MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Friday 1 January 2016

BUHARI YARNS OF,''I BELONG TO EVRIBODI AND I BELONG TO NOBODI" DON WIN BBC AFRICA QUOTE OF 2015

On di day wey dem dey swear president Buhari enta sit,he yarn one kain tin wey make evribodi feel say, ha,e be like say dis one nor send anybodi papa message.
Buhari yarn say, "He belong to evribodi,he nor belong to nobodi and dat yarn don win BBC Africa yarn of di year out of all of dem wey dem chuz from.
Inshot,anoda Buhari yarns naim stil carry second and dat one na,"To bring about change,we must first of all change oursef and be dat pipo wey dey obey law".
Oda pipo wey dia yarns make di top 16 Africa yarns and quote na,South Africa Zulu King,Goodwill Zwelithini,Ghana presido John Mahama,Zimbabwe presido Robert Mugabe,Football star,Emmanuel Adebayor and many odas.
No be to win quote of di year o,na to rule well make you no go be like Uncle Jona wey win di most insulted president eva for Facebook wen he go inkriz fuel price from N65 to N97 all in di name of subsidy.
Yor advisa dem beta advise u bicos nowadays shidren dem get bad mouth pass 'I go die'.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...