MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Friday 22 January 2016

SHUU! ANODA BEEF AGAIN! LOLO 1 OF WAZOBIA FM DON YARN COMEDIAN PRINCESS MAKE SHE STOP TO FOOL HERSEF FOR STAGE

Princess and Lolo

LOLO
2016 don dey turn di year of beef and kpomo for naija celibritis.
Dats y dem say who eva dey top make he lead well so dat di rest pipo go see beta tin wey dem go copy.
Now see di kain yeye seed wey Olamide and Don Jazzy fight don make dey jaminate.
Evri week,one beef must come out and di latest wey I don dey notice na bitwin Lolo 1 of Wazobia fm and xpirience comedian,Princess.
Lolo don say make Princess dey respect hersef dey comot for stage wen nobodi dey laff to her jokes.
She yarn dis one on top Instagram.
Lolo say make Princess stop to embarrass dem.
She say wetin Princess dey do nowadays nor be comedy again bicos afta pipo don go finish she go stil dey dia dey fool hersef for stage.
Chai! I no say Princess don dey prepia wetin she go replai Lolo.
Make I sidon for fence dey watch.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...