem get luck say nor be 1983,sojas for use kokoko draw map for dia yansh for dat National Assembly.
I don see say dis pipo nor go allow Buhari rule dis kontri well.
I don also see say we nor get lidas as na chisballs full dia brain.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...