MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Monday 11 January 2016

BETA CHANGE DEY COME AS FG DEY PLAN TO REPLACE 'STATE OF ORIGIN' WITH 'STATE OF RESIDENCE' FOR NIGERIA

E get aplicashon form wey u go dey fill,wen u rish wia to fill state of origin,yor heart go just dey cut bicos some kind job opotuniti fit pass u.
Pipo wey advatise di job fit giv pesin wey dem dey spik di same language or pesin wey fill dat state,as wia he come from.
Even for admision for school,state of origin mata dey make many pipo nor gain admision to di school wey dem chuz.
Vice presido,Yemi Osinbajo don say all dat one go soon change.
Okay make we dey wait for di change o.
Inshot,he say Federa Gofment go soon kanso, 'which state u come from' and replace am wit 'wich state u dey stay'.
Now to work for anywia as far as u dey stay dia go easy small even tho nor be dat state u come from.
Make we dey look weda dis mata go improve.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...